MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 20 January 2016

ICE PRINCE SHUT UP! NA AKIN BUY YOUR GIRLFRIEND HER FIRST CAR AKORDIN TO LILYSANGEL1




Omo see gobe!
Wen we fil say we don hia di last tin konsigning Ice Prince,him and he geh frend,Maima and di married man Akin, di mata don take anoda twist.
Akin leak sonkain sikrit of how he take frend Maima some days ago but Ice Prince defend di babe say she dey inosent for di mata.
Bob, make I yarn u di Koko.
E be like say nobodi fit guess how e go end as one babe wey her name na Lilysangel1 for twita,don give Ice Prince kila punch say make di bobo kpror for were een kack.
Lilyangel say Akin naim veri gud frend and naim buy Maima her first car and if Maima tell Ice Prince wetin dey,dawon nor go make dia frendship crash.
See all wetin she yarn for bottom hia:





No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...