MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 8 January 2016

KOREDE BELLO LECTURER DON THREATEN TO RESIGN IF DEM ALLOW KOREDE WRITE EXAMS


O boy ye!
Mata don tie wrapa o.
One of Korede Bello lechora for Nigeria Institute of Journalism(NIJ), don thretin to resign if dem allow di bobo write een exams since he nor meet di 70% class atending.
To kwolifai to write di exam,u must dey enta class rish one level but Korede na veri busy pesin since God win for him life.
Afta Korede matriculation,di bobo busy pass dose busybodi gehs for Obalende.
Today na Calabar,tomorow na Gwagwalada,di next day na Kafanchan.
Na so di boy dey go play shows for evriwia since he blow.
Who know dat lechora make he warn am sha.
Dis Buhari regime weather harsh o.
Di so call change,pipo stil dey wait foram o.
Tins neva stil set.lf he go smart resign,hunga go finisham for ground.
If di money stop to come afta he resign,di wife fit showam pepper.
If he nor get luck say na all dose kain jaguda wife wey dey chop bottle,naim be say he don enta one chance be dat.
I don yarn my own.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...