MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 22 January 2016

I GET QUERY FROM MY PASTOR AFTA I KISS FLAVOUR - CHIDINMA


Miss kedike,Chidinma don yarn say she get queri from her pastor afta she and Flavour Nabania dey kiss anyhow for di vidio of di song wey two of dem do.
Inshot,many pipo carry tori say,e be like say two of dem dey do touchingbodi bicos of di way wey dem dey kiss like say dem don dey do am since.
Altho Chidinma nor tell us weda dem sospendam for church or not but she hersef nor know say Flavour na craze for all dose kain tins?
Flavour?
Na who nor know Flavour go allow een fine sista dey play around am.
Flavour nor dey use eye see babe wey get fine smile.
Ask Sandra Okagbue and Anna Banner.
Wetin end dia own na two pikin wey dis two gehs born for di highlife singa.
Chidinma,di ball dey yor court,na u know wetin u won do witam.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...