MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 30 June 2018

Di PRESIDENT OF FRANCE EMMANUEL MACRON,GO VISIT FELA SHRINE FOR IKEJA NEXT WEEK TUESDAY


Fela,di king of Afro beat wey die August 1997 go hapi for anywia he dey as di President of France Emmanuel Macron go visit Fela Shrine next week Tuesday.
Di man go first land for Abuja to meet wit President Buhari and  dat same evening, he go enta Di New Africa Shrine Lagos and Trace TV go dey on ground to welkom am.
Afta dat one,him and govnor Akinwunmi Ambode go see and he go also open di new Alliance Francaise Facility for Eko.
Tori wey we also hear be say,Femi Kuti wey kontiniu di miuzik mata for wia him papa stop,go sidon gidigba dey wait to welkom di France President for Shrine.

Friday 29 June 2018

SUPER EAGLES STRIKER IGHALO DON TELL PIPO WEY WON KILAM BICOS HE NO FIT SCORE AGAINST ARGENTINA SAY,MAKE DEM REMEMBER SAY,HIM NA SOMEBODi PiKiN TOO


Sometimes if pesin yansh too big,e fit affect movement but I know won biliv say na bicos Super Eagles player Odion Ighalo yansh too big naim make am no fit score goal for us against Argentina.
Anyway,na wetin some pipo dey talk be dat sha.
Ighalo afta di match don apologise to Nigerians say make dem no vex say him fall our hand for di world cup match.
He say na football and na so e dey be sometimes.
He kon also use opotuniti beg pipo wey dey threaten him and he famili say,make dem calm down and remember say him na sombodi pikin too.

Thursday 28 June 2018

MICHAEL JACKSON PAPA 'JOE JACKSON', DON DIE AT THE AGE OF 89



Joe Jackson, di papa of di king of pop miuzik Michael Jackson,don die at di age of 89.
He don dey sick for sometime now bifor he die and naim be him shidren manager wen he dey alive.
He die two days afta di nomba 9 anivasri of di death of Michael Jackson imsef wey die for June 25,2009 at di age of 50.

Tuesday 26 June 2018

WIT OVER 87 MILLION POOR PEOPLE, NIGERIA DON OVERTAKE INDIA AS COUNTRY WEY POOR PEOPLE FULL PASS FOR Di WORLD


If 87 million pipo naim poor for naija, naim be say na evribodi niali poor finish.
Akordin to di new report of di Brookings institution,data of di World poverty clock,e show say 87 million Nigerians dey poor.
Wit dis one, we don ovatake India as kontri wey get di highest number of poor pipo for di world.

Monday 25 June 2018

R. I. P: SAD DAY FOR NIGERIA ENTERTAINMENT AS D'BANJ PIKIN 'DANIEL D' THIRD' DIE YESTADAY FOR SWIMMING POOL


Dis na one tori wey weak evribodi for di entatainment industri as one of di biggest name for di game D'bgun, lost him one year old pikin 'Daniel D'third' yestaday.
Akordin to di tori, dem say di pikin die for swimming pool.
Daniel just selibrate him one year birthday last month.
Dis news be like joke,too bad!
Make God give di famili Di kankpe heart and strong heart to bear dis painful  loss.

Sunday 24 June 2018

YORUBA SINGA, 'SMALL DOCTOR' DON YARN SAY, ALL Di RUMORS SAY HIM COLLECT N2 MILLION WEN HIM VISIT BUHARI FOR ASO ROCK, NA FAT LIE!


Small Doctor,,di bobo wey sing 'otigba penalty wó throwing' don yarn say, all di talk of say dem dash dem N2 million each afta dem visit President Buhari for Aso Rock, na fat lie.
Small Doctor togeda wit Sound Sultan, Actor Kunle Afolayan and big broda naija housemate Tobi, bin visit Buhari some weeks ago and forma direktor on New Media for PDP talk say no 2million each dem collect for di waka.
Small Doctor don come out to yarn say him no see dat kain money for eye and among di rest pipo, nobody telam say dem give dem money.
Small Doctor no shout again we don hear you.
Even though dem give you nobodi dey follow una drag.

Saturday 23 June 2018

CHELSEA LEGEND 'DIDIER DROGBA' DON PRAISE SUPER EAGLES AHMED MUSA GOALS AGAINST ICELAND FOR Di WORLD CUP AND HE SAY Di WAY MUSA TAKE CONTROL Di FIRST GOAL NA FIRE!


Chelsea legend Didier Drogba wey di world  know for him wondaful ball control wen he won score goals, don praise Super  Eagles Ahmed Musa ball control for di first goal wey he score against Iceland yestaday.
Musa naim score di two goals wey Nigeria take win dem yestaday for di world cup match wey dem play. 
Drogba praise Musa during di joinbodi sidon wey he follow BBC sport pipo dey do as e take concern di 2018 FIFA world cup for Russia. 

Friday 22 June 2018

PATO RANKING SAY WETIN DEY HAPPEN WIT NAIJA GOVMENT SEF? BICOS FOR 28 YEARS NOW, Di KAiN TALK WEY HIM DEY HEAR NA SO SO "UNA GET LIGHT? NEPA JUST TAKE LIGHT''


Singa Pato Ranking don call federa gofment out base on di suffer wey pipo don dey suffer unda NEPA since dem born am 28 years ago.
On top twita, no be small para di bobo para for gofment as he say wetin him always dey hear pipo yarn na 'Una get light? NEPA just take light'.
Naija mata don tire evribodi.
God no go let us wake up kon hear say dem don sell dis kontri one day.

Thursday 21 June 2018

ONE COURT FOR SOUTH KOREA DON PUT LAW SAY,FROM NOW ON NA CRIME TO KILL DOG CHOP FOR DiA KONTRi


For many kontris inkluding naija, dog meat na spesha meat as dem say di ting too swit.
But for South Korea now, if you kill dog bicos you one chopam,di law go see you as krimina.
Na court for Korea naim put di law.
Many Pipo nor go hapi wit dis  law but anyhow di mata later end, we go let una know.

Wednesday 20 June 2018

FOR Di FIRST TIME FOR NAIJA HISTORY, GOFMENT DON TALK SAY DEM WON SHARE Di $322 MILLION DOLLARS WEY ABACHA THIEF GIVE NAIJA PIPO



You still dey sleep?
Wake up as tori wey we don gada be say, dem won share Di $322 millions wey Forma Khaki Presido Sani Abacha tiff hide for Switzerland.
Di National Coordinator of di open govment patnaship and spesha assistant to do president on  justice reforms,Juliet Ibekaku-Nwagwu,naim yarn dis one during di joinbodi meeting wit tori pipo.
Nice one.
Make una no change am o.

Tuesday 19 June 2018

MARADONA DON WARN MESSI AND Di REST ARGENTINA PLAYERS SAY,MAKE DEM NO JUST BOTHER TO COME BACK TO ARGENTINA IF NIGERIA WIN DEM


Football and Argentina legend Diego Maradona don tell Argentina players wey dey play for dis year World Cup say, if Nigeria win dem, make dem kuku find anoda kontri run go hide.
Maradona say Argentina pipo go vex for dem tire if dem fall dia hand so make dem try win dia remaining match against Croatia and Nigeria.
For dia first match, dem draw 1-1 wit Iceland  for group D.

Monday 18 June 2018

FORMA FIVE STAR RECORDS SINGA 'SKiiBii' DON YARN SAY, HIM DEY SUFFER BETA SUFFER DAT TIME WEN HE DEY WIT E-MONEY AND KCEE


Skiibii, dat bobo wey many pipo say he fake him own death over three years ago, don yarn say him no dey enjoy as many pipo dey think dat  time wen he dey wit E-money and Kcee unda five star records.
Di bobo say him be broke wen he dey wit dem.
Akordin to Skiibii he say, now wey him don live dem, him fit dey pay money shoot him own miuzik videos now.

Sunday 17 June 2018

AKORDIN TO TORi WEY WE DON GADA,NOLLYWOOD ACTOR 'MIKE EZURUONYE' AND HIM WIFE GO SOON SEPERATE BICOS Di WIFE BORN ALBINO


If you dey follow up for nollywood films wewell, you soppose know Mike Ozuruonye one of di popular face for di industri.
Di tori wey we dey hear right now from him kona be say, gbege dey bitwin him and he wife.
Di wife last pikin na albino and right now di ting don dey make Mike vex bicos he say dem no get albino for him family.
Mike akordin to di tori want make him wife do DNA test to know weda naim rili givam belle but di wife no gree and dis mata go likely make dem break up.
Di wife base for Ontario,Canada.

Saturday 16 June 2018

Di GOVMENT OF EGYPT DON INKRiZ FUEL PRICE SO DAT DEM GO FIT GADA MONEY TAKE RE-ARRANGE DiA KONTRi AGAIN


Egypt di kontri wey Pharaoh for burss out, Don inkriz dia fuel price so dat make DEM fit gada money to repair di kontri again bicos tings roff for dem right now.
Di gofment naim announce dis one afta austeriti start to do dem strong ting for yonda.

Friday 15 June 2018

KOLA ABIOLA WEY BE Di FIRST SON OF M. K. O ABIOLA DON TALK SAY, BUHARI DON DO WETIN JONATHAN NO FIT DO AFTA HE BEGAM THREE TIMES TO GIVE HIM PAPA Di GCFR AWARD


To Kola Abiola, Goodluck Jonathan fall him hand welwell afta he begam tire to honor him papa wit di GCFR awarld.
He say him beg Uncle Jona three times to honor him papa but di man no gree.
But last week President Buhari naim kon use him church mind give Abiola di highest award for naija.
Him papa M. K. O Abiola naim win di June 12,1993 election wey  Babangida cancel but Abacha arrestam and he later die for prison for July 7,1998.

Thursday 14 June 2018

AS THE 2018 FIFA WORLD CUP DEY START TODAY FOR RUSSIA, DEM DON PENCIL 'WIZKID' NAME DOWN AS OF ONE Di STARS WEY GO SING FOR Di OPENING SERiMONi DiS EVENING


Ayo Balogun a.k.a Wizkid don add anoda feather join him name as dem don choose am to sing for today opening serimoni of di 2018 FIFA World Cup wey go start dis evening for Russia.
He go sing togeda wit Nicky Jam featuring Will Smith and Era Istrefi.
Di Grace too plenti.
Na only God fit do am.

Wednesday 13 June 2018

SUPER EAGLES PLAYER WILFRED NDIDI TALK SAY,BIFOR HE MAKE AM,HE HAWK GROUNDNUT, PURE WATER,TOMATOES AND HE ALSO WASH MOTOR WINDSCREEN FOR LAGOS TRAFFIC


E no get anybodi wey no know say,nor be evribodi dem born wit silver spoon.
Super Eagles midfida and Leicester city player Wilfred Ndidi don yarn tori pipo say,him hawk groundnut tire,him hawk tomatoes and pepper for him mama just to fit sorvive.
No be only dat one o.
He say him also wipe windscreen for Lagos traffic just to get some biskit money.
Ndidi also yarn tori pipo say di biggest money wey him make for a day dat time na 3k but today by God Grace tins don change.
Watch di video for bottom hia...


Tuesday 12 June 2018

RAPPER 'PHYNO', DON YARN TORi PIPO SAY, HIM LOVE BEAUTIFUL GIRLS WEY GET SENSE TOO AND HE HATE GIRLS WEY DiA MOUTH SHARP LIKE RAZOR BLADE


Strong naija rapper Phyno,don yarn tori pipo say,him no fit follow woman wey her mouth sharp pass razor blade.
He say him no dey like to be friends wit those kain pipo.
Phyno kon also yarn say, him no dey use biutiful gehs play but sha, di biutiful gehs wey himlike must dey intelligent wit plenti sense.

Monday 11 June 2018

THIS DAMMY KRANE T-SHIRT GOT ME THINKING


After the credit card incidence involving the 'My Dear' crooner Dammy Krane, he is captured here rocking a fitted T-shirt with a thought provoking inscription 'Fraud Alert' that might be aimed at dissuading people from indulging themselves in the act as posted on his instagram page.

NOLLYWOOD DIVA 'DAKORE EGBUSON AKANDE' DON YARN TORi PIPO SAY, Di REASON WHY SHE CARRY DADA FOR HEAD FOR 13 YEARS NA BICOS OF Di LOVE WEY SHE GET FOR BOB MARLEY DADA


If you rili follow up nollywood film bifor bifor, you sopose notice one babe wey carry dada for head when nobody even dey do dat kain hairstyle.
Her name na Dakore Egbuson Akande.
She say na Bob Marley own dada give her di inspiration to train and carry dada for head for good 13 years.
Anytime she see Bob Marley hair bodi dey swit her.
She she pipo even dey feel say she be ogbanje and she get kolo for head bicos of di dada.

Sunday 10 June 2018

AFTA SHATTA WALE OF GHANA BIN BOAST LAST YEAR SAY,HIM GO DO WIZKID STRONG TING IF HE COME GHANA AGAIN,TWO OF DEM DON FINALLY SETTLE DiA QUARREL FOR STAGE



Shatta Wale of Ghana and Nigeria Wizkid don settle dia quarel for stage during di Naija meet Ghana concert for Accra yestaday.
Wen Wizkid dey sing he say,as Africans we must win togeda no need to dey fight oursef bicos he no make sense.
I no go dey soprise wen dis two bobo do colabo veri soon.

Saturday 9 June 2018

SUPASTAR 'TEKNO' DON TALK SAY, HIM NO GO SCHOOL BUT HIM DEY MAKE MILLIONS AND E DEY VERY SAD SAY MANY PIPO WEY GO SCHOOL NO GET MONEY


Tekno, one of di bobo wey he miuzik dey skata differen area too just like Wizkid and Davido don yarn say,him no go school but him don make millions.
He yarn dis one for di new video wey him relz.
He also yarn say, many graduates full evriwia and dem dey broke.
He say dat kain ting no good and him dey pray say di change wey we dey talk about evriday for dis kontri go also rish di dormot of dis graduates.
Watch di video for bottom hia..


Friday 8 June 2018

FIFA DON REMOVE Di NAME OF KENYA REFEREE 'ADEN MARWA' FROM Di WORLD CUP WEY DEY START NEXT WEEK BICOS DEM CATCHAM WEN HE TAKE N210,000 BRIBE


Aden Marwa wey be one of di referee linesman wey sopose work for di FIFA World Cup wey dey start for Russia next week,don use him own hand put him sef for wahala afta dem video am dey collect N210,000($600) bribe bifor one match wey him for referee.
Him don use him church mind resign from di World Cup work as FIFA sef don telam to find him level.

Thursday 7 June 2018

PRESIDENT BUHARI ON BEHALF OF Di FEDERAL GOVMENT DON DECLARE JUNE 12 AS DEMOCRACY DAY TO HONOUR MKO ABIOLA WEY MANY PIPO SEE AS PESiN WEY DIE FOR DEMOCRACY


Di late M. K. O Abiola wey di world see as winna of di June 12 president elections for 1993,don finalli get di honor wey he dizav afta President Buhari declare June as democracy day.
Forma khaki leader Ibrahim Babangida naim be kanso di election for 1993 and Abacha kon arrest Abiola join bicos he start to call imsef president.
Abiola later die for prison but now Buhari say afta some kain meeting wit top pipo for di kontri, him decide to honor Abiola wit Di June 12 public holiday.
He also honor ram wit di highest award for di kontri GCFR.
Also,dem give him running mate and assistant dat year, Babagana Kingibe Di GCON Award.
Dem also give Gani Fawehinmi di GCON Award to take rekognaiz him fight for democracy and beta gofment.

Tuesday 5 June 2018

KANU NWANKWO DON YARN TORi PIPO SAY,LOCAL POLICE FOR RUSSIA DON RETURN HIM 4 MILLION WEY DEM BE THIEF WEN HIM LAND FOR DIA AIRPORT TO ATTEND DI WORLD CUP


Jangolikos bin tiff Super Eagles forma captain Kanu Nwankwo money for Russia airport afta he land to attend di World Cup yestaday.
We wake today to find out say dem don return di money $11,000 dollars wey be N4 million naira.
Akordin to Kanu he say di local police for di airport don see di money and dem don return am.

Monday 4 June 2018

CRISTIANO RONALDO DON HIRE ANIMAL AND BULL FIGHTER NUNO MARECOS AS HIM BODY GUARD FOR RUSSIA 2018 FIFA WORLD CUP WEY GO START IN TEN DAYS TIME



Portugal Captain Cristiano Ronaldo nor won hia any stori say dem take am unaware for di 2018 FIFA World Cup wey go soon start for Russia.
Di Real Madrid supastar don hire animal and bull fighta Nuno Marecos to be him body guard thru out di piriod wey dem go play di World Cup.
Some weeks ago,ISIS di Islamic terrorist gang threaten say dem go kill Ronaldo and Messi during di World Cup.
Dis one go dey among one of di reason wey make Ronaldo hire dis guy.

Sunday 3 June 2018

SINGA 'DAMMY KRANE' DON YARN TORi PIPO SAY, DAT TIME WEY HIM DEY WORK WIT 2FACE RECORD COMPANY AND OTHERS, NA ONLY AM BIN DEY PAY FOR HIM VIDEOS AND ALSO SPONSOR IMSEF


Singa Dammy Krane Don yarn tori pipo some sikrits as he take concern am espeshali dat time went him still dey unda record company. 
From di way wey di yarns go, e be like say na wen him dey wit Hypertek records, Di company of 2face all dis tings appun. 
He say all those times,na only him dey spend money shoot him videos. 
He also yarn say, him buy him first Benz car at 16 years, buy some big propati went him be 17 years old. 
Dammy most popular song dat year name 'My dear'. 

Friday 1 June 2018

SAUCE KID' THE NIGERIAN RAPPER WEY DEM JUST RELEASE FROM AMERICA PRISON DON YARN SAY,HIM WRITE OVER 300 SONGS FOR INSIDE PRISON


Sauce Kid the Naija rapa wey just come out for America prison afta dem catch am bicos of credit card wuruwuru bizness,don tell tori pipo say,him don write ova 300 songs wen him dey prison.
Just three days ago,Davido sign Sauce Kid enta Davido Worldwide Music,DMW.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...