MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 31 May 2018

FEDERAL HIGH COURT FOR ABUJA DON SENTENCE FORMA TARABA STATE GOFNOR,JOLLY NYAME TO 14 YEARS FOR PRISON BICOS OF THE 1.4BILLION WEY DEM SAY HIM THIEF


For di first time for Nigeria history, di federal high court Abuja don sentence forma gofnor of Taraba state Jolly Nyame to 14 years for prison.
All di whole jibiti and wuruwuru case wey dem bin don judge for naija,dem always dey free dem either thru fine settlement or other means.
But dis one different afta dem find Nyame guilti ova di N1.4 billion wey dem say he thief.
Di mata don dey court since 11 years.
We sidon for fence dey watch una,make we see weda dem go change di result laslast.

Wednesday 30 May 2018

EMMANUEL ADEBAYOR DON PROMISE TO BUY CORRECT CLOTHES AND SUIT FOR 'ONE CORNER' SINGA PATAPAA AND ALSO SPONSOR HIM NEW MIUZIK VIDEO



Afta many pipo laff one corner singa Patapaa bicos he wear over-size monkey coat to Ghana miuzik awards early dis year,football star Emmanuel Adebayor don promise to buy am correct Dolce and Gabbana suits from Italy.
No be only dat one o,Adebayor also promise to sponsor him next video shoot.
Patapaa imsef don thank Emmanuel Adebayor welwell for evritin wey him plan to do foram.
If you dey follow up,Adebayor don buy Range Rover dash Ghana comedian 'Funny Face' bifor.

Tuesday 29 May 2018

SINGER NINIOLA DON ANNOUNCE SAY SHE DON READY TO DONATE JAMB AND GCE FORMS plus NOTEBOOKS TO PIPO WEY THINGS ROUGH FOR



One of di top female Singa right now Niniola wey her miuzik karia don pick up wella,don ready to give back to di society afta she announce say she go arrange Jamb and GCE forms plus notebooks for pipo wey tings hard for.
She yarn dis one for her instagram handle and she say di books don ready.
Beta pikin,na so e sopose be.

Monday 28 May 2018

KISS DANIEL FORMA RECORD COMPANY G-WORLDWIDE DON YARN SAY,IF HE LIKE MAKE HE CHANGE HIM NAME TO 'KIZZ DANIEL', HIM COURT CASE WAHALA STILL DEY WAIT AM


Di wahala wey Kizz Daniel get wit him forma kompini G-worldwide entertainment,no look like wetin go stop veri soon.
If you dey follow up you go know say di kompini bin drag Kizz Daniel go court and di mata still dey court.
To escape dia wahal,Kiss Daniel kon change him name to Kizz Daniel since dem say dia contract witam still dey active.
Now G-worldwide don yarn say,if he like make he change him name,di wahala still dey court dey wait am.

Sunday 27 May 2018

SINGA YEMI ALADE DON YARN SAY,Di BEGi BEGi ON TOP FACEBOOK,INSTAGRAM,TWITA NEED TO STOP BICOS WORK DEY FOR ANYBODY WEY READY TO WORK


Many pipo don turn Facebook,twita,instagram to begging spot and di ting dey vex many pipo.
One of such pesin wey don yarn her mind na Supastar Yemi Alade.
She say those kind begging need to stop bicos he don too much.
She say instead of you to dey beg her for money upandan,makd you kukuma send email to her record company bicos work dey plenti.

Saturday 26 May 2018

FORMA PRESIDO GOODLUCK JONATHAN DON TALK SAY,SHAME DEY ALWAYS CATCH AM ANYTIME DEM USE NIGERIA NAME AS EXAMPLE FOR BAD BAD THINGS


Goodluck Ebele Jonathan don talk say,he dey shame say many pipo don dey use Nigeria name dey do example wen dem dey talk about bad bad things.
He say for example,Ghana president yab us as koropt kontri some months ago and di ting enta him soul.
Oga Jona yarn all dis one for Ado Ekiti wen he go komishon di first eva fly ova bridge for Ekiti state.

Friday 25 May 2018

WORLD CUP WINNER AND BRAZIL FOOTBALL SKILL KING RONALDINHO,DON READY TO MARRY HIM TWO GIRL FRIENDS Di SAME DAY DiS AUGUST


Ronaldinho di Brazilian football skill king,don ready to marry him two giflfrends di same day dis August.
Dia names na Priscilia Coelho and Beatriz Souza.
Dis two women bin dey stay wit Ronaldinho and dem no get problem wit di bobo plan to marry dem di same day.

Thursday 24 May 2018

POLICE DON ARREST 14 ARM ROBBERS WEY KILL 'DR IBRAHIM MAILAFIA', ONE OF THE SENIOR LECTURER OF NASARAWA STATE UNIVERSITY


For November 3rd 2017,arm robbas kill Dr Ibrahim Mailafia wey be sinior lecturer for Nasarawa state university.
Dr Malaifa just complit Doctor Degree on artifisha inteligence for UK and as he dey travel go Kano to visit him family naim dis bad boys killam.
Akordin to tori wey we gada,police don arrest di 14 arm robbas suspect.

Tuesday 22 May 2018

IN THE MIDDLE OF Di FIGHT FIGHT WEY KISS DANIEL GET WiT HIM FORMA RECORD COMPANY 'G WORLDWIDE', Di GUY DON VEX CHANGE HIM NAME TO KIZZ DANIEL



Kiss Daniel don change him name to 'Kizz Daniel' afta him forma record label start to givam wahala say dem still get kontract witam.
Dem bin carry am go court on top dis mata and dem even warn am say he no get right to use di name Kiss Daniel for stage.

Monday 21 May 2018

ONE BOY ISMAILA YUSUF DON USE HAMMER REMOVE SEVEN TEETH OF Di INDIAN OGA WEY HIM DEY WORK BICOS Di MAN NO GREE PAY AM HIM SALARY


Police don arrest one Ismaila Yusuf for Minna Niger state afta di guy use hammer skata him Indian Oga seven teeth.
Yusuf force imsef enta di man house go fight am wit hammer afta he refiuz to pay am him salary.
Akordin to Yusuf he say,di reason wey make di Indian man di Oga of Bolaji drilling company no gree arrange am him salary na bicos he hear say him won travel to Bauchi and he fit no comeback.
He say five years him neva travel go see him family and he need di money to take travel but him oga no gree pay am.

Sunday 20 May 2018

DEM DON DRAG DAVIDO NAME ENTA CULT FIGHT FOR SOUTH AFRICA AND SOMEBODY DON WARN FOR TWITA SAY MAKE HE DEY KIAFU IF NOT,DEM FIT FALL AM


If you know Davido,try advise am make he comot him leg for high tension wire.
Di tori wey dey come out for South Africa no swit o.
Afta dem kill one guy for cult fight for South Africa,pipo don dey warn am say,him go die for notin if he no dey kiafu.
Akordin to some guys for twita,dem say Davido get hand for di cult fight and if he visit South Africa,dem fit do am strong ting.
Di bobo wey dem kill so,na Davido bobo and he dey among di gang wey first kill anoda guy.
Di stupid ting about dis mata be say,dis pipo wey dey kill dem sef so,dem be naija pipo.

Saturday 19 May 2018

SOUND SULTAN DON YARN SAY,HIM DON GET MANY QUARREL WIT HIM FRIEND 2FACE BUT E NO DEY TAKE DEM 2 SECONDS DEM GO JUST SETTLE DIA QUARREL


Naija ninja Sound Sultan,don yarn tori pipo why him friendship wit 2face still dey kamkpe.
He say no be say dem no dey get quarrel sometimes but di ting be say,dem go just use di mata do fun and settle demsef kiakia.
Dia quarrel no dey take time to settle akordin to Sound Sultan.

Friday 18 May 2018

ONE WOMAN WEY DEM ARREST BICOS SHE WEAR ARMY UNIFORM DON TALK SAY WHY SHE DEY WEAR AM NA BICOS MAKE SHE NO DEY PAY TRANSPORT SAKE OF SAY HER SALARY TOO SMALL


During di parade wey di Operation Checkmate of di 81 Division of tthe Nigerian Army do,dem show di face of 12 pipo wey dey wear army uniform but dem no be soldiers.
Many of dem konfess why dem dey wear di uniform.
One of di woman konfess say,she dey wear army cap dey enta bus make she for no dey pay transport fare bicos her salary too lean.
She say out of di 20k wey be her salary,di agent wey give her di work dey kolet 5k as agreement money and di remaining money naim she takd dey take kia of she and her three shidren.
Dis one weak me o.

Thursday 17 May 2018

OUT OF Di THREE DIFFERENT WOMEN WEY BORN FOR WIZKID,TWO OF DEM DON TELL TORi PIPO SAY,WIZKID NO DEY TAKE CARE OF HIM PIKIN DEM



America base 'Binta Diamond',Wizkid second baby mama don yab Wizkid say he no dey take care of him son.
She say,afta di pikin reach 15 months naim Wizkid take gree say naim be di pikin papa and send some money.If you dey follow up you go know say, Shola di first baby mama wey born Wizkid first boy,also yab Wizkid some days ago say di guy no dey try bicos na only her dey carry di pikin load for head.

Wednesday 16 May 2018

PRESIDENT BUHARI DON YARN SAY,HIM NUMBER ONE ENEMY NA CORRUPTION AND NA SO DEM PUTAM FOR JAIL FOR 3 YEARS FOR 1985 BICOS SAY HIM DEY FIGHT CORRUPTION


President Buhari don yarn tori pipo say,wen dem porshoe am comot for gofment wen him be khaki president for 1985,na so di Babangida new gofment putam unda house arrest for 3 years just bicos him dey fight koropshon.
He say now wey him be president again,him must fight di koropshon reach ground.

Tuesday 15 May 2018

GUYS,E DON RED O..TORi WEY DEY REACH US BE SAY, NO BE DAVIDO BUY Di N10 BILLION PRIVATE JET WEY HE CLAIM SAY HIM BUY,DEM SAY NA LIE Di BOBO LIE



Akordin to di tori wey dey fly like kite,dem say na lie Davido lid say no be him buy private jet wey he dey claim say he buy.
Pesin wey yarn dis sikrit out na pesin wey dey very close to Davido.
Dem say di N10 billiion naira private jet wey di bobo dey claim no bilong toram but he get small hand for di jet.
Di tori also carry say,di reason why di ownas use Davido dey frontam na bicos him na popular guy and he go hep sell dia market make who won hire di jet fit hire.
Anyway sha,we dey wait Davido to come deny dis one.

Monday 14 May 2018

TWO FIGHTING AS DAVIDO AND TIWA SAVAGE DON STOP TO FOLLOW EACH OTHER FOR INSTAGRAM AFTA DAVIDO USE STYLE CALL HER WIZKID BABE


Davido and Tiwa Savage won start new fight afta Davido use style call her Wizkid babe.
Dis one appun wen Wizkid write on top twita say him dey look for a sista.
Davido no waste tome to yarn for Wizkid wite up say, 'Tiwa our sista o.'
Tiwa Savage no kon find di joke funny as she kon unfollow Davido for instagram.
Trust Davido,di bobo sef unfollow Tiwa one time.
All dis pipo dem,una don start again o.
We no want fight o.

Sunday 13 May 2018

COMEDIAN 'I GO DYE' DON SURPRISE EVERYBODY AGAIN AS HE DON DEY BUILD N100 MILLION NAIRA HOSPITAL FOR HIM VILLAGE PIPO FOR DELTA STATE



I go dye,di badman comedian don dey kontiniu to set beta example for naija pipo and selebritis to copy as he don dey build N100 million hospita for him village pipo for Delta state.

Saturday 12 May 2018

FOR GHANA,DEM DON SACK ONE JUDGE(LAWYER) AFTA HE COLLECT GOAT WEY DEM TAKE BRIBE AM


Funny funny stori no fit end for dis worldt all.
Sake of say Judge collect goat as bribe naim make dem sackam for Ghana.
Dis one weak me finish.

Friday 11 May 2018

INCASE YOU NEVA HEAR,DAVIDO DON BUY PRIVATE JET AND HE FIT ENTA GUINESS BOOK OF RECORDS AS Di YOUNGEST BOY WEY GET JET



Dis one loud finish as di man of di moment Davido don buy private jet.
To show u say no be lie,Davido imsef post di receipt of di jet for instagram make di world see.
He also yarn say,di jet go enta in two weeks time.
Naim be say dis 30 billion song wey him sing no be joke o.
Na wa o,na only one pesin money long like dis at 25 years?

Wednesday 9 May 2018

DANFO DRIVERS DON DEY LOOK FOR TEKNO AND DEM SAY IF DEM CATCH AM DEM GO SHOW AM PEPPER AFTA DEM SAY HE TIFF DIA SONG


Danfo Drivers don dey use torch and candle dey look for Tekno afta di bobo remix dia song without dia knowledge.
For di video wey enta our tori room,Danfo Drivers say dem dey vex beta vex for Tekno bicos he tiff dia song and if dem katcham,e go red.
Watch di video for bottom hia...

Tuesday 8 May 2018

ONE SENIOR MAN DON ADVICE DAVIDO BABE CHIOMA MAKE SHE NO ALLOW DAVIDO DECEIVE HER CARRY BELLE UNTIL HE GO IMO STATE GO PAY HER BRIDE PRICE


Dem say di ting wey old man dey see even if you climb on top mango tree you no go see am.
Na dis one make one elderly man on top Instagram dey give advice to Chioma,Davido babe say make she no allow Davido give her belle di way weyhe take give oda girls belle except he don go Imo state go pay her bride price.
Akordin to di man if she get belle now di bobo fit use tortoise brain take dump her just like he dump di oda girls.

Sunday 6 May 2018

DAVIDO DON TELL FELLOW MUSICIANS FOR EKO HOTEL YESTADAY SAY,'HELP NO DEY KILL' SO DIAFOR MAKE DEM STOP TO DEY STINGY AND REMEMBA PIPO WEY NEED HELP



Nor be small ting for di Headies Award wey dem do yestaday night for Eko hotel Lagos as Simi,Davido win three three award each.
Apart from Wizkid wey win four awards,di night belong to Davido bicos he win artiste of di year.
No be even dis one be di news wey trip me.
During di time wey Davido dey give him acceptance speech,he yarn say make oda miuzishans dem also try dey help pipo wey need help bicos 'help no dey kill'.
He say him dey help many pipo and Na dis one make God dey bless am steady.
Oya watch di video hia...

Saturday 5 May 2018

ACTRESS AND NOLLYWOOD BAD GIRL 'COSSY ORJIAKOR' DON ENTA FARMING BIZNESS SHARP SHARP AND SHE SAY SHE DON FIND OUT SAY NO FOOD FOR LAZY MAN


Nollywood baddest babe Cassy Orjiakor don enta farming bizness sharp sharp bicos she don realise say,man must wack.
She yarn tori pipo say,her actress work nodey disturb her from goibg to farm bicos man must wack.

Friday 4 May 2018

IMO STATE GOVNOR ROCHAS DON GIVE BIG BRODA NAIJA WINNER 'MIRACLE' PLOT OF LAND AND ALSO GIVE HIM AND HIM BABE NINA N2 MILLION NAIRA EACH


Imo state gofnor Rochas Okorocha don promise to sponsor dis year big broda naija winna Miracle to finish him pilot school education.
He yarn dis one during di welkom serimoni wey di Imo state govment organise for Miracle and also him babe Nina.
Di govnor also dasham plot of land.
Nor be only dat one o as di govnor also dasham N2 million and dash Nina N2 million naira too base on say dem come from Imo state.

Thursday 3 May 2018

TOO MUCH MONEY AS CRISTIANO RONALDO DON BUY ENGAGEMENT RING GIVE HIM GIRLFRIEND AND NA N300 MILLION NAIRA DEM DEY SELL Di RING



Di prezent world footballer of di year and Real Madrid football club supastar don buy engagement ring give him girl frend.
Dat no be di news,di news be say dem dey sell di ring N300 million naira for market and dis ring na to let di babe know he won marry her.
No be small mata be dis one.

Wednesday 2 May 2018

ONE WOMAN WEY CALL HERSELF EMIL ROCK,DON BLAST DAVIDO SAY HE GET LOUD MOUTH AND SHE DEY SURPRISE SAY CHIOMA HIM GIRLFRIEND DEY FOLLOW DAT KIND BOY


Emil Rock one woman for facebook don yab Davido and him girlfriend Chioma afta Davido buy her porsche car of N45 million.
Di woman say Davido na pikin wey don spoil and she dey surprise say Chioma dey run follow am upandan.
She also say Davido get loud mouth and she dey surprise say Chioma mama allow her dey fool hersef.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...