MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 31 March 2018

ONDO HIGH COURT DON SENTENCE DRIVER 'BABATUNDE' TO DEATH AFTA HE ROB AND KILL HIM OGA 'FAITH OMOTAYO' FOR 2012


Ondo high court Don sentence one driver to death afta he use koni koni rob him oga and also killam for di operation.
Di driver Akinyemi Babatunde tie him madam Faith Omotayo for chair bifor he kill her.
Afta he kill di ogamadam,he carry her laptop, her Camry cat,her two phones take run.
Now,afta about about 6 years wey di tin happen, court don finalli sentence am to death.

Friday 30 March 2018

ONE GUY DON YAB Di FRIED RICE WEY 'CHIOMA' DAVIDO NEW BABE COOK SAY, Di FOOD BE LIKE VOMIT


Chioma,Di new babe wey Davido don take shaka tire,don resiv yabis from one fan as Di fan say Di fried rice wey she cook be like vomit.

Thursday 29 March 2018

CHAIRLADY FOR AMEBO TORi LINDA IKEJI,DON FINALLY GET BOBO WEY WAN MARRY HER AND NO BE SMALL CRY DON JAZZY CRY BICOS HE LOVE LINDA TOO



Since yestaday,.di Queen of amebo tori for naija,Linda Ikeji don finally get bobo wey dem two Don agree to marry.
Many pipo including her sistas Laura and Sandra don dey congratulate her since yestaday.
But one man wey pipo dey suspect say dem bin dey do touching bodies 'Don Jazzy', don cry tire since di news come out.
But make we dey watch who di bobo be as she neva tell us di name.
No sorprise to stul hear say na Don Jazzy di miuzik producer.

Wednesday 28 March 2018

SOLUYI AND SOSANYA AREA OF GBAGADA LAGOS,DON BEG GOFMENT TO HELP DEM AS MONKEYS DON DRIVE DEM FROM DiA HOUSE AND EVEN DEY ENTA KITCHEN GO CHOP DiA SOUP


Di first time,na rat naim drive una president comot for Aso Rock and una take am as joke.
Small time snake swallow JAMB N36 million,una still take am as joke,monkey chop northern Lidas N70 million una still feel say na joke.
Now monkeys don dey drive di pipo of Soluyi and Sosanya kominiti for Gbagada Lagos state comot for dia house and even dey enta dia kitchen go open pot of soup,make eBa chop sef,Dis one na still joke?
Di pipo of Soluyi and Sosanya don dey beg gofment and di Lagos state ministri of Agriculture to come hep dem fight di monkey dem but dem no ansa dem.
Akordin to di chairman of di kominiti Landlord Association Mr Adigun Olaleye,he say,e don dey veri difficult to stop di monkey dem skata skata karata.
He say di monkey dem dey come from di swamp forest wey divide dia kominiti and Ifako area.
He also yarn say,di monkey dem no get anybodi time as dem dey enta di town anytime dem like.
Morning,evening and even aftunoon and even tho you lock your house,dem still dey find dia way enta.
Akordin to one man wey tori pipo follow yan he say,him even try to katch one of di monkey one day but di monkey fight am no be small.
He say,di monkey use him long fingas take punch hole for him neck and skratch him face peel.

Tuesday 27 March 2018

WE BIN TELL UNA ABOUT NEW LOVERS FOR TOWN 'KISS DANIEL AND CHIDINMA', NOW TWO OF DEM DON DRAW Di SAME TATTOO FOR DiA HANDS TO TAKE PEPPER Di STREET



Kiss Daniel and Chidinma love right now don dey sirios evriday by day.
Dem dey drive togeda,dey practice miuzik togeda,dem dey laff togeda and now dem don even draw tattoo togeda on top dia hand.
Afta we see dis pishor wey Kiss Daniel share on top Instagram, we say make we bringam to una as e dey hot.
Two of dem don turn pepper dem gang as dem don find happiness togeda and we pray make dat happiness remain wit dem.

Sunday 25 March 2018

AFTA 2 YEARS,DEM DON FINALLY RELEASE NAIJA RAPPER 'SAUCE KID' FOR AMERICA PRISON AND DEM BIN PUTAM FOR JAIL AFTA HE SHOOK HAND FOR CREDIT CARD WAYOMENT



Naija rapa 'Sauce Kid' don finalli turn to free man afta dem relizam for America prison afta 2 years.
Dem be arrest am dat year afta he shook hand for wuruwuru credit card bizness.
We hope say him go wise up as dem don givam anoda chance to koret all him bad.

Saturday 24 March 2018

RAPPER AND SINGA OF IJOYA 'WEIRD MC' WEY BE 47 YEARS OLD NOW DON TALK SAY,SHE DON READY TO BORN PIKIN NOW


Singa of ijoya Dat year weird mc,Don talk say,she Don ready to get shidren now and she go like born two pikin.
She say she no mind born 2 pikins and she like shidren welwell.

Friday 23 March 2018

OBASANJO DON YAN SAY,E BE LIKE SAY HIM GO WRITE ANODA LETTER TO BUHARI AFTA HE ADVISE AM FOR Di FIRST LETTER NOT TO RUN OR COME BACK FOR 2019 ELECTION


Forma sivilian and khaki presido Olusegun Obasanjo don talk sy e be like say,him go write anoda letter give President Buhari.
If you rememba some months ago,Obasanjo bin write one letter give Buhari say make he go rest for 2019,make he no try to run for 2019 elections.
He say naija pipo no want am again so diafor,e go beta make he respect imsef.

Thursday 22 March 2018

CROSS RIVER HIGH COURT CALABAR, DON SENTENCE FORMA NNPC WORKER GODWIN ELEWANA TO DEATH BY HANGING AFTA HE KILL HIM DAUGHTER BOYFRIEND


Wondament na di name of wetin dis man Mr Godwin Elewana, do to him daughta boy frend.
He kill di daughta boyfriend Douglas Ojugbo for March 10,2015 just bicos he dey frend him daughta wey her name na Mercy and now di High Court for Calabar don sentence am to death by hanging.
Mr Godwin na forma NNPC worker and dem don bin pinam down for prison since 2016.

Wednesday 21 March 2018

D'BANJ AND HIM BIFOR BIFOR BIZNESS PARTNA DON JAZZY,DON AGREE TO COMEBACK AND DO 'MO HITS GET TOGEDA SHOWS' FOR DIFFERENT CITIES


If you dey follow up,you go know saye get di period wey be say,na Mo Hits gang hold di industri down for naija.
D'banj,Don Jazzy,Dr Sid,Wande Coal,D' Prince,Ikechukwu and Kayswitch,na dem be membas of dis gang.
Now dem Don diside to comeback one more time togeda and carry waka enta different cities for di world and do di 'Mo hits get togeda konsat'.
D'banj and Don Jazzy even share di video of dia comeback for Instagram.
Most fans Don dey selibrate dis dis plans why some even dey say,di homeboys Don broke naim make dem wan do dis shows make dem fit gada small ting take see front.

Tuesday 20 March 2018

TOO BAD AS ONE 18 YEARS OLD GIRL LOVETH FOR UGHELLI DELTA STATE, DON DRINK POISON KILL HERSELF BICOS SHE FAIL JAMB


One of di richest black woman for di world,Folorunsho Alakija,don tell us bifor say if you won make am for life,no be must say you must get univasiti degree.
Why pesin go drink poison kill hersef bicos she fail JAMB to take enta univasiti?
Well dat na wetin appun for Ughelli,Delta state as one 18 years old babe Loveth drink otapiapia wey she take for her mama shop and kill hersef bicos she no pass JAMB.
Tori wey we gada be say,she score 160 and non dey fear say her papa go kill her.
Na dis one make her drink otapiapia.
Meanwhy,her papa say di only tin wey him telam be say,she no go fit use dat kain low score take study medicine for univasiti.
Wen di famili see say she don faint for room,instead of dem to rush her go hospita,dem carry her go church make dem pray for her.

Monday 19 March 2018

SINGER 'DICE AILES' DON YARN SAY,Di SONG WEY HIM SING ABOUT BILLIONAIRE 'OTEDOLA', HIM NO SINGAM BICOS HE WANT MAKE Di MAN DASHAM MONEY


Chocolate city artiste Diles Ailes don talk say,wen him sing about Otedola di billionaire, him no sing di song bicos he want di man to dasham money.
Akordin to Ailes he say na fun him just dey katch no be favor him dey find.
He say afta di song him don finalli meet Otedola and di man dasham plenti money.
He also yarn say him dey call di man anytime wey him want and him don turn frend wit him shidren too.

Sunday 18 March 2018

KISS DANIEL DON BUY CHEVROLET DASH HIM JUNIOR BRODA TO TAKE CELEBRATE HIM BIRTHDAY


Kiss Daniel don buy Chevrolet car give him junior broda Anidugbe Mofoluwato Uthman to take selibrate di bobo birthday.
Uthman wey dey veriveri hapi,thank Kiss Daniel on top Instagram.
Nice one Kiss,no be evribodi fit do dis kain tin.

Saturday 17 March 2018

MY MAMA WANT MAKE I MARRY BUT I DEY CONFUSE BICOS MY GIRLFRIEND DEM PLENTY..NA SO WIZKID TALK




Starboy Wizkid don tell tori pipo say him girlfriend dem plenti and di tin dey konfiuz am bicos him no know wot to do and meanwhy,him mama want make he marry.
He yarn dis one during di joinbodi sidon wey him do wit Gbemi of Beat FM,Lagos.
Wizkid don alreadi get three boys from three different women.
If he finalli redi to marry,who him go choose from di three abi na new malawi him go marry?
Make we dey one kona dey watch.

Friday 16 March 2018

BIG BOY TINGS AS OLAMIDE BADOO DON OPEN HIM OWN TV STATION AND HE CALL AM 'VOICE OF THE STREET' TV


On di day wey Olamide selibrate him birthday, he mark am wit di opening of him own TV station 'Voice of The Street' under Play Tv
Dis one pass man wey sabi o.
Play tv dey di same compound wit TVC for Ketu,Lagos and he promise to give di first 100 pipo wey go mitam for di compound free decoder of Play TV.
Who say success no swit?

Thursday 15 March 2018

TIWA SAVAGE AND HER HUSBAND TEE BILLZ DON LET COURT KNOW SAY DEM NO WAN MARRY AGAIN AND COURT GO SOON SKATA DiA MARRIAGE


Court go soon skata di marage bitwin Tiwa Savage and her husband Tee Billz.
Dem be kworel sirios kworel ova two years ago afta Tee Billz disgrace Tiwa say she don sleep wit Don Jazzy,2face and Dr Sid.
Dis mata kon vex di babe and she kon yan many sikrit full ground and how she take dey feed Tee Billz.
Now e be like say afta dem come back togeda di ting no work out and na divorce remain make dem for go dia seprate way.

Wednesday 14 March 2018

KWARA STATE GOVNOR ABDULFATAH AHMED DON BAN Di SELLING AND DRINKING OF ALCOHOL FOR SOME AREAS FOR Di STATE


If you be shack bobo and you dey stay Kwara state,guy e don red o.
Kwara gofnor Abdultafah Ahmed don ban di selling and drinking of alcohol or even ogogoro espeshali for di Ilorin area.
Di state house of assembly get law wey dey back dis ban up and if you break di law you go pay N100,000 if dem katch you.

Tuesday 13 March 2018

Di OWNER OF PAOK SALONIKA FOOTBALL CLUB FOR GREECE,VEX ENTA FIELD WIT GUN AND NEARLY SHOOT Di REFEREE AFTA Di REFEREE DISALLOW DIA GOAL



Ivan Savvidis di owna of Greece club,PAOK Salonkia,rush enta field and niali shoot di referee of dia match wit AEK Athens afta Di referee first accept dia goal for ending of di match and later disallow di goal.
Na one minute bin remaivn for di match to end wen PAOK score but di referee say no be beta goal afta he don first blow say na beta goal.
FIFA don alreadi shook mouth for di mata say dem go ban Greece from football kompetishon if dem no take time.
We no say Saviddis no try for dis one but some of dis referees dey mad too.

Sunday 11 March 2018

LONDON AND Di WHOLE BRITAIN WAN BUILD N315 MILLION NAIRA PRISON FOR LAGOS SO DAT DEM GO FIT DEY TRANSFER SOME PRISONERS COME HERE


Britain don konklud plans to build 112 bedroom prison For kirikiri,Lagos so dat dem go dey transfer prisoners from yonda to Naija.
Di reason be say,dia prison don to full and e dey giv dem headache so dem need were dem go build to reduce dia cells.
Dem bin don enta dis agreement wit Naija for 2014 and now dem don ready to arrange di mata once and for all.
Akordin to tori wey we gada na £700,000 wey be N315 millions for Naija naira naim dem go spend to build di prison.
No be kwekwe prison dem won build but Koret prison wey go meet United Nations standard.

Friday 9 March 2018

ONE FAKE PASTOR DON GIVE TWO SISTERS BELLE FOR UGBOLU KOMINITI,NEAR ASABA FOR DELTA STATE AFTA HE DO FAKE DELIVERANCE FOR DEM


One ashawo pastor don give two sistas belle for Ugbolu kominiti for near Asaba for Delta state all in di name of dilivrance.
Dis same pastor, don first do somtin like dis for Enugu wia he sleep wit mama and pikin.
Di church membas bitam welwell and dem kon drive am comot for Enugu.
Afta he run from Enugu, he come land for Asaba wia he for komit anoda one.

Thursday 8 March 2018

JAPAN COCA-COLA DON FINISH PLANS TO START TO SELL COCA-COLA WEY ALCOHOL GO DEY INSIDE


If you dey visit Japan very soon,make you putam for di back of your mind say,Coca-Cola wey carry alcohol go dey market anytime from now.
You fit say why dem won add ogogoro join Coca-Cola wey no dey high bifor,but trust me dem oh make crazy money for dis idea.
And we biliv say,Coca-Cola worldwide go buy dis idea and put do anoda coke wey go carry ogogoro.
For 125 years wey Coke don dey,dis na di first dem wey dem won pack alcohol inside dia product.

Wednesday 7 March 2018

AFTA DEM KILL 73 PIPO FOR BENUE STATE SOME MONTHS AGO,FULANI HERDSMEN DON KILL ANODA 24 FOR Di SAME BENUE AGAIN


I neva still undastand di reason why human bin go kill anoda human bin like am.
Did Fulani herdsmen own don too much o.
Do nomba of pipo wey dis malu boys don't kill for naija in two years go don't pass 5,000 and yet givment kwayet.
Afta dem kill 73 pipo for Benue state some moths ago,dis same malu boys don kill anoda 24 again for di same Benue for no reason.
Mean why,Federa Gofment just fold hand dey look.
Why Nnamdi Kanu no go talk say dem want dia own kontri wen some pipo go just wake up dey kill pipo like fly.
Nigeria na our own and gofment must protect human lifes.

Tuesday 6 March 2018

SENATORS DINO MELAYE DON YAN SAY,HIM DEY SHAME FOR Di WAY WEY WE DEY CELEBRATE OUR INDEPENDENCE DAY AFTA HE WATCH Di WAY GHANA OWN DEY VERY SWEET TODAY


Senator Dino Melaye don yab Naija independence selibrashon afta he watch di way wey Ghana pipo dey selibrate dia own.
He say di kolor,style and serenren wey Ghana Own carry,make our own look like pikin play.
Ghana dey selibrate dia Independence Day today and pipo like Dino Melaye,President Buhari and many other politishans dey di ground for Accra.

Monday 5 March 2018

ONE MODEL 'QUINBEEE DEBBIE' DON YAB TEKNO AFTA TEKNO REJECT HER NOT TO DEY INSIDE HIM VIDEO BICOS SHE BLACK WELWELL




Quinbeee Debbie, one black model,don pour out yabis give Tekno afta she say Tekno no allow her play di part wey di video director want make she play for him miuzik video.
She say Tekno reject her bicos she black welwell.
Akordin to her she say,Tekno want make she dey back for di video later dem go use anoda babe wey her face go show for di front take do di video.
Quinbeee say di insult too much as she waka comot for di video.
She kon advice pipo for twita make dem dey proud of dia dark skin,make dem no allow anybodi take dia kolor do robish.

Sunday 4 March 2018

YESTADAY,ATIKU ENTA SILVERBIRD CINEMA GO WATCH Di NUMBER ONE FILM FOR Di WORLD RIGHT NOW 'BLACK PANTHER' AND HE PAY FOR EVERYBODi WEY COME WATCH Di FILM



Atiku Abubakar di politishan wey dey try porshu Buhari from Aso Rock for 2019enta Silverbird sinima yestaday for Abuja go watch di omba one film right now 'Black Panther'.
Di tori wey we gada be say,Atiku pay for evribodi wey come watch di film wen he rish dia.
Some pipo say na skamin.
Dem say why he dey do all dis one na bicos of 2019 election why some say na lie,Atiku na good pesin for a very long time.
My one be say,hope say him buy popcorn join for dem to just komplit di good since no be bicos of election make am pay for dem.

Saturday 3 March 2018

MANY MUSIC RECORD COMPANIES FOR NAIJA,NA YAHOO YAHOO BOYS GET DEM ACCORDING TO Di KOKO MASTER IMSEF, D'BANJ



Di chairman of koko garri worldwide, D'banj,don yan tori pipo say,most of dis record konpinis wey u dey hear of for naija,na Yahoo Yahoo boys get dem.
He yan dis one for Di social media week wey dem arrange for Lagos.
D'banj also talk say,na only for naija you go see pesin wey no undastand miuzik but he get miuzik konpini.

Friday 2 March 2018

FOR ABIA STATE,ONE BANK CUSTOMER WEY DEY VEX DON PUT FIRE FOR Di BANK AND ALSO BURN MOTORCYCLE WEY DEM PACK OUTSIDE Di BANK


We still dey try find out wetin dis bank do dia kostoma wey make am put fire for dia building and also go outside go burn bike.
For di video wey I put hia,you go see say di man carry fuel,pour am for di ATM machine and light fire put.
Afta dat he go outside go burn bike wey dem pack for around di gate.
He niali burn one car wey dem pack outside near di bank but pipo stopam bifor he cut out.
Just watch am for yasef...



Thursday 1 March 2018

KOREDE BELLO NO CELEBRATE HIM BIRTHDAY DiS YEAR BICOS DEM BORN AM FOR FEBRUARY 29 AND NA FEBRUARY 28 Di CALENDAR FOR END


If dem born you for February 29,naim be say na every four four years you go dey selibrate ya birthday.
Dat na wetin no make Mavin Records bobo and Don Jazzy boy, Korede Bello selibrate him 22 years old birthday dis year be dat bicos dem bornam for February 29.
Month,end yestaday and na 28 February di month end for dis year.
Who arrange di calendar sef?
Na human beans abi na God?
See proof for hia...

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...