MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 30 November 2015

Di INDUSTRY DEY FOOL ME BICOS I NOR BE POLITICIAN-BURNA BOY

Burna Boy wey just reliz anoda new album,"On a Spaceship",don yarn say,wetin make am neva win any award for naija na bicos him no be politishan.
Di bobo say him no belong to di Nigeria miuzik industri bicos to win award,u must play dia politiks.
He yarn all dis one wen tori pipo,di fader magazine followam do one small join bodi intaviu.
He say bicos he no dey dance to dia miuzik naim make di award organizers no like am.


Burna also say,some of di pipo wey dem dey give awards nor sabi risham for one kobo.
"I nor get one million folowas for twita and instagram but di tins wey i dey do,dose ones wey get dat kain plenti folowas no fit do am."
Di sabiboy also yarn say,wetin make him fans dey inkriz evri minute na bicos him dey gidem beta jams wey dey make dia bodi cooleh.
Wen i follow some pipo yarn for street to hia from dem konsigning dis mata,all of dem gree say Burn Boy ova dizav awards for di good miuzik wey him don play.

IF YOU KNOW ANY FILLING STATION WEY DEY HIDE FUEL OR SELL PASS N87,OYA CALL DIS NUMBERS


Area,wia una dey?
Make una come out o!
Govment say make I tell una say dem won hep una fight di fight wey be say na dem cause.
If u know any filling station wey get fuel but dem go lie say dem no get,or if know any station wey dey sell fuel pass N87,make you call dis DPR nombas wey I don put for bottom hia:

OMO SEE BAD MOUTH AS FANS DON ATTACK ANNIE IDIBIA OF BLEACHING(Fotos)

Baba Fela,wia you dey?
I just wan let you know say dat yor jam 'yellow fever(u dey bleach)', e be like say some pipo listin toram yestaday as dem don enta town dey blast di wife one of di miuzishan wey your miuzik inspire,2face Idibia.
Dem say 2baba wife dey blich fire.
Annie Idibia post her new finga nails for Instagram wey she do for her costoma place.
She kon dey prayz di nails say her costoma finish work for di nails but she no know say some of her fans nor send di nails as na oda tins dem check for her bodi.
Dem say she dey blich her hand so make she cool down for Jesus.
Read wetin di fans dem yarn for bottom hia:

NA SO SO KISS CHIDINMA AND FLAVOR DEY KISS?ABI ANODA TING DEY WEY WE NOR KNOW ABOUT?(Fotos)

Wait o!
Chidinma feel say Flavour Nabania na gentle guy like us wey dey respect gehs?
Dis one wey be say anywia dem two meet dem must kiss and snap di kissing foto for pipo to dey jealous.
Chidinma!Chidinma!Chidinma!How many times I call you?
Flavour nor be pesin wey dey pity for geh wen bodi touch bodi.
Ask Sandra Okagbue and Anna Banner,two of Flavour baby mama, dem go giv you di bobo gist.
Dis two women don born pikins for Flavour and di way wey Chidinma and di highlife singa dey kisskiss anywia dem jam,Chidinma fit end up as baby mama nomba three for di bobo.
Dem kiss for Ololufe vidio,dem kiss one time like dat again and now dem don join mouth again dey kiss yestaday muah muah muah.
Na for Onitsha dis one appun dis time around for Phyno show wey dem call "Phyno Fest".
Wahala nor dey,we dey wait for scores and result of dis two pipo.
I go give una di latest gist as e enta,make I cross go buy akara.

Sunday 29 November 2015

I FIT DIE ON TOP WIZKID MATA,I LOVE Di BOBO DIE-WANDE COAL

Wande coal don follow tori pipo yarn on top Wizkid and Davido beef of dat year.
He say all dis beefing tins dey appun for life.
Wande say na norma tin as both Davido and Wizkid don benefit from him miuzik.
He say he love di two of dia miuzik but Wizkid na one pesin wey him dey veri close to bicos di bobo don learn welwell.
Akordin to Wande Coal, "me and Wizzy don come a long way.na my broda.i lovam die.Davido dey do he own ting.for dis game,all dis beef and fight dey appun.make pipo just undastand say dis miuzik ting na compitishon."

CHAi MONEY GOOD O!SEE WETIN E TURN OREZI TO

Money as dem talk am na di root of all evil but di wondas wey dis evil call money dey do,fit make pesin worshipam.
Di Isoko born singa,Orezi don tush up since small raba start to dey enta.
We try root out Orezi forma pishor and compiaram wit new one and dis na wetin we get.
Money is not evritin but I biliv say no be evribodi biliv.

Saturday 28 November 2015

NA TRUE?POLICE TO PUNISH POLICE AS DEM DON RELIZ NUMBAS WEY U FIT CALL IF ANY POLICEMAN FALL YOR HAND

Dog dey chop dog?
I neva hiaram bifor o.
We dey our own jejeje bifor di Nigerian Police Force tell us say,any police wey trit us anyhow,we fit report dem now.

Akordin to how di mata dey go,di inspetor genera of police,IGP Solomon Arase,won make sure di police force go dey responsibo make evribodi for dey feel dem.
So dat Naija pipo go dey look dem wit beta eye once and for all.
Dem say all dem need na yor soport and coprayshon.
Di Nigerian Police Force,NPF,don reliz some nombas wey u fit call to repot any policeman wey fall yor hand or any policeman wey nor dey do him work well for Lagos.
Dis na di nombas:
Provost Marshal – 09053872207, Control-Room – 09053872208, X-Squad – 09053872209.
Nor forget say police na yor frend.

Friday 27 November 2015

BLOOD OF GOD!!! WICH TAILOR USE ''CONDOMS'' AS MATIRIA TAKE SOW DRESS WEY DIS GIRLS WEAR SO?(Fotos)


Talent or madness?
Make dem give di tailor award or make dem flogam?
So gehs don dey wear condom as dress now?
Look dis dress welwell,make you see di kain krazy tin wey dem do.
Di less u look,di more u dey see.
Tins dey appun sha o!

WAR OF WORDS!!! ABEG WETIN DEY WRONG WITH DIS DAVIDO BRODA DRESSING?

Naija pipo and dia badmouth,be like okorowanta biabia and sharp shaving stick.
Naija pipo mouth sharp pass new razor blade.
Davido broda,Adewale,wey be direktor for him papa compini and chairman of HKN entatayment,post one foto for Instagram but naija bobos no letam rest as dem dey blastam from left,right and centre.
Adewale sef nor gree for dem as he show one of dem say him get badmouth too.
Why some pipo fit look Davido broda,Adewale dressing as mature and responsibo,some dey lookam as amateur and yeye.
Wetin pesin go do wey dem nor go yarn sef?
You dress corprate,dem go yarn.
You wear rugged jeans,dem go stil yarn.
You tie cloth dem go also yarn.
Na wa for wire road.

Thursday 26 November 2015

LONG THROAT DON MAKE DEM CATCH THIEF AFTA HE CHILLAX DEY SHACK MALTA GUINESS WEN HIM ROB FINISH

As dem talk am,evriday for di tiff one day for di owner.
Long throat for malta guiness don make dem catch one tiff for Ebute Metta.
If God say yor own don be you nor fit eskape pam as one 28 years old bobo,Olamilekan Olaoluwa,brake enta somebodi two-bedroom flat for Brickfield Road around 2pm wen di owna nor dey.
He carry plasma TV,pack clothes,wristwatchs and phones.
Afta he gada dis tins,he kon chillax tinking say naim him papa parlour him dey.
He enta kishin go look for food.
As e open fridge,he kon take one malta guiness dey drink.
As he dey shackam,luck kon run againstam as di owna of di house waka enta,kon jamam dey drink her malta guiness.
She kon shout Ole! Ole o! Ole o!
As pipo pack come,dem panel beatam welwell bifor police come arrestam go Iponri police stashon.
Later,as dem carry di bobo go court,him agree say him dey veri veri guilty and dis one kon make di magistrate, Mrs Fowowe-Erusiafe,postpone di case go Novemba 30 foram to know him ponishment.

Tuesday 24 November 2015

BREAKING NEWS!!! 'CHIEF 2FACE' DON GET CHIEFTAINCY TITLE FOR KADUNA(fotos)



                                       
                   
Any wia you see tubaba,rememba to put chief for him name make e for no cause quarel.
Some few minutes ago,dem givam chieftaincy title for Kaduna as di "Tafidan Kudendan" of Kudendan.
Di African Queen singa,carry waka go see di Kaduna state Govnor,Nasir El rufai as he  postam on top Instagram as he no fit hide di joy of di betament for him life.
Him wife,Annie Idibia and M.I dey di ground witam.
Even M.I post pishor of him,Annie,Chief tubaba for Kaduna.

BREAKING NEWS!!! 'CHIEF 2FACE' DON GET CHIEFTAINCY TITLE FOR KADUNA(fotos)

Any wia you see tubaba,rememba to put chief for him name make e for no cause quarel.
Some few minutes ago,dem givam chieftaincy title for Kaduna as di "Tafidan Kudendan" of Kudendan.

Di African Queen singa,carry waka go see di Kaduna state Govnor,Nasir El rufai as he  postam on top Instagram as he no fit hide di joy of di betament for him life.
Him wife,Annie Idibia and M.I dey di ground witam.
Even M.I post pishor of him,Annie,Chief tubaba for Kaduna.

MAKING SENSE!!! BBC DON DEY READY TO LAUNCH PIDGIN ENGLISH AND YORUBA SERVICE FOR NIGERIA

Di British Broadcasting Corperation,BBC,don dey rizin like me say pidgin inglish na di nomba one ogbonge language of Naija pipo.
Di language wey our mama undastand.
Di language wey 2face dey beg gofment make dem introduce enta our schools.
Di language wey mama akara dey undastand wit speed.
Di language wey Fela sell give oyibo pipo wit him miuzik.
Di only language wey unite di whole naija,weda you be Ibo,weda you be Ibibio,weda you be Urhobo,weda u be Hausa,Yoruba,Ijaw,Igarra.
How you won take take language wey ova 100 million Naija pipo take as dia first language as joke?
Sorry o if u take am as joke bicos,BBC nor take am as joke as dem don conclude plan to open dia digital service for pidgin and also yoruba langua for naija.
Dem make dis announcement afta di UK govment agree to put £85m a year for down make dem take push dia market(BBC service) enta di world.
Na ova 308 million pipo worldwide dey hear BBC and dem dey hope to inkrizam to 500 million pipo by 2022.
Una Welkom.

DEVILS!!! OUR GOVERNORS TOO WICKED,EVEN DIA DOGS DEY CHOP PASS 18K A MONTH-SENATOR BEN BRUCE

How pesin wey dey use ova N18,000 just to eat in di morning,go yarn say N18,000 too much as  a month salary for oda pipo?
Dis na di queshon wey di senator wey dey represent Bayelsa-east,Senator Ben Bruce,dey ask di govnors wey enta meeting last week say dem no fit pay workers 18k again as salary bicos e too much.
Ben Bruce say even dogs dey eat pass 18k a month for govment haus how much more human being.
He also yarn say wetin di money go reach pesin do dis kain time wey tins don cost die?
Bruce kon ask one queshon say,weda e make sense for dia eye as NYSC memba dey resiv N19,800 and Naija worka dey resiv N18,000?
He say dis kain plan wey dis govnors dey plan na nonsense bicos inside di 18k,di worka go strogle to pay rent,feed and pay shidren school fees.
Ben Bruce wey yarn all dis one on top twita,talk say anybodi wey dey rizin like dis,just dey plan to punish di family.

Monday 23 November 2015

SHUO!! HOW MANAGE BASKETMOUTH TAKE ENTA LINDA IKEJI BEDROOM?(foto)

Na thru play play some pipo take turn player.
Joker no be only pesin wey dey talk joke.
Joker can be somebodi best sikrit.
Shuo! So Linda Ikeji get best sikrit wey we nor know?
Wich show naim Basketmouth oganize for Linda Ikeji bedroom wey be say na only ham naim attend?
We don see Linda Ikeji dey pose for dis her bed for sometime now since she pack go her new haus for banana island.
Wetin Basket and Linda don sign wey Basket take go siddon for di same bed?
Maybe na dia be her new sitting room for visitors.
Shuo! So married men dey allowed to dey go play ten ten for Linda bed?
Basketmouth imsef naim even put dis pishor for Facebook and he kon write on topam say make nobodi askam wetin him dey do for di tori queen bed.
No wahala,I go try join tori pipo to find out wetin dem get togeda.
If Linda nor tell me hersef,Laura her junior sista,go nack me di tori of wetin dey pipeline.
Check back later make u know how far I don go.

Sunday 22 November 2015

EYAH!! PHOTO OF A GIRL WEY DEY SELL GROUNDNUT FOR ROAD SIDE AND DEY DO HER SCHOOL HOME WORK

Make Baba God blessings no pass dis girl by as she just show us say make pipo stop to give us rizins why dem dey sell dia bodi for money or sell igbo for strit.
Dis geh wey u dey see for dis pishor so,dey sell groundnut but still rememba to carry her books follow bodi just to do her homework wey tisha givam for school.
Baba God abeg as you dey bless me,nor forget to bless dis girl join too bicos dis kain tin wey she do so,go inspire full kontri to resiv sense.

BREAKING NEWS!!! APC ABUBAKAR AUDU DON DIE A DAY AFTA HE CONTEST FOR KOGI GOVERNOR ELECTION

Di man wey fly APC flag for di election to bicom govnor for Kogi election,Abubakar Audu,don die akordin to tori wey just enta our yard.
Akordin to SaharaReporters,dem say Audu die of sickness wey dem neva too dey sure of.
Di man die afta INEC anounce say,dem go stil re-arrange election for dome kain area wey dem feel say wuruwuru and magomago dey bifor dem go kon announce di full result.
Although,most of di result wey don alreadi come out,show say Audu bin dey lead PDP flag bearer,Wada Idris for di election as some pipo don even anounce say Audu don win bifor dis bad news kon enta town.

NA WA O! HAPPY 'BIRTHDAY' DON TURN 'NAKED DAY' TO MAHEEDA

Crazy chick and bad gal,Maheeda don troway anoda naked pichors to take celibrate her birthday today.
Anybodi wey say he undastand wetin dis geh fit do di next minute dey lie.
Even misef na me fest run carry news of Maheeda di gentle geh wen di babe reliz some matured pichors.
For dose pichors she gentle finish,you see!
How I won take undastandam wey be say on her baiday she don sampo evri evri.
Di one wey I know be say,wen pesin won celibrate baiday,di pesin go find new koret clothes wear but for Maheeda case,di more u look,di less u see.

Saturday 21 November 2015

ONE DAY NA ONE DAY,I GO BE NAIJA PRESIDENT-BRYMO

Forma chocolate city artiste,Brymo,don yarn say him like to rule naija one day too.
He yarn dis one wen NET intaviu ram.
Brymo make I tell u in case u dey feel say na only u get mind to rule,na lie u lie bicos many pipo wey dey sleep unda bridge get mind too.
Crowd don dey say if Oga jona wey nor get shoe fit rule,why dey demsef nor go rule too?
During di intaviu wit NET,Brymo yarn say him get mind die to rule dis kontri one day bicos him get a lot to offer but di only tin wey dey draw am back for now,na univasiti wey him neva go.
Although sha,di bobo say him go soon work on dat side of him life.
Brymo bin don dey study zoology for Lagos state univasiti,LASU bifor he kon stop to face him miuzik career.

Friday 20 November 2015

WAIT O! NOR BE CONTACT LENS SEAN TIZZLE WEAR FOR EYES SO?(Foto)

Wen craze won start,e dey come in differen forms.
If dis pishor wey i dey see for Sean Tizzle Instagram page na true,naim be say,na to carry di bobo go wia dem dey trit mad pipo for Uselu.
Dem don cure many pipo wey dey mad for dia.
I nor know weda na contact lens di guy fix for him eyes or not but judge for yorsef bitwin dis old pichor and di one wey look like contact eyes.

Even sef,as I dey write dis tori na di pichor e stil take do him profile pichor for Instagram.
So you fit go dia go checkam out for yorsef make he nor be like say I dey blow lie.
As una dey checkam,make i go Uselu bus stop go dey wait una,just in case.

DAVIDO PAPA DON DIVORCE HIM NEW WIFE AFTA TWO YEARS OF MARRIAGE

Na only God naim know wetin Davido step mother do wey make him papa,Doktor Deji Adeleke put full stop to dia marriage.
Billionaire business man,Dr Adeleke and him wife marry for only two years bifor dia love hit rock and as we dey yarn like dis,di divorce mata dey court.
Tori pipo don dey try know wetin cause dis kasala but e neva stil clear.
Although sha some family membas don confamam say true true say two of dem don waka separate but dem stil dey hide wetin di problem be.
Some days ago,Dr Adeleke oganize Thanksgiving and him wife nor dey di groove and dis one come make pipo dey wonda wia she dey dat day.
We go bring una more tori as e enta.

OH MY GASH! GIRLS ABEG MAKE UNA HEP ME CHECK DIS BOBO IKEBE(fotos)


Wetin man no go see.
Wich kain yansh dis bobo carry so?
I too biliv say many babes go jealous dis bobo.
Wetin be dis?
Shuo!
Haba!

Thursday 19 November 2015

BAD MARKET! KANO GOVMENT DON CLOSE DOWN 50 ASHAWO HOUSE


How kpomo market?
Guy,kpomo market nor bi-am again for Kano o!
Congi go kill some pipo for yonda as govment don cut rope to show dem shege.
Ashawo costomas go see pepper as dem don dey close down kpomo market(ashawo market),for dia.
Kano state gofment dey para as dem don close down 50 ashawo hotel bicos na so so small small gehs full di bizness for dia now and costomas dey gidem belle anyhow.
Nor be only dis kpomo market hotel,dem close down as di Kano State Film Censorship Board wey close dem down,also close 100 vidio game shops.
Akordin to di seketri of di board,Ismail Afakallah,he say,for one of di ashi hotel,dem diskova say na two yong gehs carry belle.
So diafor,govment no get choice dan to dey harsh for di mata.
On why dem close down dis vidio shops,he say e dey hep produce and turn small small boys to tiff and bad pikins and dem won put full stop toram.

Wednesday 18 November 2015

SEE HOW FALZ DI BAHD GUY TAKE BUY HIM OWN ALBUM WEY HE NEVA RELEASE FOR TRAFFIC

Wondament na somtin wey we nor go eva stop to see for dis world.
How sombodi go see him own album buy for traffic bifor he relizam.
Na wetin appun to Falz be dat as di bobo buy hin own album for Lagos traffic and mean why,di bobo neva relizam.
Even kpakpa sef,Falz dey plan to do di album launch tomorow for Industry Nite but as I dey yarn u like dis,Alaba boys don dey pirate craze comot for di album head wit di ones wey dem download from iTunes.
Falz later post on top Instagram how he take buy di album for hold up.
Na only God know wen dis piracy go stop.

DPR,MAKE UNA GIVE FUEL WEY ANY FILLING STATION HIDE,FREE OF CHARGE TO COSTOMAS-FG

O BOY,SEE GALONS!
Di Minista of State and Petroleum Resources,
Dr Ibe Kachikwu,don order di Dipatment of Petroleum Resources(DPR),to seize any fuel wey petrol stashon hide and givam free of charge to costomas.
He yarn dis one for wen he carry waka dey inspet filling stashons for Abuja.
He say e no good make dem dey hide fuel and make pipo dey sofa for wetin dey available.
He also yarn say dem go also ponish any maketa wey dey take naija pipo dey play ten ten bicos of dis fuel mata.
He say make naija pipo nor fear say fuel dey yanfu yanfu.
Oga Kachikwu also tell all NNPC fuel stashons make dem dey sell for 24 hours.
He say make oda major maketas do dia best to sell fuel for 24 hours since dey demsef dey do dia best to make sure NNPC wey belong to govment,dey sell fuel till daybreak.

Tuesday 17 November 2015

MAHEEDA ON HER ANODA P AS SHE ENTA "MAHEEDA DI GENTLE GIRL MODE"

If u dey follow goddess of x,Maheeda lifestyle,u go know say na lifestyle wey full of queshons.
Today she go show bobbi for Instagram.
Tomorow she go show you her g-string for twita.
Next tomorow she go show kpekus.
One day she even say she like to sleep wit forma presido,Goodluck Jonathan and pipo don dey say na yeye geh she be bicos of all dis karata wey she get.
But she just put some kain foto for Instagram and she kon write on topam say,"I'm Innocent".
Di foto dem fine and she look oganize.
If na so she be for real life,nobodi go do mistake say she be bad girl.
See more foto for hia for yorsef.....

BREAKING NEWS! BAD BOYS DON KIDNAP SAMSON SIASIA MAMA FOR BAYELSA

Coach Samson Siasia wey dey Gambia dey prepia him bois for Africa U-23 nations cup,dey veri veri sad right now as kidnapas don gbab him mama from her house for Odoni village,Sagbama local govment,Bayelsa state.
Siasia dey shock as dem call am on phone from Gambia and he dey beg dem make dem free him mama.
Akordin to pipo,di kidnapas use bike take carry her comot afta dem force dia way enta dia bunk thru di back door.
All di beg wey Samson Siasia papa beg say make dem live him wife alone,nor enta di bois ear at all.
As at di time wen we dey write dis tori,di kidnapas neva contact di family.

Monday 16 November 2015

SHOKI FEVER DON CATCH MISSY ELLIOT AS SHE GIVE DEM Di SHOKI DANCE FOR HER NEW VIDIO

For di first time for seven years,yankee miuzishan Missy Elliot don reliz new song and she call di song,"Where they from".
Missy Elliot wey take dancing as food kon even cane shoki dance for di vidio to swit naija pipo belle.
Di good tin aboutam be say,she kon tank and show aprishiation to Lagos on top twita.
No be only Lagos she tank as she also halla Lil Kesh one of di pipo wey make shoki dance popular.


Wen yankee won copy somtin from us,dem dey copy di beta one but wen we won copy from dem,we go copy orishirishi from dem.
Bicos Michael Jackson and dem Beyonce, dey cova dia pikin face wit blanket make tori pipo for nor siam,Tiwa Savage too kon dey cova her baby face too.
Atutupoyoyo karata naim be dat one.

Watch di video for hia:...http://youtu.be/uu6D_Ak2A-I

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...