MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 1 November 2015

YOU GO FEAR FEAR IF U SEE Di WAY WEY DEM TAKE CATCH Di BIGGEST CROCODILE FOR Di WORLD

Like say di popular late crocodile hunter from Australia, Mr Steve Irwin, still dey alive, trust am, he for don catch di nearest flight go Panama go play wit dis giant crocodile wey pipo don alreadi dey call di biggest crocodile ever.
Bifor dis one show face for dis kontri wey dem dey call Panama, di biggelest crocodile for di world dey measure 18 feet long and e dey weigh 2,200 pounds.
Na chicken,fish and pork meat di owner take dey feedam.
Dem even name am Cassius and na 111 years we hear say di crocodile live.
George Craig dey feed forma biggest crocodile for di world

Wit dis new crocodile wey dem catch for Panama canal so, e be like say Cassius tenure as di largest crocodile don expire.
As I dey write dis tori, dem say di pipo wey catcham for di canal don rush go buy tape for market to measure ram.
I go bring una di figures of di measurement wen dem measure ram finish.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...