MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 16 November 2015

CHOi!SEE AS FEMALE FAN WON TEAR WIZKID TROUSER FOR MALI CONCERT

Dis tin nor be di way wey u dey see bifor again o.
Di way wey dis Wizkid mata dey go now,e don dey pass be kiafu.
Almost evriwia for Africa don dey catch di Wizkid fever as many fans both bois and gehs dey aprishiate tam.
Dis one nor be weda na inglish or French dem dey speak for dis kontris.
Di tin be say dem don alreadi love di bobo miuzik.
Di last time na Ivory Coast pipo showam plenti love.
Now na Mali dem for showam love as one babe escape enta stage go grab Wizkid for leg on top stage.
Di stadium sef full finish and enjoy demsef.
How di mata won be pass again?
Min why,Wizkid don give him fans anoda latest jam wey him call Final( Baba Nla)
You fit listin and enjoy di song for hia .......http://www.360nobs.com/2015/11/music-wizkid-final-baba-nla/

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...