MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 8 November 2015

NA DEVIL BLOCK BASKETMOUTH,TIMAYA AND DUNCAN MIGHTY MOUTH NAIM MAKE DEM NO FIT APPRECIATE ME-JULIUS AGWU


Comedian Julius Agwu don yarn say many of him frends for di industri abandonam wen he no well and wen he get problem.
Some months ago,Julius Agwu battle wit him life wen he do brain operation for obodo oyibo.
He say di one wey pain nam pass na pipo wey him hep blow to bicom supastars and pipo wey him give opotuniti for stage like Basketmouth,Duncan Mighty,Timaya,Teju Babyface.
 

He also yarn say even pipo like D'banj,Banky W and Don Jazzy,naim advice dem make dem come back to naija come hussle.He say all dis pipo no even aprishiate tam for one kobo for di hep wey dem get fromam bicos devil tie dia mouth.
Since God save Agwu from di brain wahala,he don bicom born again and he even yarn two weeks ago say he go build kristian night club for God.
For dose of una wey like groove and nite club welwell and dey xpect to go dance shakitibobo,skelewu,azonto for Julius Agwu club,una dey disiv unasef bicos di bobo dey buildam bicos of kristians.






No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...