MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 9 November 2015

BUT WAIT O!LINDA IKEJI BEDROOM NA FOOTBALL FIELD?(FOTOS)


I nor undastand dis babe again o.
I bin tink say wen time don dey rish for babe to marry,she go dey plan to move enta her hosband haus.
Abi Linda Ikeji di king of tori, nor get plan to marry?
If u rememba, di malawi jost buy one ogbonge N500 milion naira bunk for banana island and she don dey tush di haus like mad.


I don dey view evri evri wey di malawi dey do concerning dis her banana island bunk.
She don dey beef up di sitting room and we see di pishor.
Di dining room sef nko? she don show us di pichors.
She don dey trim di flowers too but di one wey totori my wondament pass na her bedroom pishors wey just leak come out.
Di bedroom big like football field and beta strika dey like to dey skor for dis kain field.
Di amebor gist wey dey rich our tori table now be say,wen she marry,her hosband go pack enta di haus  bicos dis kain bedroom nor be only one pesin dey enjoy ram.
Wia i come from sha,man no dey pack follow wife bicos pipo don dey carry gist alreadi say na me go be her hosband.
Na rumors o!
I go bring una more tori wen i confam di rumors.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...