MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 3 November 2015

SURPRISE! SURPRISE! AS ADAM AND EVE DON SHOW FACE FOR LEKKI,LAGOS

Seyi Shay don start anoda one as she don snap plenti foto wey she call "corruption of eve" and na Remi Adetiba naim direct di fotografi.
Na Lekki Conservative Centre,Lagos naim be di garden of Eden dis time around and Seyi Shay naim act as Eve.
Many pipo biliv say if nor be Adam and Eve,we for dey enjoy anyhow today.
Mosquitos for no dey,sardine and geisha for be free,evribodi go get dia own bank for dia backyard,joliment go dey yanfuyanfu.
Bois don try to forget evri evri wey appun dat time and kon kontiniu to take life jejeli bifor Seyi Shay kon reliz dis fotos to take remind pipo of wetin Adam and Eve cause.
Well God dey.
Dem even showcase dis foto dem for di 2015 Lagos Photo Festival.
See more fotos for bottom hia.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...