MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 15 November 2015

I NOR QUICK KNOW SAY,SAGGING NO SOPPOSE DEY MY DICTIONARY-NAETO C

"God I tank u oooo......I nor know why e take me long time to know say sagging na bastard."
Dis na all wetin come out from Naija miuzishan,Naeto C mouth.
E remain Davido and di rest of dem wey carry sagging for head like lakpalakpa to know say sagging no dey reign again.
Naeto C yarn say him dey sag welwell bifor but as he dey grow,he kon find out say na yeye tin to dey sag.
Di 10 ova 10 singa say,wen he small,he no care about di kain eye wey pipo take dey lookam but now evritin don change.
Di bobo na sagging born again.
Now he fit pour u hot water even tho u won giam one million just to sag.
Naeto C say him costoma na mature sombodi wey like to dey giam bizness and na dis kain pipo him dey paform for.
He also say,if u kontiniu to dey sag and u go meet dis same pipo for bizness,dem fit look u wit small pikin eye but now him don mature and sagging don comot from him dikshonari.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...