MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 13 November 2015

AFTA 30 DAYS FOR ATLANTA,AY DON READY TO RELIZ ANODA NEW HOME VIDIO "A TRIP TO JAMAICA"

For dose of una wey dey hapi as nollywood dey grow,God don bota una bread again wit anoda wicked home vidio "A trip to Jamaica".
Ayo Makun,if u like call am AY di comedian,wahala nor dey.
Afta di bobo enta di industri wit "30 days for Atlanta" di film wey win ogbonge awards for home and abroad,AY don readi to reliz anoda one..'A trip to Jamaica'.
Nor be Jamaica?dem nor dey use dia leaf chocolate take play for yonda.
We go see Akpos for Jamaica,but weda he taste dia chocolate or he hide Kwale chocolate from hia go yonda,we go know.
Apart from Bob Marley,di life of many pipo wey taste Kwale chocolate nor dey remain di same afta dem taste tam.
AY borrow some Hollywood actors like Eric Roberts,Dan Davies take act for di film.
Also,anoda big name wey show face for dis home vidio na Paul Campbell aka Capone,dat baddest nigga wey act for third world cop,di ogbonge Jamaica film.
Oda pipo wey show dia jersey nomba for dis film na Chris Attoh of Ghana,Naija representas Nse Ikpe Etim,Raskimono,Pato Ranking,Cynthia Morgan,AY(akpos) and him babe,Funke Akindele wey her name na Bola for di film.
Pipo don alreadi dey hurry to watch dis film as e dey hot,di only tin wey dem dey wait,na wen e go enta cinema and market.
Check out more foto for bottom hia:


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...