MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 2 November 2015

SEE FUEL PALAVA AS WOMAN WEY CARRY PIKIN FOR BACK GO FETCH FUEL FROM TANKER WEY FALL(FOTOS)


Devil fit siddon e own jejeje dey find wetin he won chop and pipo go dey blame di guy for wetin he no know about.
Dis one na case of yanga dey sleep,trouble won wake am.
E be like say pipo don foget wetin appun for Jesse for Delta state some years ago wen pipo wey go fetch fuel for bust pipeline die like fowl full ground.
For dis foto,wetin u go talk about dis woman wey carry pikin for back and join go pack fuel from tanker wey fall for Mowe Ibafo last weekend?
Any small fire for dat place,evribodi don quench be dat.
We know say na wetin poverty dey cause all dis nonsense but if she won die,why not die alone and live dat inosent pikin for haus?
Dat pikin can be future comishona,dat pikin can be future senator,dat pikin can be future president,dat pikin fit stil get many tankers for future.
If die hungry anybodi,make e no draw anoda pesin folow bodi.
Die yor die alone.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...