MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 16 November 2015

SHUO!NA BAD TING IF SOUND SULTAN WEAR ONE BOXER FOR TWO MONTHS?

SOUND SULTAN POSE FOR SEYI SHAY GROOVE
SOUND SULTAN FOR STAGE FOR 2BABA GROOVE
I nor know why some pipo no sabi mind dia bizness,shuo!
U know di latest tori for town now?
Dem say e be like say Naija ninja,Sound Sultan don sell him oda suits take buy one wine black jacket and na dis jacket he dey wear go all okayshon.
Amebor pipo say he wear dis wine jacket go 2face 40years old betday konsat for Eko Hotel on septemba 20,2015.
Two days ago,for di same Eko Hotel,he wia di same wine jacket go follow Seyi Shay jolificate for her album launch.

Di only diferense be say,he nod bow tie for Seyi Shay groove tinking say pipo no go know but dis yeye pipo stil know.
I nor undastand naija pipo at all.
Nor be wetin pesin get he go wear?
Sound Sultan nor mind dem jare dem no get work.
But sha,u sef Sound Sultan,u soppose try pass like dat.
As a celibriti or anybodi wey be star,di pesin soppose get plenti jacket for differen okayshon so dat amebo pipo nor go carry yor mata for head.

Abeg, make yor check hia for di next tori......http://ogakpatakpata.blogspot.com.ng/

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...