MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 30 April 2015

AYIRI CELEBRATE 40 YEAR OLD BIRTHDAY WITH STYLE


Last saturday for Warri,home boy and billionaire,Ayiri Emami,di Akulagba 1 of Warri,celebrate im birthday wit style as he dash free kerosine and fuel to pipo.
He also commishon him gas station and  hin 911wackis joint.
Pipo wey dey there to nice up di birthday groove na Timaya,Bovi,Solid star,Harrysong plus him wife and shidren.
Check more pichors for bottom hia:


SOME PIPO WEY COLLECT FREE FUEL AND KEROSINE

OBAMA SENIOR BRODA,MALIK,SAY OBAMA BAD PASS PHARAOH


Malik Obama say him junior broda,Barrack Obama bihavior and karata dey get worse evriday by day since he bicom US president.
He say Obama no send weda him family pipo dey exist for Kenya.
Malik say,wen dia auntie,Zaituni,die for America,Barrack Obama no drop shishi to take transport di dead bodi back to Kenya bicos he say di transport too cost.
He say,he take dem one month to gada di money to carry her dead bodi go back to Kenya.
Malik Obama yarn all dis for one intaviu wit Joel Gilbert,di director of di film,"Dreams From My Real Father".

He say Obama mata don tire dem reach neck bicos he wicked pass nebukanezzar.
He say time don reach to find out who Barrack Obama real papa be sef, bicos, naim him step fada,Frank Marshall Davies character he carry.
He say him dey veri veri diasapointed wit Obama and he don notice all Obama yeye bihavior espeshally di way wey he treat him and dia late auntie,Zaituni,from di veri fest time wen dem  won swearram enta as he win election for 2008 to bicom di world most powerful man.
He even yarn say,anytime wen he won visit Obama for White House,na thru back door or nite dem dey allowram enta.
Di last tings wey Malik Obama yarn for di intaviu be say,him no expect to see him step broda,Barrack Obama as di America Presido dey prepia to visit Kenya for July.
Barrack Obama papa na from Kenya why he mama,Stanley Ann Dunham, na America woman.

Wednesday 29 April 2015

SAMPLE! BUHARI AND OSINBAJO DEY SHACK TEA WITH N35 MILO


O boy una dey see wetin my eyes dey see for dis pishor wey di new Presido Muhammadu Buhari and our Vice Presido Yemi Osinbajo dey so? Check dia table well, u go see milo for inside one plate for kona.
A whole President dey drink tea wit N35 MILO?
Yahoo bois sef no go green make tea for dia dog wit N35 milo.
At least we no go dey hear, 2 billion for a year budget for only rice and beans for Aso Rock again.
Pipo don already dey say, e be like say di forma khaki head of state na di pipos president as e no get time to do like big man.
Even di house wey Baba dey stay be like ordinary pesin house bicos he simple finish.
Dis one wey be say na evri two two weeks fuel dey scars for naija and NEPA dey one corner dey craze dia own,we hope say e go do somtin about am since pipo don already dey say he no like corruption.
Anyway I go siddon dey watch di president and evritin for naija to know weda tins go dey beta afta Buhari don take over from may 29.

Tuesday 28 April 2015

GRAMMAR KING,PATRICK OBAHIAGBON SAY WAEC SEIZE HIM RESULT TIRE



















Di king of big big grammar wey dey shake pesin brain foundation,Honourable Patrick Obahiagbon,don yarn say West Africa Examination Council,WAEC,take am play tire so tey he kon dey para.
Wen Punch newspaper askam weda him use all dis big big grammar di time wey im dey go skul,di Benin Chief say,yes o.
He say im use dem welwell for secondary skul and even univasiti.
He say infact,WAEC seize him O' level English language result three times but dem dey always dey release di oda subjects.
All dis time,him bin pass JAMB twice but WAEC no allowram enta univasiti bicos of di English wey dem dey seize.
Na di third one wey im do naim WAEC kon release.
Patrick Obahiagbon na di current Chief of Staff to Edo State govnor,Adams Oshiomole.

Saturday 25 April 2015

NOLLYWOOD ACTRESS,CHIKA IKE SAY,NO MAN DON TOUCH HER WEBSITE FOR 5MONTHS


We no know wia di world dey face nowadays.
Wen naija miuzishan and writa,Etcetera talk am for im miuzik,"going crazy on twiter" say pipo don dey mad for twiter,we no take am sirios.
At di end of di day all wetin di guy yarn 3 years ago naim dey appun true true.
Pipo go wash clothes for house,dry am for twitter,
pipo go eat suya and beans dem go talk am for twitter,dem go buy okrika dress dem go talk am for instagram,dem go buy brassier for market dem go yarn about am for facebook,
Dem go shave dia armpit dem go talk am for instagram,
Abi we don dey mad ni?
Wetin you go call wetin nollywood actress,Chika Ike post for instagram?
She write say,"Bobos,e no easy o...five months na,
no man don touch her or play near her website.
she say she go jump enta bed go grab her pillow"
Na evritin we must talk about?
If u and yor wife do kerewa for bedroom,must u come talk am for facebook?
Wetin sef world pipo!!!!!!!!!!!!!

Friday 24 April 2015

END OF THE ROAD?CHELSEA WON FORCE SOUTHAMPTON TO BUY MIKEL OBI


Chelsea don dey plan to offload Mikel Obi to Southampton so dat dem go fit buy dia strikar,Morgan Schneiderlin wey Southampton don put Ogbonge price of 25million pounds for him head.
Oyibo pipo say wen pesin caria don dey nosedive,dat is to say,
wen dem no too value u too much again,dem go use u dey play'
dem go use dey play kalokalo.
Di way wey di mata be now,Mikel be like carrot wey dem take dey bribe rabbit so dat dem go catcham and na wetin Chelsea dey try to do so dat dem go catch dia target,Morgan Schneiderlin.
Anoda club wey dey try to kolobi Schneiderlin since last year,na Arsenal.
Anyway,me I go siddon for fence dey watch who go buyam at di end of di day.

OFFICER DON MAKE ONE MAN BUSS CRY FOR KENYA AS GOVERNMENT NO GIVAM POLICE JOB BICOS OF TRIBE


Police recruitas for Kanduyi,Kenya don take back admission letta from one man bicos of him tribe.
Di man,Mr Mathew Rufassi don pass all di recruitment stage and dem kon givam letta to join Police Training College for Kibanjo.
But one Sinior Offisir later telam to return di letta bicos dem find out say,im na Teso pesin and na ten pipo from Luhyas and two pipo from Kikuyus naim di job wey remain dey for. As dem givam di letta,bifor he say make him dance galala to celebrate,naim offisirs call am back,Say,"wia you!,giv us di letta wey we giv you.We just find out say di job no be for Teso pipo".
Rufassi wey kon dey cry bicos of di way wey dem take turn him joy to sadness,say altho,him popsie na from Teso why him momsie na Luhya pesin but he no know any oda home pass Buguma bicos na dia dem for bornam.
Buguma Area Police Commandant,Charles Munyoli,confamam say,true true dem don withdraw di letta bicos dem dey share di jobs akordin to di 1999 population census for Kenya.

Wednesday 22 April 2015

DIRTY ENJOYMENT: GOVERNOR FAYOSE AND BURUJI KASHAMU DEY BLAST AMALA FOR BUKA


Two PDP big names wey APC dey tire for dia mata,Govnor Ayodele Fayose and Senator Buruji Kashamu,hang out for iya basira buka and dem dey blast beta amala come use moet topam.
Di tin wey surprise me pass na how di table take dey dirty bicos e be like wia pigs for chop.
Dem say cleanliness naim next to Godliness but why di table come dey nyama nyama like dis?
is it dat we no get Govnors and Senators wey neat for naija again?
Dem be leaders?
If yes,were di examples wey pipo go follow?

JONATHAN DON GIVE HIMSEF QUIT NOTICE FROM ASO ROCK


Like tenant wey landlord give two weeks quit notice,President Ebele Jonathan don give imsef quit notice so dat Julius Berger go fit carry out renovation work for Aso Rock bifor di new Presido,Muhammadu Buhari and Vice Presido Yemi Osinbajo go take over di yard.
Akordin to one sombodi for Aso Rock,na two weeks dem give Julius Berger startin from next week to complit di work.
Di sombodi, also yarn say,if dem follow di plan,uncle Jona go pack go di glass house wey no far from di place wia im be dey stay so dat Julius Berger go dey do dia work dey go. 
Also,akordin to tori wey dey reach our office,di only miuzik wey dem dey play for Buhari house now na, "Enter di Place" by 2face Idibia as di General don ready to pack 'enta di place' wey dem dey call Aso Rock for di next four years.
President Jonathan don alreadi start to dey pack im load afta INEC anounce Buhari as di wina of di 2015 presido election.
INSIDE ASO ROCK

For di biginin of dis month,pipo see many bus wey carry plenti load dey comot for Aso Rock afta di  election.
More investigashon show say di Federa Govment don complit renovation work for di Defence House wey dey Maitama district for Abuja and na dia, Buhari and Osinbajo go camp put fest bifor dem go swear dem enta govment for May 29.

Thursday 16 April 2015

SEE SOME TING..RONALDO AND MESSI GO PLAY FOR Di SAME TEAM

Footbol fans for all over di world, una fit drink one cold pure water now to cool una mind bicos una prayer don get answer as Ronaldo and Messi go play for di same team against anoda team bifor di end of di year akordin to di oganizas of di match.
Dis two footballers wey don take skorin of  goals to anoda level,go play for UEFA All Star match wit oda ogbonge stars wey base for Europe.
Akordin to one newspaper for Spain, Mundo Deportivo,two of dem go play for 'Team South' wey go include stars from La Liga, Italian league and French league and dem go play against 'Team North' and e go involve players from England, Russian league and Germany Bundesliga.
Akordin to di tori wey we gada, di compini wey dey market dis match don yarn UEFA evri evri about di match but na di date and were dem go play di match naim dem get to confam. 

Wednesday 15 April 2015

HALLELUYAH!!! TERRY G DON CUT HIM DADA TROWAY

TERRY G - new hairstyle
Di wind of change don blow reach di house of naija craziest miuzishan and di akpako masta,Terry G, as di bobo don give up hin dada for low cut.
Terry G,di bobo wey dey pafom wit plenti energi anytime he dey on stage,shock evribodi for intanet wen he sample him new look as he don clear di load comot from him head.
Anoda tory wey Terry G yarn us bifor be say,he don stop to smoke igbo but dat one naim i no fit garantee weda pipo biliv.
Seeing as dem talk am is beliving.
You don see hin new hair style but you biliv say, Terry G don stop to smoke trees?

Tuesday 14 April 2015

SEE WETIN TONI BRAXTON WEAR GO GROOVE WITH HER CHILDREN

Dem realy talk am say if yeye won smell e dey smell finish.
America singa,Toni Braxton attend UNCF evening groove wey dem organise for stars wit her two bois shidren,Denim and Diezel on sunday April 12 for inside Atlanta,Georgia.
Di kain see tru dress witout bra wey she wear naim kon tire pipo as dem dey wonda say as mama weda she supose dress like dat.
Make i no yarn too much.
Check out di pichors for yorsef.
You go happy if yor mama dress like dis?





DAVID TAM WEST SAY BUHARI GO REDUCE FUEL PRICE TO 40 PER LITRE


Forma minista for Petro mata,Tam David West,don tell Naija pipo say, dem fit sleep wit dia two eyes close and expect jolliment bicos him biliv say new presido,Buhari go reduce price of fuel from 87Naira to N40 wen he start work from May 29.
He yarn dis one wen vanguard call am for telefone to talk for some kain mata wey concern us.
He say forget mata for mathias,no shakement bicos hin no wetin Buhari go fit do. 
Tam West wey be petro minista unda Buhari khaki regime for 1984 yarn say, di new presido go bring fresh confidens to di oil industri and he also yarn say baba na strait forward pesin bicos im know am like di back of im leg.
Di forma Oga for petro mata say Muhamedu Buhari go build new refanaries make fuel and kerosine for dey yanfuyanfu for poor pipo to use bicos no beta govment go like to dey see di pipo dey suffa.
David Tam West say no need to look far bicos naija get all wetin dem need to make life beta.
Anoda tin wey im yarn be say e don tey wey Buhari dey tell evribodi say hin nor won hear subsidy mata for him ears.

Thursday 9 April 2015

CRISTIANO RONALDO DON SCORE 300 GOALS FOR REAL MADRID IN 7 YEARS


If player skor 20 goals for one season for him club bifor,na big achivment but di level wey Ronaldo and Messi don take di skorin of goals mata reach,don pass be careful. 
Dis two football wizard dem dey skor over 50 goals evri season for di past five years.
Just last night for di match wey Rayo Vallecano and Real Madrid play,Ronaldo skor im 300 goal for Madrid out of 288 match wey he don play for di club since he join dem for 2009 from Manchester United.
Di club of forma Super Eagles goalkeeper,Wilfred Agbonivbare wey die of cancer for january,Rayo Vallecano,no get answer to Ronaldo goal for di 68minute as he nod Dani Carvajal cross enta net.
Just on Sunday here,Ronaldo skor five goals for one match as Real Madrid beat Granada 9-1.

Di TING WEY TINUBU TALK ABOUT OBA OF LAGOS AFTER HE YARN SAY IBOS GO PERISH FOR LAGOON


Naija new President,Muhammedu Buhari,don beg Igbo pipo make dem forgive Oba of Lagos,Oba Akiolu Rilwan,afta im misyarn say any Ibo Pesin(Omoibo) wey no vote for APC and Ambode as Govnor for Lagos,go perish for Lagoon.
Buhari yarn dis one on tuesday wen he visit Lagos for APC rally.
He say make dem forgive di Oba make peace for reign. 
Anoda pesin wey yarn for di rally na former Lagos State Govnor and APC national leader,Bola Tinubu.
Tinubu say make pipo forget wetin dem write for motor bodi enta motor, bicos di Oba yarnings nor represent dem bicos him no be APC memba.

Tinubu also yarn say naim be di fest yoruba govnor wey apoint Ibo man as comishona for Lagos.
He say since PDP loose di president election to APC,dem don dey yarn dust just to drag APC name enta wetin di Oba talk so dat e go affect Ambode make he for loose di election.
He say Ifeanyi Ubah and anoda big name for PDP Bode George,no know wetin dem dey talk.
Jagaban,di nickname of Bola Tinubu also talk say,wetin Ifeanyi Ubah go do for Oba Akiolu palace in di fest place?
He say weda di Oba na politician?He say di Oba role na to unite all di parties weda na PDP,APC or even sef SDP.
He also ask Igbo pipo one question say,"Govment no dey pay dia shidren school fees join for di free education"?
Di forma govnor say one spelling competition wey dem do one time na Ibo boy,Ebuka from Anambra state naim win and dem sendam go Switzerland computer shool and also Obafemi Awolowo Univasiti.
No be only dat one Oo, as Ebuka also rule Lagos for one day as Govnor. 
He also talk say dis Ebuka kon later bicom executive for Oando and he dey Canada now.
He say even sef,na Ibos naim win di spelling competition three straight times.
He say anoda boy,Felix also go Switzerland and OAU and dem no deny am him scholarship bicos say him na Ibo boy.

Thursday 2 April 2015

DAVIDO AND WIZKID REALLY DON SETTLE DIA QUARREL AS TWO OF DEM WEAR Di SAME CLOTHES

Wen Bob Marley sing say your worst enemy can be yor best friend, and yor best friend fit be yor worst enemy,pipo feel say na Kwale Igbo(marijuana) he smoke dat year.
But today now, Naija Supastar miuzishans, Davido and Wizkid don show say di King of reggae no sing dat song troway as Davido don post pishor wey im and Wizkid for wear di same clothes. 
Two of dem kwanta bin pass cat and rat own bifor but last year naim dem finally decide to turn friends again.

See di pishor for bottom hia:



LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...