MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 31 December 2018

SHAGARI PIKIN 'BALA SHAGARI' DON YARN SAY,BIFOR HIM PAPA DIE ON FRIDAY,HE FORGIVE BUHARI EVEN THOUGH OGA BUHARI SHOW AM PEPPER FOR 1983


If you dey follow up, you go rememba say na President Buhari as Sojaman dat year naim porshoe Alhaji Shehu Shagari comot for govment for 1983.
Bala wey be di sinior son of Alhaji Shagari wey be naija presido from 1979 to 1983,don come out to tell di whole world say,him papa forgive Buhari and otha pipo wey offend am bifor he die on Friday Disemba 28,2018.

Sunday 30 December 2018

NOLLYWOOD BIG FISH 'OMOTOLA' DON YARN TORi PIPO SAY,TIME DON REACH FOR WOMAN TO RULE DIS KONTRi


Biutifu nollywood actress Omotola Jalade-Ekeinde don yarn her mind say,Nigeria don readi for woman president.
She yarn dis one ahead of di general elections wey dem wan do next year.
Omotola say,if you dey follow up you go see say,most women dey do well pass men nawadays for dia bizness and dem also dey manage both house and did bizness veri well.
No be bad talk sha but di only ting be say,we neva know di year wey dat one go appun.

Saturday 29 December 2018

THE NEWS WEY DEY REACH OUR TORi ROOM BE SAY,DEM SAY DAVIDO GIVE KIZZ DANIEL MANAGER DIRTY SLAP FOR HIM SHOW JUST BICOS HE ASK WEN KISS DANIEL GO COME OUT ON STAGE


Wetin Kiss Daniel manager Tumi Lawrence expiriens for Davido show on Thursday night,na one wey he go like to forget in a hurry.
Akordin to di tori wey come out on top sosha midia wey di manager confam too,him offence for backstage na bicos he ask wen dem go call Kizz Daniel come out to pafom.
Bifor he go ask finish,Davido and him gang don givam hot dirty pepper slap wey make am see stars.
Afta evritin wey appun dat nite,Kizz Daniel kukuma no come out to pafom for Davido show last nite.

Thursday 27 December 2018

191 POLICEMEN DON RUN LIVE DIA WORK BICOS DEM SAY DEM NO GET POWER TO FIGHT BOKO HARAM


You go blame di 191 policemen wey take off live dia work afta dem say dia pawa no rish to fight Boko Haram.
No be news again say 191 prefa to link up wit dia familis than to allow Boko Haram take dem play kalo kalo.
Nobodi won die live him famili bicos of Boko Haram espeshali afta many sojas don hear nhwi for Boko Haram boys hand.

Tuesday 25 December 2018

STARBOY WIZKID DON TELL FANS SAY,HIM BEG DUNCAN MIGHTY TO ALLOW AM JOIN SING DIA OGBONGE SONG 'FAKE LOVE' WEY SKATA EVRIWIA


Wizkid don clear tori pipo say,naim beg Duncan Mighty say he go like to be part of dia ogbonge song 'fake love' wey dem sing togeda.
if you dey follow up,you go know say dat song turn naija upside down as e rili rili reign.

Sunday 23 December 2018

NIGERIA LABOUR CONGRESS NLC, DON CHOOSE JANUARY 8,2019 AS THE DAY WEY STRIKE GO START SINCE GOVNORS NO WAN INCREASE WORKERS SALARY TO 30K


Di Nigeria labour congress NLC don fix January 8 2019 as di day wey fresh strike go start since our gofnors say na 22,500 dem fit pay workers instead of di 30k wey NLC say dem must pay.
Na wa o.
Na so 2019 won take start?

Saturday 22 December 2018

IMO STATE GOVNOR ROCHAS OKOROCHA DON TALK SAY,NOBODY GO FIT STOP AM TO BECOME PRESIDENT FOR 2023


Imo state gofnor Rochas Okorocha don warn him enimies say,dem no go fit stop him plans to become president for 2023.
From wetin we gada,na pipo like APC chairman Adams Oshiomole he dey follow yarn.

Thursday 20 December 2018

JUST LIKE ATIKU,AMERICA DON ALSO BAN NAIJA SINGA 'RUNTOWN' NOT TO TRAVEL ENTA Di COUNTRY AGAIN


Mr Runtown wey him miuzik 'Mad over you' skata evriwia two years ago,don enta America bad book bicos of di sin wey him broda komit.
Sometime ago,Runtown forma oga,Eric Manny' bin arrange Visa for him and him broda to enta America for mizika show.
Afta di Visa expire, Runtown broda no gree comeback to naija meaning say,he dey stay America illegal.
Na di same Eric Manny report di mata give America immigration bicos dem dey quarrel for some time now and now dem don ban Runtown not to near dia kontri bicos he fit run too like him broda.
Runtown find out say dem don ban am afta him and mama go America embassy go look for Visa to enta Yankee.
De pesin wey tell us dis sikrit na di General manager of Eric Manny entatayment kompini,Johnson Adumike.
Johnson also yab Runtown say,dem no dey bite di fingers wey put food for ya mouth wen you dey hungry.

Wednesday 19 December 2018

WETIN PESIN NO GO HEAR FOR NAIJA ... AS PIPO FOR MAIDUGURI,BORNO STATE DON DEY BEG NEPA MAKE DEM STOP TO GIVE DEM 24 HOURS LIGHT




One man meat na anoda man poison,Na so dem talk am da year.
Why crowd don shout tire say dem need 24 hours light for dia house,some pipo for Maiduguri Borno state don dey vex for NEPA say dem no want 24 hours light.
Dia reason be say,NEPA won use bill kill dem.
Some say dem dey go work and dem no need di light for 24 hours bicos nobody dey use am if dem go work.
Dem say 24 hours light na waste and Na dia pocket dey sofaram.
Di ting be say na di old meter dem still dey use and weda you use light or you no use NEPA go still use high bill stone you.
I for advice dis Maiduguri pipo make dem gada dia brain and tell NEPA to provide dem wit Prepaid Meters so dat if you no dey house your meter no go read as far as you off evritin bifor you comot.

Monday 17 December 2018

TATTOO DEY LOOK VERY DIRTY ON DARK SKIN PIPO BODY AND ACCORDING TO NOLLYWOOD ACTRESS 'AMANDA EBIYE', NA Di REASON WHY SHE HATE TATTOO BE DAT



Akordin to Nollywood actress Amanda Ebeye,wen dark skin pesin draw tattoo for bodi,di ting dey look dirty on dia skin.
Amanda wey be popular face dat year for 'Super Story,Clinic Matters and other top nollywood movies yarn say,na di reason why she no fit draw tattoo for her bodies be dat bicos she be dark skin girl.
She say tattoo on light skin pipo bodi no too bad but no be for pipo like am.

Sunday 16 December 2018

RADIO AND SOCIETY BABE 'TOKE MAKINWA' DON TALK SAY,MAKE WE NO DECEIVE OURSELF,LOVE NA OJORO AND BIG SCAM SO DIAFOR,ALL OF US NA SCAMMERS



Radio voice and sosaiti babe Toke Makinwa don yarn tori pipo say,love na big scam.
Base on say na scam,all of us na scammers.
Abeg,make sombodi epp me tell her,me I no dey among di scam gang.
My love na real.

Saturday 15 December 2018

NAIJA SINGA 'SOUND SULTAN', DON YARN TORi PIPO SAY,NOTHING FOR DIS LIFE GO EVER MAKE AM GROW BIA-BIA FOR FACE




If you dey wonda why di 'solve mathematics' singa Sound Sultan no dey train bia-bia for face,no need to wonda again as di bobo don yarn us say,na God blessam wit baby face.
He say although sha,hair neva grow for him face since dem born am but like say hair dey grow for him face he for no allowram.

Friday 14 December 2018

THE MINISTER OF LIGHT MATA FOR NAIJA 'BABATUNDE FASHOLA' DON TALK SAY,NO BLAME FEDERA GOFMENT IF YOU NO GET LIGHT INSTEAD,BLAME Di PIPO WEY JONATHAN SELL NEPA TO


Minista of light mata Babatunde Fashola don yarn tori pipo say,di pipo wey forma presido Goodluck Jonathan sell NEPA to naim we sopose to blame for light wahala.
He say since no be federa gofment dey kontro NEPA again,we sopose shift our blame to pipo wey buy NEPA.
He also yarn say, no be say di mata no konsan dem at all,at all again o,but pipo wey sopose carry di main blame na kompinis wey our light mata dey dia hand.

Thursday 13 December 2018

POLICE FOR GAMBIA DON DEY LOOK FOR DAVIDO AFTA HE SKATA Di LIPS AND USE GLASS CUP BREAK GAMBIA FOTOGRAFA HEAD


Dis Davido go enta prison one day if he kontiniu wit dis him karata of fighting and oppressing pipo.
Davido bin go play show for Gambia last wikend and now Gambia police don declare di guy wanted afta he use strong glass cup skata di lips of dia popular fotografa,Kenny Egbuke.
Di glass also break di fotografa skull.
All Dis one happen afta one babe beg to take foto wit Davido.
Afta sometime Davido para for di geh and pusham comot.
Dis one non make di fotografa dey advice Davido say he neva rish dat level.
Na once David vex use di glass cup wey he dey him hand damage di guy lips.
Many miuzishans around di world dey serve jail terms.
Vybz Kartel from Jamaica dey serve life imprisonment, Six9ine America supastar dey prison dey regret him bad behavior and many others.
Davido beta be kiafu.

Wednesday 12 December 2018

ONE OGOJA MAN FROM 'CROSS RIVER' WEY DEY STAY 'ELEME,RIVER STATE' DON KILL HIM FOUR CHILDREN,BURN HIM HOUSE DOWN AND ALSO KILL HIMSELF




Bad news no dey sweet for belle but e no get how di world fit take escape am.
One bad news hit Eleme Rivers state afta one man kill him four shidren and later hang imsef die yestaday.
No be only dat one as he also burn him house join.
Dis sad news appun around 1a.m for Alesa kominiti for Eleme.
Di man also nearly kill him wife but di wife eskape as he start to shout make pipo epp her.
Di man na Ogoja man from Cross River state but he dey stay Eleme.
Weda na hunger or frustration naim make am kill imsef and him shidren,na wetin we dey try to find out.

Monday 10 December 2018

TORi GUY 'AYO JAGUDA' DON TALK SAY,IF ANYTHING HAPPEN TORAM,MAKE DEM HOLD DAVIDO AFTA DAVIDO SAY HE GO SHOW AM SAY JAGUDA GET OGA


Tori bobo 'Ayo Jaguda' don cry give di world say,if anything appu toram,make dem hold Davido afta he threaten am say,if he enta Nigeria he go show say Jaguda get oga.
Ayo offence be say,he blast Daido new music 'Wonder Woman' as nonsense and dis one kon vex Davido.
Ayo say he don alreadi tell him lawyer say Davido say he go givam wahala if he enta Nigeria.

Saturday 8 December 2018

REEKADO BANKS DON ANNOUCE SAY,HIM DON LEAVE DON JAZZY RECORD KOMPiNi 'MAVIN RECORDS' TO FACE NEW CHALLENGES



New plans,new life,new challenge,na wetin Reekado Banks don tell him fans to expect afta he announce say him don live 'Mavin Records' di miuzik konpini wey dia oga na Don Jazzy.
He write one swit leta to take thank Don Jazzy and other record label mate.
As at wen we enta our tori room,Don Jazzy imsef neva say anytin konsaning dis mata.
Good luck to you Reekado Banks on too ya future waka.

Friday 7 December 2018

'JUNE 12' DON FINALLY BECOME THE NEW DEMOCRACY DAY FOR NIGERIA AND 'PUBLIC HOLIDAY' FOR OUR CALENDAR AFTA THE 'HOUSE OF REPS' CANCEL 'MAY 29' AS DEMOCRACY DAY



Wetin I neva know for now na weda di late M.K.O Abiola wey evribodi gree say naim win di June 12,1993 president election go dey hapi for him grave now afta di House of Reps finalli approve June 12 as di new Democracy Day for Naija.
Dis one mean say,from next year,May 29 go stop to be our Democracy Day and public holiday, as dem don approve June 12 as di day wey go dey enjoy all dis medemede.
For 1993,di regime of Khaki presido, Ibrahim Babangida, bin cancel the June 12 election for no reason.

Thursday 6 December 2018

TITHE AND OFFERING ENEMY 'DADDY FREEZE', DON YARN TORi PIPO SAY,DAVIDO SABi SING PASS WIZKID AND TEKNO



If you dey follow up, you sopose don know about 'tithe and offering nomba one enimi' 'Daddy Freeze'.
Today tori no be about offering and tithe but about Davido,Wizkid,Tekno and dia singing pawa.
Freeze don come out to yarn say,Davido sing pass both Wizkid and Tekno.
Reason be say,Davido dey fit stress him voice to a point wey Wizzy no fit reach.
He say Wizkid na good singa but he dey play safe and dey fear to do new tins wit him voice but Davido dey do evritin to stretch him voice.
He also name Timi Dakolo,Praiz,Terry G as pipo wey also sabi sing pass Wizkid.
Make we kack dey watch weda dis table wey dis man dey shake go break.

Tuesday 4 December 2018

TINUBU DON REJECT TO BE CAMPAIGN OGA FOR BUHARI FOR Di 2019 ELECTION BICOS HE WON FOCUS ON SOUTHWEST AREAS


Tori wey dey reach our table right now be say,di national leader of APC, Ahmed Tinubu don reject to be campaign oga for Buhari as e take concern di 2019 election.
E be like say Tinubu no too api for di way wey dem don tritam for di party.
Akordin to di report,e be like say he won put all him attention for di Yoruba states since no be all di States dey loyal toram.

POLICE DON ARREST YORUBA SINGA 'SMALL DOCTOR AND THREE OF HIS FRIENDS' AFTA DEM CATCH DEM WIT GUN AND ALSO THREATEN TO SHOOT THE POLICEMEN



Singa Small Doctor don put imsef for wahala afta police arrest him and him friends wit gun and afta dem also threaten to shoot the policemen for road.
Dis drama appun around Oshodi area wen police pipo stop di green SUV wey dem drive.
No be di first time wey Small Doctor don enta police kpalava be dis.
Of resent during him show for Agege stadium, he shoot gun go up base on appiness and di bullet skata and injor four pipo.

Monday 3 December 2018

NIGERIA SINGA AND RAPPER 'LYNXXX' DON YARN TORi PIPO SAY, NO BE SIN FOR PESIN TO DEY SHACK ALCOHOL



If you dey wonda who dis kain yarns dey come from him mouth,him name na,Chukie Edozien a.k.a 'Lynxxx' di rappa.
Lynxxx na one singa wey be say anywia you siam, he dey always smoke cigar.
Di bobo wey claim say him na born again Christian don yarn say,to dey drink alcohol no be sin at all.
Di Asaba Delta state born rapper and singa say,di first miracle wey Jesus pafom for Bible na wen him turn water to wine make pipo shack for inside one joinbodi groove.
So diafor,him no see wia to shack alcohol don turn sin.

Sunday 2 December 2018

FORMER PRESIDO 'EBELE JONATHAN' DON TALK SAY MAKE PIPO FORGET DAT YEYE STORY SAY PDP MESS UP FOR 16 YEARS AS HE SAY,HUNGER FOR DON KILL ALL OF US IF NA TRUE


If you dey among pipo wey biliv say PDP mess dis kontri up for 16 years wey dem dey pawa, 'Goodluck Ebele Jonathan' don dey para for una o.
Akordin to di forma presido he say,if dis yarns na true,hunga for don kill all of us for dis kontri.
He even talk say make we kompia di price of bag of rice dat time wey PDP dey pawa wit di price for dis APC piriod.
Uncle Jona say PDP try for dia own time so diafor make oda pipo try do dia own too instead of to dey blame PDP upandan.

Saturday 1 December 2018

TERRY G THE AKPAKO MASTER,DON YARN TORi PIPO SAY,HIM PIKIN MAMA LOVAM WELWELL BUT SHE NO LIKE HIM SONGS



Di king of Akpako miuzik Terry G,don blast pipo wey dey drink panadol on top why he Neva marry him baby mama.
He say him love di babe and wen fi time rish dem go marry and him no know why pipo no go fit mind dia bizness.
He say even tho him neva marry her,bicos him love her naim make am givam all him bizness dey manage.
Terry G say,two of fem day dey studi wetin marriage mean,no be to jump inside.
Terry say di babe know am inside out,she know Gabriel but she no rili know Terry G.
infact she love Gabriel but she no be fan of Terry G miuzik.
Na she be di nomba one pesin wey dey telam wetin no swit for him songs.

Friday 30 November 2018

FOOTBALL FANS FOR CAMEROON DON ATTACK Di FAMiLi HOUSE OF DiA STARGIRL 'ENGANAMOUIT' JUST BICOS SHE MISS PENARiTi AGAINST NIGERIA FALCONS FOR Di WOMEN TORNAMENT FOR GHANA




Cameroon fans don take Africa football  backward afta dem go attack di famili house of dia female soccer star 'Gaelle Enganamouit' afta she miss penariti for dia semi final match for di women cup of nations against di Super Falcons of naija.
Akordin to di tori wey dey reach us,dem even dey throw stone to skata di house and dem live message give di famili say fem go come back come gidem wahala.
Too bad!

Thursday 29 November 2018

POVERTY DIE!...NA Di TITLE OF OLAMIDE NEW SONG WEY HE JUST RELEASE YESTADAY...POVERTY NA BAD THING TRUE TRUE


Olamide don release him new jam and he call am,'poverty die'.
Afta Olamide reliz some stubborn songs like 'WO and Science Student' for di past two years.
Make we dey watch weda Poverty Die go shine like di oda ones espeshali as poverty won bury pipo for dis kontri.

Wednesday 28 November 2018

17 YEARS OLD AND YOUNG GHANA ACTRESS 'MAAME YAA' DON TALK SAY,NOTHING FOR DIS WORLD GO MAKE HER FOLLOW BOY WEY NO GO FIT BUY HER CAR



Maame Yaa,di young Ghana actress don yarn tori pipo say,notin go eva make her friend boy wey no fit buy her car.
Di 17 years old babe say,she get problem wey she go like take care of like to get car and poor man no go fit buy am.
She say,evri woman deserve man wey go provide food foram, takia of am.
All dis tins na problem for poorman bicos to eat sef na problem foram.
so how he won take takia of her?

Tuesday 27 November 2018

PRESIDENT BUHARI DON INCREASE POLICE SALARY AND ALSO INCREASE DIA ALLOWANCE AND PENSION MONEY


President Muhammadu Buhari don promise to inkriz police pipo salary.
No be only dat one as dem go also inkriz dia pension and allawans money.
Uncle Buhari yarn dis one during di joinbodi meeting wey him get wit di Police Service Commission afta dem visitam for Abuja.

Monday 26 November 2018

CHIDINMA AARON OF ENUGU DON BECOME THE 2018 MOST BEAUTIFUL GIRL FOR NIGERIA AFTA SHE WIN THE AWARD FOR EKO HOTEL LAGOS YESTADAY



Chidinma Aaron don get new car,3 million plus house wey dem don pay for afta she win di  2018 most biutifu girl award for naija.
Dem do di award for Eko hotel for Lagos yestaday.
Na  Enugu she teprezent take win di award.
Some of di judges for di award Nollywood stars Mofe Damijo and Rita Dominic,Beat FM Olisa Adibua and di MCs of di day na,Ebuka and Kayla Oniwo.

Sunday 25 November 2018

FOR ASABA DELTA STATE,POLICE DON ARREST THE 14 YEARS OLD GIRL WEY STAB HER PAPA DIE FOR INSIDE SLEEP


For Cable Area for Asaba Delta state,police don arrest di 14 years old girl wey kill her papa for inside sleep.
Akordin to di tori wey we gada,her papa disiplin her for one offenand di tin kon vex her.
Wen evribodi don sleep,naim she get up stab her papa wit knife to pay back.
You dey life na you kill your papa,dat record no swit for ear at all.

Saturday 24 November 2018

DEM DON ARREST TWO STUDENT OF GOVERNMENT SECONDARY SCHOOL FOR LAFIA,NASARAWA STATE WIT GUNS


Yusuf Ibrahim and Tasiu Yusuf don enta police net afta dem catch dem wit gun.
Na di school discipline komiti katch dem and dem hand dem ova to di Nigeria Security and Civil Defense Corps.
Dem be students of Gofment Sekondri School for Lafia for Nasarawa state.
Meanwhy,di owners of di locker Abubakar Haruna and Abduo- Ruof Nora don run lost since dem dey find dem bicos na dem be di owns of di locker and drawer wia dem see di guns.

Thursday 22 November 2018

BURNA BOY AND SUPER EAGLES PLAYER LEON BALOGUN,DON DEY BEG NAIJA PIPO MAKE DEM NO BUY Di BLEACHING CREAM WEY AMERICA SELiBRiTi 'BLAC CHYNA' DEY CARRY COME LAGOS COME SELL


Super Eagles difenda Leon Balogun and singa Burna Boy don advise America model 'Blac Chyna' make she no carry her useless bleaching cream come Nigeria come sell.
Di bleaching na to take bleach your yansh and oda part of your bodi and we even hear say na 91k dem dey sell di Cream.
Burna and Leon say Black is Beautiful so diafor,you no need any kemika to take destroy your skin.
Many naija pipo don dey tell her and different top world tori pipo like BBC don carry di news.

Wednesday 21 November 2018

OBAMA DEY AMONG PIPO WEY PUSH ME COMOT FOR ASO ROCK..NA WETIN FORMA PRESIDO 'GOODLUCK JONATHAN' TALK BE DAT FOR INSIDE Di NEW BOOK 'MY TRANSITION HOUR' WEY HIM WRITE


Di 2015 election wey Buhari win don come and go but di man wey Buhari win for di election Goodluck Ebele Jonathan still dey vex for pipo wey make sure say him loose di election.
For inside di new book wey he write and launch for Abuja yestaday,Uncle Jona say,wetin Forma America presido Barrack Obama do am still dey pain.
He say Obama yarn am to him face for inside video make naija pipo choose new chapta for dia life thru di election.
Goodluck say,na only blind man no go undastand wetin he mean wit dat word.
He say e mean say make dem vote for new pesin.
As if dat one no  reach,he also send him seketri John Kerry come naija bifor di election make Goodluck no try robish as he dey plan to postpone di election.
And true true na so fear match Jona kuku leave di election timetable di way wey he take relizam bifor.

Tuesday 20 November 2018

ONE OF THE SWEETEST VOICE FOR RADIO FOR LAGOS 'TOSYN BUCKNOR' DON DIE AT THE AGE OF 37


Tosyn Bucknor,one of di veri sweet voice for radio for Lagos don kick di bucket last nite.
Her French husband of three years Aurélien Boyer, come back for work kon see say him wife don die.
Di ting send shock waves enta naija and her fans,friends, fellow workas,selibritis don dey send message of dia sadness and regret since di tori break.
Until her death,she make her name for Top radio Lagos as dia morning show prezenta.
She start her radio karia for Eko FM and do her IT wit Cool FM.
She bin dey work wit Inspiration FM Lagos presentli bifor di wicked hands of death draw her take.
Rest in Peace Area Mama.

Monday 19 November 2018

OBASANJO DON CARRY ONE JOURNALIST 'AKANDA ORO' GO COURT FOR ONE BILLION NAIRA BICOS HE RUBBISH HIM NAME AFTA HE TALK SAY,NA OBASANJO KILL BOLA IGE


Forma khaki and sivilian presido Olusegun Obasanjo don carry 'Akanda Oro' a.k.a Awikonko go court afta di man talk on top one radio program say na Obj kill Bola Ige,Harry Marshall and many oda pipo.
If you dey follow up,Bola Ige na forma Attorney General for naija.
Awikonko even talk say,make Obj swear wit Ogun juju say him no know anytin about those pipo wey die.
Obasanjo now don yarn say,di guy dey yarn puan and robish and for dat sake,him dey carry am go court to pay one billion naira for di damage wey he give he name.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...