MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 31 October 2016

3 MONTHS AFTA HE LIVE MADE MEN MUSIC GROUP(MMMG), IYANYA DON JOIN DON JAZZY MUSIC COMPANY,MAVIN RECORDS


Just wen we tink say we neva hear of Don Jazzy for sometime now,di bobo don announce one ogbonge news as he take concern hin konpini,Mavins record.
He announce on top twita say Iyanya di forma co-owner of MMMG wit Franklin Ubi,don join Mavins record.
Wit dis one,Iyanya don join up wit Tiwa Savage,Korede Bello,Reekado Banks,D'Prince,Dr Sid,Dija as fellow workas for di konpini.

Sunday 30 October 2016

OBA OF BENIN DON BAN EVRiBODi FROM DOING BURIAL FOR BENIN KINGDOM UNTIL JANUARY 2017 SAKE OF SAY DEM NEVA FINISH Di SACRIFICE WEY MAKE AM Di NEW OBA


Na  wa o.
Dis kain Africa backwardness nor be here o.
Oba of Benin don place 'no burial serimoni' ban for Benin kingdom  until January 2017 pending wen dem finish di sacrifice wey make am di new oba.
Who go pay di mortuary money of pipo wey go die inside dis piriod?
E nor get how you we do am reach,at list one pesin must die for dat kingdom bifor decemba.
All dis kain tins naim dey give Benin bad name.
Wen I say I won go back to America now una go bigin say I don start again.
For yonda I nor dey hia some kain funny tori.
No more excuse,I dey vex go dust my passport.

Saturday 29 October 2016

AFTA OLAMIDE MISBEHAVE FOR LAST HEADIES AWARDS,AYO ANIMASHAUN DON DEY WARN B4 2016 AWARDS SAY,MAKE EVRIBODi KEEP DiA TROUBLE FOR HOUSE IF NOT,DEM GO SEE PEPPER

Olamide and Animashaun
Wash night day for 2015 enta new year day for 2016,di Headies Awards take place for Landmark Event Center for inside Lagos and we watch how Olamide misbehave for live tv as him and Don Jazzy quarel for stage bicos of dia artiste.
Reekado Banks win di best new artiste and brand new car but wen Olamide go stage,he start to curse mama of di oganaizas of di awards.
He say na him boy,Lil Kesh sopose win di award and wen Don Jazzy come stage,he say if na di car dey hungry Olamide make he come carry di car.
Ahead of di 2016 award,di oganaiza,Ayo Animashaun,don dey warn evribodi say,if you love yorsef make you kip yor trouble for yor house bifor you near di veniu.
If you rememba afta dat kasala,Davido yarn on top twita say if hin boy Mayorkun nor win dis year award,him go skata evriwia.
I hope say him don hia about dis warning.

Friday 28 October 2016

CHOi! SEE AS DEM WELCOME DAVIDO LIKE KING FOR CAMEROON (Video)



Na wa o.
Naija miuzik don go far o.
No Cameroon miuzishan wey hin miuzik dey reign right now for naija but our miuzishans dey reign skata for evriwia.
Davido go Cameroon and dem arrange table foram so dat he go folow tori pipo do small joinbodi talk bifor one show.
Guy,di welcome package alone be like say Davido na president.
Oya watch di vidio for botom hia...



ONE OYIBO BABE DON YARN SAY,SHE NOR KNOW SAY GHANA NA NAME OF COUNTRY AFTER SUPASTAR AMERICA RAPPER,WIZ KHALIFA TALK SAY HIM DEY GO GHANA VERY SOON


If u come from Ghana rite now,I know say dis tori go vex u welwell bicos one obodo oyibo babe nor know wetin Ghana mean.
She nor know say na kontri name.
Afta supastar miuzishan and rappa Wiz Khalifa yarn on top twita say,he cannot wait to go Ghana,naim one of hin fan,reply am say,although she nor know wetin Ghana mean but if na babe Ghana mean,naim be say di babe dey lucky to be frend to big name,Wiz Khalifa.
Dat one na olodo woman.

Thursday 27 October 2016

AKORDIN TO TORi WEY DEY REACH US FROM SPAIN,SUPER EAGLES ODION IGHALO,FIT SPEND 2 YEARS FOR PRISON UNDA DiA LAW IF DEM FIND OUT SAY HE BRIBE TO GET DRIVERS LICENSE

Super Eagles and Watford striker,Odion Jude Ighalo,wey just bury him papa some weeks ago,don enta drivers license kasala for Spain as di provincial district attorney for Granada don dey beg court make dem jail Odion Ighalo plus hin forma team mate,Diego Buonanotte and 93 oda pipo bicos of say dem bribe to get drivers license wey dem do.
Akordin to di investigate,dem say dem bribe and hire pipo to write di driving test exam for dem.
You know say for obodo oyibo dem nor dey look face,small tin like dis dem don put u for prison.
I hope say Ighalo nor chook hand for dis magomago to avoid storis dat touch.

Wednesday 26 October 2016

DAVIDO NA COMPLETE YEYE PESIN..NA SO NAIJA DANCE QUEEN KAFFY TALK AS SHE DON PARA FOR DAVIDO BICOS Di BOBO NOR ALLOW DANCERS DANCE FORAM FOR STAGE AFTA HE DON ARRANGE WIT DEM


Naija dance queen Kaffy,don blast Davido and call am morafoka as di bobo nor show dancers respect  for di 3thrones concert wey appun for Lagos on Sunday.
Akordin to Kaffy,Davido cancel kontract wit dansas wey don practice for ova two weeks bicos of di show.
Her annoyance be say,Davido for don talk say he nor want dem bifor dat day instead make he stop dem for di veniu of di show.
She finish Davido for ground and also warn oda miuzishans wey nor dey respect dansas sweat.
She yarn plenti tins wey nor go swit Davido for ear.
Oya Watch di rest for dis vidio...



YANGA DEY SLEEP TROUBLE WAN WAKE AM! CHECK OUT DiS BABE WEY DEY USE HER DRESSING DEY FIND NIGERIA SOLDIERS TROUBLE


Di day wey my papa wey be retired soja flog me 26 stroke for my yansh,I spik in tongues for one full day.
If u know dis babe wey wear army khaki take show her kpai nomba,abi  na army kamoflag Una dey call am,make una jejeje call her go kona advise am like say una dey advice fly wey won folow dead bodi enta grave.
If sojas use pepper eye of say dem remove dem from pawa since 1999 face her,na her biskit bones go remain for her bodi.
If Dem give her confam soja beating,and if dem reset her brain wit dat dia pepper koboko,if she see A,she go call am B.
Make she kontiniu.

Tuesday 25 October 2016

SARAH OMAKWU,ONE SENIOR PASTOR FOR ABUJA,DON WARN HER CHURCH MEMBAS MAKE ANY OF DEM NOR BRING MONEY WEY DEM THIEF KON TAKE PAY TITHE OR DO OFFERING FOR HER CHURCH


Sinior pastor of Famili Worship Centre(FMC),Sarah Omakwu,don warn her church membas make dem no carry money wey dem tiff come her church bicos her mission na to make pipo go heaven.
One memba of her church,Olola Seun Akioye naim share her mesage on top Facebook.
She also yarn say,any old man wey dey sleep around wit small small gehs,dia daughtas go pass thru di same tin for other pipo Hand too.
But wait o,if one politishan pay tight of N20million naira,she go rejectam?
Bicos no politishan dey use dia salary take oppress.

Monday 24 October 2016

WIZKID(3 AWARDS),YEMI ALADE(1 AWARD)TECKNO(1 AWARD) AND PATO RANKING(1 AWARD),DON MAKE NAIJA PROUD AS DEM WIN 6 MTV AFRICA AWARD,MAMA 2016




Saturday nite for South Africa na all about Wizkid as di bobo win three award for di 2016 Mtv Africa Music Awards(MAMA).
He win di best bobo award,miuzishan of di year and best collabo award wit Dj Maphorisa and DJ Buckz wit di song,Soweto baby.
Oda pipo wey make NAIJA proud for di award na,Yemi Alade as she win di award for di best woman singa for Africa,Tekno win di best new breakthrough for Africa and Pato Ranking song wit Wände Coal,My woman my everything naim win di best song award for Africa.
Congratulations as una bring smile for our face.
Di hardship won make pesin kolo.

Sunday 23 October 2016

AKORDIN TO SENATOR BEN BRUCE,NOR BE PRAYERS GO SOLVE NAIJA PROBLEMS BUT LEADERS WEY GET CORRECT SENSE AND WISDOM


One of di senator wey dey reprezent Bayelsa,Ben Murray Bruce,don yarn say,if na by prayers,naija ploblems for don finish bicos no kontri pray pass Nigeria for di world.
Akordin to Ben Bruce,nor be prayers be di solution but wisdom and leaders wey dia nomba six still dey work.
He yarn dis one on top twitter playground.

Saturday 22 October 2016

SINGA,9ice,DON YARN EBONYLIFE TV SAY,iF HE MARRY ONLY ONE WOMAN,MANY GO END UP WITOUT HUSBAND AND HE ALSO PLAN TO GET 20 SHIDREN AS HE DON BORN 4 REMAINDER 16

9ice Wit One Of Him Honey and pikin
9ice don yarn ground full again o.
For one joinbodi intaviu wey Ebonylife TV do witam,di bobo say,na sin foram to marry only one wife bicos women plenti pass men and make women siam as big favour.
Akordin to di gongo aso singa,he say if he marry only one wife,you know how many women go end up witout hosband?
Na wa o.
Dis one na sirios tori.
9ice also yarn say,him don alreadi plan hin life and na 20 shidren him go born.
He say he don get 4 alreadi remainda 16.
Oboy,see journey!

Friday 21 October 2016

DAVIDO DON FINALLY SIGN Di BOY WEY STAND UNDER SUN DEY PLAY GUITAR OUTSIDE HIM GATE AND Di BOBO EVEN FOLLOW DAVIDO ENTA PRIVATE JET GO CATCH GROOVE FOR COTONOU



Wey yor turn don reach,nobodi fit stopam.
Dat na di stori of di Univasiti of Benin boy,J ice, wey carry hin guitar go stand for sun to entatain Davido for outside Davido gate.
Now di skelewu singa don finalli sign di boy enta hin gang,DMW.
Play play play play,di boy don dey enta private jet wit Davido go catch groove.
Of resent,dem play enta Cotonou,Benin Republik wit private jet go run tins.
Oya watch di vidio for bottom hia...


Thursday 20 October 2016

POPULAR BOY OF Di MOMENT AND PANA SINGA,TEKNO,DON YARN SAY,LIFE WITHOUT MONEY AND GIRLS FOR DEY BORING AND ANNOYING


Tekno di baby Pana and big cassava singa don yarn say,like say gehs and money nor dey dis world,di life go tire pipo.
He yarn dis one on top Instagram say make pipo forgetted!
He say make love for di job dey one kona,life is about money and gehs.
Watch di vidio for bottom hia...


Wednesday 19 October 2016

BUHARI DON GET TRAILER LOAD OF SUPORT FROM DAVIDO,AS Di BOBO SAY,BUHARI NEED MORE DAN TWO YEARS TO REPAIR NAIJA BiCOS TINGS DON KPAFUKA BIFOR HE ENTA ASO ROCK


Davido don mix politics and miuzik togeda as he don dey beat drum of soport for Buhari during one joinbodi intaviu wit Thisday newspaper.
Wen dem askam how he see Buhari second year for office,Davido say,naija don kpafuka bifor di General take ova so diafor,he go need more dan two years to repia naija.
He say if sai baba get plenti time and soport from pipo,by God's grace he go succeed.
Since Davido yarn dis one,nor be small yab pipo don yabam for twita and Instagram.
Na wa o,di tin kon tire me again o.

Tuesday 18 October 2016

DIFFICULT CONDITION FOR NAiJA DON TURN SUPASTAR GOSPEL SINGA,LARA GEORGE TO TOMATOES FARMER



Who nor go nor know o.
Naija don dey see some kain changes for pipo attitude nawadays as many pipo don dey use dia church mind stand up for demsef.
Di harsh condition don make gospel miuzik singa and award winna Lara George add farmer to her titles as she don enta farming.
If you won yarn about her now,u fit address her as farmer and miuzishan.
Akordin to wetin she yarn on top Instagram,she say dis difikot condition nor fit stop her from wacking as di tomato seeds wey she spray for her garden don ripe for harvest.
Babe ride on I soport u,na di way to go be dat.
Gofment nor rezav joy for anybodi.

CELEBRATION AS CHIBOK GIRLS WEY DEM RELIZ FINALLY UNITE WIT Dia FAMILY


If u be pesin wey dey doubt weda dis Chibok gehs stori na scam,afta u watch dis vidio,u go konfiuz.
Di gehs finalli see dia famili after 30 months and di selibrayshon tins nor be hia o.
Watch di vidio for yorsef..


Monday 17 October 2016

DEBORAH JAFARU,Di ONLY CHIBOK GIRL WEY RETURN WIT PIKIN,OUT OF THE 21 GIRLS WEY BOKO HARAM RELEASE,BIN DEY PREGNANT BIFOR BOKO BOYS KIDNAP DEM FROM SCHOOL ACCORDING TO HER PAPA


One of di 21 gehs wey Boko Haram reliz last week,Deborah Jafaru,bin dey pregnant even bifor Dem kidnap dem from school akordin to her papa.
Her papa say she marry two weeks bifor dia exam and for ova two years wey Boko boys hide dem for forest,her hosband nor fit biaram as he don marry anoda babe.
He say Deborah don finish sekondri school bifor but she nor pass all her papers naim make her regista again to write di exam bifor jankoliko boys kidnap dem from school.
About 200 gehs still dey wia Boko Haram hide dem and na only god know wen dose ones go get freedom.

Sunday 16 October 2016

BIUTIFU ACTRESS JULIET IBRAHIM DON YARN SAY,PIPO NOR KNOW SAY SHE EXPIRIENCE THREE WAR..Di LEBANON WAR,LIBERIA WAR AND IVORY COAST WAR AND GOD STILL SAVE HER FROM ALL Di BOMBS


Wen God decide to shook leg for yor mata,nobodi fit change am.
Biutifu actress Juliet Ibrahim wey her papa na Lebanese and her mama na Ghana,don hiaram for life nor be small.
She yarn tori pipo say,she don expiriens three war for three diferen kontris.
Di Liberia war,di Lebanon war and di Ivory Coast war.
Akordin to Ghollywood and Nollywood actress,she say,anytime wey war drive dem from one kontri,dem go relocate to anoda kontri.
Afta sometime,war go start for di new kontri wey she and her family dey and na dis one make her expiriens dis wars.
Di time wey dem finalli free na wen war drive dem from Ivory Coast enta Ghana.
Since den,no more wahala.
Hmm,dis life na God get pawa.

Watch her stori for bottom hia...


Saturday 15 October 2016

YES,I KNOW SAY MY JUNIOR BRODA DON TURN BILLIONAIRE AND I DEY CALL AM OGA NAWADAYS,BUT MAKE UNA NOR FORGET SAY,NA ME SPONSOR HIM WEDDING-KCEE LiMPOPO



Kcee don yarn say,naim first start to make money for dia house bifor hin junior broda kom do high jump turn to billionaire.
Kcee broda E money,na oga to Kcee now for dia konpini but di bobo don try remind pipo say,e get di time wey be say naim dey giv hin broda pocket money.
Kcee yarn for one radio show for Lagos say,naim even sponsor E-money wedding dat year.
But wait o,wich kain bizness pesin do wey him take turn billionaire witin ten years?
Na wa,wondament.

MY WIFE BELONG TO MY KiTCHEN,MY SITTING ROOM AND MY KEREWA ROOM - BUHARI (Watch Video)


Nor be plenti wife's go fit do wetin our First Lady and presido wife do.
Aisha Buhari vex cut rope and lash her hosband say,if he nor start to control hin gofment wey pipo don hijack,she nor go vote for her hosband for 2019.
She yarn BBC hausa dis one and oda tori for di joinbodi intaviu wey dem do wit her.
Now her hosband don reply her for inside Germany wey him carry waka go since on Thursday.
Wen tori pipo ask Buhari how he see wetin Aisha yarn,he say hin wife na kitchen matiria.
He also say him wife belong to dia parlour and di kerewa room.
He say wit dis atatack from him wife,he nor dey sure of di party wey him wife dey soport although,he laff talk am.
Bubu try to make joke wit di yarns but some pipo nor resivam as joke.

Oya watch Buhari vidio of wia he for clap back to Aisha...


Friday 14 October 2016

ACCORDING TO BANKY W,HE SAY E NOR DEY COMPULSORY SAY EVRYBODi MUST MARRY BICOS AFTERALL,BILLIONAIRE AMERICA WOMAN OPRAH WINFREY,NOR MARRY


Singa Banky W don fire back give all di pipo wey dey pressure ram to marry say,marriage nor be do or die.
He say nor be must say he must marry bicos aftaraw,America woman Oprah Winfrey wey dem dey respect bicos of di value wey she don add to life,neva still marry at her age.
Banky say nor be evribodi for dis life must marry so diafor,take life easy.

MAD PESiN! SEE AS AMERICA MIUZISHAN ALLOW FANS DEY TOUCH HER WEBSITE


Diferen types of craze naim dey dis world and wetin Yankee singa Miley Cyrus do for stage,make her  one of di bigest craze for di world.
Okorowanta madness dey learn for wia dis one own dey.
Imagine sombodi put her website for ground make fans dey toucham.
Even tho she nor get yansh,she stil allow fans dey grabam all in di name of entatayment.
She even giv one of her fans beta egusi kiss.
If dis kain pesin turn my wife,make u know say na her money I marry.


Thursday 13 October 2016

PHOTOS AND NAMES OF DI CHIBOK GIRLS WEY DEM RELIZ TODAY



Unlike two years ago wey di forma director of defence information,Major General Chris Olukolade announce and later change mouth say dem don reliz Chibok gehs,dis one dis time around don dey turn out to be true.
Akordin to di tori wey break dis morning,Federa Gofment confam say Boko Haram don reliz 21 of di gehs.
 See di names of di 21 gehs wey dem reliz...



See more pikchors of di lucky ones.





BREAKING NEWS!!! ASO ROCK DON CONFAM SAY BOKO HARAM DON RELEASE 21 CHIBOK GIRLS


God don dey ansa our prayers step by step as president office don confam say,Boko boys don release 21 of di ova 200 chibok gehs wey dem gbab for ova two years now.
Di sinior spesha assistant to di preside on media and publisiti mata,Garba Shehu naim confam dis to tori pipo.
He say di gehs dem dey unda di care of dipatment of state service.
Akordin to Shehu,he also yarn say,dem don tell president Buhari about dis latest development bifor he carry waka enta German.
We go bring una more tori about dis gehs as e buss out.

BOVI TO TONY UMEZ: YOU DO TOUCHING BODi TIRE,YOU KISS GENEVIEVE,OMOTOLA,UCHE JOMBO TIRE FOR INSIDE NOLLYWOOD,SO DIAFOR,YOUR FINE DAUGHTA MUST ACT FILM TOO


If you nor know big name Tony Umez for Nollywood,naim be say u neva know anytin about naija film yet.
Tony Umez don act many pity roles,many love roles etc and he get four biutifu daughtas.
Now comedian and also actor Bovi,afta he post pikin and daughta pishor,talk say,for all di lovey lovey,kissing and touching bodi wey Tony don do to Genevieve,Omotola,Uche Jombo and di rest,hin daughta must act film.
She cannot go free akordin to Bovi.
Shuo!
Boys nor dey smile again.
Dem don dey eye dis fresh fish just now,just now.
Bovi you lie,I don diskors wit di papa alreadi,na wine naim remain.

BUHARI GET ENOFF EVIDENCE TO THROW GOODLUCK JONATHAN FOR PRISON AKORDIN TO BOOK WRITER JOHN PADEN


Di man wey win di kontract from Buhari to write book about am,John Paden, don yarn say,president Buhari get klin and enof evidence to put mama peace hosband and forma presido Goodluck Jonathan for prison.
For inside di book, 'Muhammadu Buhari: Challenge of leadership in Nigeria',Mr Paden wey be professor of intanashona studies, yarn say, Buhari just pity for uncle Jona bicos wetin he come do na to rekova all di money wey him and oda politishans tiff wen dem dey office,nor be to put dem for jail.
For chapta 20 and page 203 for inside di book,Paden write say,from di bigining of 2016,u go know say,EFCC nor won gbab Jonathan or even Obasanjo bicos Buhari just want make peace reign.

Wednesday 12 October 2016

Di PRICE OF BREAD AND BiSKiT GO INKRiZ BY 15% FROM OCTOBER 17 ACCORDING TO Di ASSOCIATION OF MASTER BAKERS AND CATERERS OF NIGERIA , AMBCON



Di ploblem wey naija pipo dey face for di past year dey inkriz evri minute as Asosiashon of Master Bakers and Caterers of Nigeria don announce plans to inkriz di price of bread and biskit by 15% from octoba 17.
During di joinbodi meeting wey di south-south and south-east membas do for Asaba,di asosiashon say,dem go inkriz evritin as di price of production don rise like bread wey dem soak for water for 30days.
Akordin to dis pipo,dem say make u imagine!
Sugar wey dem dey buy N7,000 na N19,000 now,butter don jump from N4,200 to N12,000.
Yeast do yanga from N10,500 go Sidon for N17,000 and flour wey be N9,700 bifor don climb tree go sidon for N12k.
Chairman of dis joinbodi zone council,Sir Hilary Eze,di seketri Elder Akpabio Jude and 12 of dem from oda zones,na dem sign di agreement wey go see di price of bread,biskit and oda tins rise up.
Jesus Christ and Mohammed,I nor sure say na una giv us dis leaders.
Na to phone devil askam weda naim handwork naim remain.

BOVI TO TONY UMEZ: YOU KISS GENEVIEVE,OMOTOLA,UCHE JOMBO TIRE FOR INSIDE NOLLYWOOD,SO DIAFOR,YOUR FINE DAUGHTA MUST ACT FILM TOO



If you nor know big name Tony Umez for Nollywood,naim be say u neva know anytin about naija film yet.
Tony Umez don act many pity roles,many love roles etc and he get four biutifu daughtas.
Now comedian and also actor Bovi,afta he post pikin and daughta pishor,talk say,for all di lovey lovey,kissing and touching bodi wey Tony don do to Genevieve,Omotola,Uche Jombo and di rest,hin daughta must act film.
She cannot go free akordin to Bovi.
Shuo!
Boys nor dey smile again.
Dem don dey eye dis fresh fish just now,just now.
Bovi you lie,I don diskors wit di papa alreadi,na wine remain.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...