MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 11 October 2016

CHRISTMAS RICE? Di MINISTA FOR AGRIC AND FOOD MATA,CHIEF AUDU OGBEH,DON YARN SAY,Di PRICE OF RICE GO COME DOWN FOR NOVEMBER WEY BE Di NEXT HARVEST PiRiOD


Nor be me talk am o!
Na di minista of agric and rural development,Chief Audu Ogbeh,naim talk say,di price of rice wey don cost pass gold for naija since dem ban importation,go drop dis novemba.
Akordin to Ogbeh,he say na novemba be di piriod wey harvest fall put so diafor Christmas rice go berekete for our pot.
I hope say nor be politishans ogogoro dey at work?
Nor be today we don know say,di real promise and fail pipo,na politishans.
If u rememba last month,di minista of state for agriculture,Senator Heineken Lokpobiri say rice fit sell for N40,000 if we nor do somtin about am.
We dey wait.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...