MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 10 October 2016

KCEE LIMPOPO DON TALK SAY,NA BEER PARLOUR HIM FOR PICK IYANYA AND HARRYSONG BIFOR DEM BICOM WHO DEM BE TODAY


Five star miuzik bobo,Kcee,don yarn tori pipo say na beer parlour e for meet Iyanya and Harrysong bifor dia miuzik karia turn around for good.
He say hin meet Iyanya for one bar for Calabar dey sing and from dia,he fly am enta Lagos.
Him buy Iyanya di first Eva aeroplane ticket to Lagos.
Afta dat one,he also regista di bobo for Mtn Project Fame konpetishon wey Iyanya later win.
Since he win project fame,he neva look back again.
For Harrysong,Kcee say na for Ojez bar naim he for mitam.
As for di new bobo wey just sign for Five star miuzik,Xbusta,di limpopo singa say na anoda bar for Owerri he for siam.
Na wa o,stori dey.
Kcee and di bar boys,my Nollywood film go start soon.
All rights reserved.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...