MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 6 October 2016

GOSPEL MIUZISHAN AND FORMA INFINITY BAND LEAD SINGA,KENNY K'ORE,DON BLAST PASTORS WEY DEY HIRE COMEDIANS COME MOCK GOD FOR CHURCH


Kenny K'ore,di forma memba of di kristian group,Infinity,don blast pastors wey dey hire comedians to dey crack jokes and mock God for inside church.
He say na bastard child go put hin papa for ground dey yab all in di name of comedy.
Na Pastor Gbile Akanni first condemn dis pastors wit di one wey him write about dose pastors wey dey carry comedians enta church dey yarn opata and K'ore soport evritin wey Gbile stand for as he add hin mouth join di mata.
But wetin I fil be say,real comedian wey know him onions,kanot mock God but only try to be funny in di right way.
Who be me to judge.
I just say make I bring una anoda fresh tori.
Anyway u siam,Kenny K'ore don yarn hin own.
Ova to comedians like Gordons and Akpororo,two comedians wey we know wit church background.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...