MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 9 October 2016

CELEBRATION AS FEDERA GOFMENT PiKiN,CUSTOMS, DON FINALLY AGREE TO OPEN OUR BORDERS AGAIN SO DAT E GO DEY EASY FOR TRADERS TO DEY CARRY RICE ENTA NIGERIA


God don touch Federa Gofment mind as dem don agree to open our borders again for rice traders to dey carry dia market enta Nigeria.
Na one of Federa Gofment shidren,di Nigeria Customs,na dem yarn dis one.
Di Comptroller-General of Customs,Colnel Hameed Ali (rtd),naim yarn dis one.
Akordin to di tori wey di publik relations officer of customs for di kontri,Mr Wale Adeniyi yarn di News Agency of Nigeria,NAN,he say,Oga Hameed,don giv order wit imidiate effect make Customs remove rice name from di goods wey dem ban to enta naija.
Although sha,small condition dey as di rice traders go dey pay for Customs duties.
Wit dis one krismas go sweet wella for many families.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...