MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 3 October 2016

MR IBU SAY LAGOS STATE TEACHING HOSPITA STAFFS NAIM KILL HIN PIKIN BICOS DEM NO GET FUEL FOR GEN AND WEN HE GIDEM MONEY FOR FUEL,DEM SAY Di GENERATOR OPERATOR DON COMOT


Mr Ibu lost hin two years old son for 2012 and he blame Lagos state teaching hospita,LUTH,dat time for di pikin death.
He don come out talk wetin rili appun as he say,afta NEPA seize light as usual,he expect di hospita to use dia generator.
But him shock wen dem telam say,dem nor get fuel.
Mr Ibu look up,look down and stil gidem money to buy fuel only for dem to telam say,di generator operator don comot.
Play play,play play,na so dem waste all di time wey dem for take save di pikin,until di boy kon die.
Nollywood star Ibu say,wetin pain am pass,na afta di pikin die,one doctor stil get mind waka kon mitam say,make he giv dem di dead bodi so dat dem go use am take do pratika for students.
Na wa o!
Pipo get mind o.
Dat doctor sha.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...