MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 29 April 2016

EYAH,TIWA SAVAGE DON CRY BUCKET FULL AND SHE SAY HER MARRIAGE TO TUNJI DON END(VIDEO)


Finalli,Tiwa Savage don break her silence about her marage to Tunji Balogun wey skata and fall yakata like pack of cards.
She say e don rish two months wey she and her hosband marage don end but dem just dey manage to kipam sikrit.
Nor be small fire her forma hosband Tee Billz set for her yansh on top Instagram.
He say Tiwa dey sleep wit her fellow miuzishans like Don Jazzy,Dr Sid and 2face and also akiuz her of many oda tins wey go make yor dada run comot from your head.
During di joinbodi intaviu wit Pulse.ng, Tiwa Savage say,na lie Tee Billz dey lie for her head.
Tunji Balogun a.k.a Tee Billz,get two shidren bifor he marry Tiwa.
She say wetin pain am pass be say,she bin nor know say di bobo get nomba three pikin wey he dey hide.
Akordin to Tiwa,she say wen she tell Tee Billz say pikin food don finish,di bobo go say he nor get shishi but yet,he dey barb hin hair two times a week.
Tiwa say pipo warn am about dia marage but na she nor listin.
Di kelekele love singa,Tiwa buss cry during di intaviu.
For more plenti tori wey she yarn,
Klik and watch am for bottom Hia....


MARADONA SAY IF TO SAY SENEGAL PLAYA KOULIBALY NA WHITE MAN,REAL MADRID OR BARCELONA FOR DON SIGN AM


Futbol legend,Diego Maradona don yarn say,kolor hatred wey u fit stil call racism,still dey exist for futbol,if not,Senegal and Napoli difenda Kalidou Coulibaly,for be aida Real Madrid or Barcelona playa like say him na white man.
Maradona wey be forma Napoli playa imsef yarn all dis one on top Piuenne TV.
He say Coulibaly gud die and dis season for di Italian lig,Coulibaly na one of dia best playas as di bobo don play 39 matches for all dia games alreadi.
For sometime now,many big clubs like Bayern Munich,Chelsea and Man United don dey plan to buy dis strong difenda.
Maradona

For February,wen Napoli and Lazio play one match,na so Lazio fans dey call am monkey for field bifor di referee Massimiliano Irrati kon vex stop di match.
I nor know wen some white pipo go stop to look down on black pipo.
I wonda wen some whites go stop to look black kolor as infirior.
God,our color mata dey yor hand.

BIG NAME: PRESIDENT OF SIERRA LEONE WELCOME WIZKID TO HIN KONTRi


Dis boy don go far.
Di same day way di biggest hip hop miuzishan rite now Drake,use Wizkid pishor take sample di world on top him Instagram page,na di same day Sierra Leone president, Ernest Bai Koroma,welkomam to di kontri.
Na even private jet di bobo take land dia.
If nor be Wizkid,e can neva be Wizkid.



STONE BREAD: CHECK OUT Di BREAD WEY SOMEBODi BUY FOR ONITSHA SHOPRITE


If u dey stay Onitsha and u dey look for soft bread to buy,if shoprite dey yor mind bifor,u go tink twice.
My frend enta shoprite for Onitsha go buy bread,wetin he buy,he mouth nor fit eat am.
Di bread strong kakaraka like iron for zion.
Di bread make me dey wonda weda difrens dey bitwin stone and rock.

Thursday 28 April 2016

MAMi WATER FREND! WETIN DIS WOMAN DEY DO FOR INSIDE RIVER?


Wetin man nor go see for dis world?
See dis woman just sidon for inside river for Cameroon.
Ehn!
Abi na water or ogbanje spirit dey worry dis one?
E be like say her village winch don build shrine on top her head.
She need 500 days diliverance,I swear.

BREAKING NEWS!!! DON JAZZY,2FACE,DR SID SLEEP WIT MY WIFE,TIWA SAVAGE



O boy e don red o!
Dem don set Instagram on fire wit Tiwa Savage tori o.
Her hosband Tee Billz don attack her and akiuz her say she don sleep wit Don Jazzy,Dr Sid and odas.
How I take forget to add 2face name wen Tee Billz sef say Tiwa Savage don open legs for 2baba too.
Akordin to Tee Billz he say,bicos love is blind naim make am nor just won yarn since.
Two of dem don alreadi get one pikin for dia marage.
Kontiniu to read afta dis foto.



I hope say nor be hack dem hack dis bobo Instagram account?
Anyway,di tori don come out,e don come out.
Una go surely hear from us wen we don hear Tiwa and Tee Billz own side of di stori.

ALL MY FELLOW MIUZISHANS MARRIAGE DON FAIL DATS WHY I HATE MARRIAGE - FLAVOUR


Flavour don yarn anoda one again.
Dis time around,he follow hip tv do one joinbodi intaviu and he say marage nor go make am konsetrate for Miuzik.
He say even kpakpa sef,all di oda miuzishans wey don marry,di marage always dey skata.

Di Hip life singa also say,any successful miuzishan marage nor dey dey successful and dis one kon make me dey wonda say,wetin Flavour smoke wey make am dey yarn dis kain tin?
Him nor go fit make he own marage successful if oda miuzishans own dey crash?
By di way,we neva hia any wahala for Omawumi marage.
Psquare  marage wit Lola and Anita stil dey kamkpe.
Abi nor be di same miuzik dem dey sing?

WOMEN,SEE DI PISHOR WEY UNA FREND DENRELE,WANT MAKE UNA SEE


Di king of  'i no send', Derenle,don reliz one strong foto on top Instagram to take to oppress area and to take express hin love to women.
Derenle write #WCW wey mean,Women Crush Wednesday,take follow di foto.
Dis guy sha.
Abeg liv style for who get style.
Nor be evri crazeman dey mad.
Derenle abeg crase yor crase alone,nor crase remain for me.

Wednesday 27 April 2016

GHANA BASE MIUZISHAN SAY HIM DON SLEEP WITH OVA 150 NIGERIA WOMEN


Ghana base Nigeria miuzishan,Obiba Sly Collins say,bifor he remove from naija,him sleep wit ova 150 babes.
He yarn all dis ones on top Atinka Fm and he say out of all of dem na only two women get shidren foram.
Di bobo say wetin pain am pass na wen one babe telam ho ha say,dem don run shows togeda bifor.
He say he nor even rememba,upon say di babe telam di area wia dem for meet.
He say he waste energy,money,time and blood but now he don giv hin life to Jesus.
He say hin don beg God for forgiveness and he don change.


FASHOLA SAY NOR BE ONLY US DEY SUFFER TO GET NEPA LIGHT,HIM SHIDREN DEY SUFFER RAM TOO


Forma Lagos state gofnor and di prezent minista for light and house mata,Tunde Fashola say,heat rashes him shidren and dem dey sweat like Christmas goat too bicos of di NEPA light wey we dey sofa from.
Di minista say,Nigerians dey sofaram and he shidren dey sofaram too.
Na wa o Oga Fashola,yor generator don off once?
Make una sofri sofri dey school us o.
Akordin to Fashola,he say di weather hot die and some kain times,he shidren dey wonda wetin he dey do as minista.
Fashola say nor be say we nor go fit solve dis problem but for us to sovam,gas need to dey yanfuyanfu.
He say if gas nor dey,e be like pesin wey get generator but he nor dey fit buy fuel.
He say we don make mistakes bifor bifor for dis light wahala but dem go fit koret di mistakes.

Tuesday 26 April 2016

FORMA PRESIDENT,IBRAHIM BABANGIDA SAY,YES HIM DEY SICK BUT NA BIG LIE SAY HIM NOR DEY FIT GET UP FROM BED AGAIN


Forma president of Nigeria,Ibrahim Babangida,say evribodi go die one day inkluding imsef so make pipo stop to feel say na one new tin.
Tori bin dey for sometime say IBB dey veri sick and na hep dem dey hepam do evritin and some pipo even say him don die.
Now he don come out yarn say na true say im dey sick but e nor rish dat stage wey pipo kon dey carry rumors say he no dey fit get up again.
IBB also yarn say weda na crime to sick?he say na u get yor mouth,anytin wey u like make u yarn,all him know be say evribodi go kpai one day.
He yarn all dis ones for Minna,Niger state wen he pally tori pipo.

'KLITORiS'.....DIS NA Di NAME OF BRYMO NEW ALBUM


You go fear album title na.
Klitoris?
Wetin na Brymo? Na by force to draw attention?
Naim gud for naija pipo sef.
As una say una no go value beta miuzik,di bobo don bring name wey must make u value somtin.
Forma chocolate city singa Brymo,don vex para for evribodi wey dey refuse to dey aware of hin talent.
Di bobo don readi to reliz him new album wey him call 'Klitoris'.
I hope say any joinbodi women group nor go protest against dis name wey he carry giv him new album sha.
I hope say dem nor go say na disrespect to one of di most koolele part for woman bodi.
As a smart guy,Brymo don alreadi rosh say di Greek meaning of  Klitoris na key.
So diafor,na di key to one door wey him don dey knock for years naim be Klitoris.
Wich levels na Bros Brymo?
Anyway,we don hia you.
Try tell yor pastor about di title of yor new album weda he go gree pray for di success.
Evribodi need prayers.

Monday 25 April 2016

END OF Di ROAD? LIL KESH DON READi TO LIVE OLAMIDE AND YBNL TO GO START HIN OWN RECORD KOMPINI


Blood dey tika dan water.
If nor be blood nor be blood except na miracle to see bizness men or frends wey dey run tins like real blood.
Di tori now be say Lil Kesh,di bobo wey make Olamide insult pipo mama for live tv,don dey readi to dey live hin life by imsef.
As di rumor dey blow pass our bakyard,naim we katcham.

Di oga of Ybnl,Olamide,go loose one of hin best striker Lil Kesh veri soon as di bobo kontract don expaya and he refuse to sign new one.
Di bobo don readi to set up hin own record kompini as we dey hia say he don turn down di chance to kontiniu wit Ybnl.
We go pem dey wait to hia wetin go appun next as Olamide neva yarn anytin for di mata.

WATER DON PASS GARRI AS MY MAMA DEY PUT TOO MUCH PRESSURE ON ME TO MARRY - D'BANJ


D'banj,di kokomasta head won bost for tinking as hin mama dey askam one big queshon,'my pikin,wen u go marry?'
Akordin to D'banj,di mama say she nor care about all di success and supastar life wey dey shackam.
She say D'banj get to marry soon as di tin don dey give her headache.
Mama,kam down,nor worry yor boy go soon marry.


GBAAAAAZZZAAA! MEET Di BADDEST CHICK FOR INSTAGRAM WIT KILLA UKWU!


Abeg who know dis geh Popsie or Momsie?
Nooo,no,nooooo! Nor be wetin u dey tink,she nor dey owe me money.
I just won take pamishon from dem make I for tisham how to cook banga soup for some starch or semo tins just in case she marry warri boy lastlast.
For face she fine,for bodi she set.
Na dis kain malawi dem dey buy bank dash.
I fit build stadium dasham sef.
Her name na Raven,and she be one babe wey don turn intanet upside down for Instagram wit her sexy shape.
She be model and student at di same time.
Nicki Minaj! Nicki Minaj! who na nor dey let pesin hia word, Nicki chop winsh?
See shape wey fit make president forget wetin dem sendam go do for Aso Rock.
I be tink say madness nor get cure but dis babe can cure any man crase inkluding yor crase wit dis bodi.
Afterall, na 'Craze Cure' she dey read for school.
You fit call her craze kiora.
Oyibo dey call wetin she dey read for school, 'Clinical Psychiatry'.
If all di kraze wey dey Uselu siam,dia madness go heal by force.



Sunday 24 April 2016

OYA NOW! OGA DANGOTE SAY HIM GO JOIN HANDS WIT FEDERAL GOVMENT REPAIR NAIJA


Di richest man for Africa,Alhaji Aliko Dangote,don giv hope to kontri pipo say hin go join hands wit gofment to make naija beta again.
Dangote wey also be di richest blackman for di world say make we give dem at list,two and half years to solve yor ploblem.
He say all di areas wey dey giv us headik naim dem go tackle.
Areas like refinery wey go make oil boku again and fatalaiza wey go make food dey yanfu yanfu,naim be di areas wey Dangote say demo torch lite.


TIWA SAVAGE SURPRISE HER FAN BIG TIME AS SHE ATTEND HER WEDDING AND PAFORM FOR FREE


Dis na nice one from di kelekele love singa,Tiwa Savage as she soprise one of her biggest fan wey dey do wedding.
Akordin to Tiwa on top Instagram,she say she re-arange her waka dat day to allowram fit attend di fan wedding.
All dis one wey she do so,di fan nor know say she go play enta di wedding o!
Tiwa yarn say di celibrant dey one joinbodi group wey dem call 'Tiwa Sojas' and dem carry her mata for head like ringworm.
She say dem dey show her beta love and na dis one make her use her church mind take soprise di fan.
Dis kain tin wey Tiwa do so gud welwell as I always dey want make dis our celibritis dey do wetin go make us klap for dem.
Na di way to go be dat.

Saturday 23 April 2016

FLAVOUR NABANIA DON YARN ON TOP INSTAGRAM SAY,ANYWIA YOU SIAM MAKE YOU CALL AM 'BABY DADDY'



Dis na di piriod wen pipo dey proud and boast to be baby dadi and baby mama.
Dat is to say, pipo wey born outside marage.
For humble smith jam Osinachi,Davido dey dia dey shout..,my baby mama!my baby mama! like say dem put gun for him neck.
Many of our celibritis nowadays don turn baby daddis and baby mamas.
Now anoda shampion for dis baby daddi market,Flavour,don post some pishor on top Instagram dey call imsef 'Baby Daddy'.
Na di level wey dis market don rish be dat.

LORD AV MESSi!! SEE Di BIUTIFU BABE,'MISS IKEBE BRAZIL', WEY MESSi DEY RUN FROM


Barca fan,Suzy Cortez,di prezent Brazil miss bum bum,fit kpai for Lionel Messi mata.
Why pesin go dey kiafu for life and pipo like dis go try to konfiuzam wit dia pakage?
Dis kain babe nor go let pesin take Bible study sirios.
Barcelona futball star and Argentina captain,Lionel Messi don dey hear ram for Miss bum bum Brazil hand as di babe dey send Messi her sexy pichors anyhow on top Instagram.
Messi geh frend nor dey find dis mata funny.
If dem giam chance she go brake coke bottle for Suzy Cortez head.

Now,Messi don vex block di babe for Instagram so dat anytime di babe send pishor,di tin nor go appia for Messi side.
Bros talk true,if na you,u go see dis kain food run?

DOCTOR HEP! WINCH KAIN BIG BREAST DIS GIRL CARRY SO?


Dis na foto fotoshop abi na real breast be dis?
God abeg o,na beg we dey beg.
Make man nor see wetin he nor plan for.
Tori wey dey rish us be say,dis geh take merisin wey go make her breast big but di merisin kon ova do hin work.
We go bring una more tori wen we find out wetin appun to her.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...