MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 28 December 2014

RECORD BREAKER:GARETH BARRY THE FIRST PREMIER LEAGUE PLAYER TO COLLECT 100 YELLOW CARDS


Gareth Barry don bicom di first player in history since di English Premier League start for 1992 to collect 100 yellow card for field.
Di Everton midfielder bin dey 99 bifor referee kon givam one more for boxing day wen dem play against Osaze club, Stoke City.
Some pipo dey break record for di right reasons why some dey hold record for di wrong reason.
Dis na one yeye record wey Gareth Barry go dey pray make anoda player quick beat so dat im mind go comot for dis bad boy for class record.
No be only im dey dis club of plenti yellow card collectors as I go give you di top ten.
Check bottom hia to know players wey make di top 10:

1.Gareth Barry     100 yellow cards
2.Kevin Davies      99          "
3.Lee Bowyer        99          "
4.Paul Scholes       97          "
5.Scott Parker         92        "
6.Robbie Savage    89         "
7.George Boateng  85         "
8.Kevin Nolan        83         "
9.Wayne Rooney   83         "
Phil Neville             82         "



Saturday 27 December 2014

PIRATE THINGS: GOVERNOR LIYEL IMOKE DON TURN P SQUARE TO NINJA MEN AS Di 2014 CALABAR FESTIVAL DON BEGIN




Di biggest street party for Africa, di Calabar Festival,don dey witness di highest numba of mushimushi dressing again as di biggest ejime for town, P square don join di 2014 Calabar craze.
Fine fine funny dressing in di spirit of carnival naim dey always dey appun for dis biutiful city as many celebrities always dey gada to celebrate di ''show yorsef dressing and jolliment gbedu''.
JIM IYKE DEY TROWAY SALUTE

Di Cross River govnor, Liyel Imoke and di first lady, Mrs Obioma Imoke, Kate Henshaw,alongside di new Ninjas in town, P square,na dem lead di join bodi for di 2014 Calabar fashion parade.Mrs Imoke naim declare di carnival open yestaday wit di children carnival.
See some biuriful pictures for yorsef;









Friday 26 December 2014

CHRISTMAS EVE MIRACLE FOR PEOPLE AS N850M DON TROWAY FOR BUSY HONG KONG HIGHWAY

Christmas groove start early for many pipo for Honk Kong as dem pack plenti money wey spill for road like oil spillage wey appun for Niger Delta.
British security firm, G4S, wey dey responsible to transport about $4.5 million for Hong Kong,don enta heavy igbese (debt) as dia securiti van driver, no know say di back door no lock well and dis one kon make almost all di money troway for one busy highway for Wan Chai.
No be small drama as passers-by,taxi drivers, okada riders, mama, papa, pikin,mama akara and all sort of pipo rush enta road and pack di one wey dia power reach.
All di money wey leak from di bullion van, dey in Hong Kong 500 dollars note.
Out of di $4.5 million,( 850 million for naira),police announce say na $2 million dollars still dey miss and dem don dey beg pipo to return dem or else na 10 years criminal offence dem dey commit so.
Bicos of di faulty back door wey make di money locate di packers see, no be small traffic di drama cause for Wan Chai area for Hong Kong.
We for hia go put ear for ground to know weda Hong Kongers go return di one wey dem pinch from di chrismas watchnight miracle.

Tuesday 23 December 2014

30 MILLION TO ACT BLUE FILM TOO SMALL-MAHEEDA


If your bizness na to recruit pipo wey dey act blue film and yor budget no pass 30million naira, make you no near were Maheeda dey bicos she fit spit for yor left eye.
Di goddess of X as dem dey call her nowadays,yarn for twitter say, dem give her 30Milla job to act blue film and show her bedmatics skills.
Maheeda yarn say,"Can u imagine dis kain insult?"dem won pay dat kain small money for me to do sirios further maths for bed! Dat one na money?idiot!  Two of my cars money naim be dat na!
Maheeda para welwell for twitter and she kon stil yarn say,"To do blue film na beans?if yor money no go change my generation future, park well oohhhh..I no go do any blue film! Oshofree dem".

Monday 22 December 2014

DI WORLD BIGGEST CROCODILE DON SHOW FACE FOR PANAMA


Like say di popular late crocodile hunter from Australia, Mr Steve Irwin, still dey alive, trust am, he for don catch di nearest flight go Panama go play wit dis giant crocodile wey pipo don alreadi dey call di biggest crocodile ever.
Bifor dis one show face for dis kontri wey dem dey call Panama, di biggelest crocodile for di world dey measure 18 feet long and e dey weigh 2,200 pounds.
Na chicken,fish and pork meat di owner take dey feedam.
Dem even name am Cassius and na 111 years we hear say di crocodile live.
Wit dis new crocodile wey dem catch for Panama canal so, e be like say Cassius tenure as di largest crocodile don expire.
As I dey write dis tori, dem say di pipo wey catcham for di canal don rush go buy tape for market to measure ram.
I go bring una di figures of di measurement wen dem measure ram finish.
Di owner, George Craig dey feed Cassius wit pork meat.

PATIENCE OZOKWOR COOKING AND FRYING TINS FOR IBINABO FIBRESIMA WEDDING

Nollywood shekens,Empress Njamah naim nack dis pictures of her and star actress Patience Ozokwor AkA Mama G for Internet of wen dem dey arrange di wakis wey pipo go blast for Actors Guild of Nigeria Presido,Ibinabo Fibresima wedding.
For those of una wey feel say dem go hire caterers for di mata, una sorry o bicos dis na pure African woman charcoal cooking no be sherekabia.
No time for time wasting.
See more photo for bottom hia:

GOVERNOR JONAH JANG DON APPOINT HIM PIKIN AS COMMISIONER FOR PLATEAU STATE

💃💃💃🎼🎵🎶🎤🎧
Join me as i dey sing Mr lover man, Shabba song if u still rememberam as u dey read dis tori.
As I see dis tori on Govanor Jonah Jang, di first music wey enta my head na Shabba Ranks music,'Family Affair' wen im sing some years ago.
Di Govnor of Plateau state Mr Jonah Jang,don show say di family come first for im brain as he don appoint im son, Yakubu,as commisioner for Land and urban planning.
Yakubu Jang nor new to government as bifor dis new appointment, naim be Special adviser for Special duties to im papa.
Akordin to di commissiona for information for plateau, Mr Mohammed Abubakar, Yakubu Jang go replace Yilji Gomwalk.
Gomwalk naim dem pick as di running mate to PDP govnorship aspirant,Mr Gyang Pwajok For di 2015 elections.
Make I siddon dey watch wich politician go appoint im family pesin next for anoda position.

Sunday 21 December 2014

RONALDO BONE MICHEL PLATINI FOR CLUB WORLD CUP PRESENTATION


Any year wey pipo believe say CR7 go win di world best player award, di bigest football presidents dey always dey tink opposite and yarn some tin wey go make di bobo vex.
Last year, FIFA President, Sepp Blatter talk say he prefer Messi to Ronaldo few weeks bifor di award and no be small bad belle Ronaldo get against am.
Even dis year sef, Blatter just talk say world cup winna and Germany goalkeeper, Manuel Neuer naim deserve 2014 world player of di year award.
Di pesin wey start dis labalaba talk dis year na, Uefa President, Michel Platini wey yarn say, for world cup year,na di player from di champions Germany, naim sopose win dis year award since na dem win di world cup for Brazil last July.
Ronaldo show Platini im annoyance yestaday say dat kain yarns dey painam for bodi during di club world cup presentation ceremony for Marrakech,Morocco, as he no shake hands wit di Uefa ogakpatakpata.
Although, CR7 shake Sepp Blatter but Ronaldo use di opportuniti of say, Real Madrid coach, Carlo Ancelotti block im view,waka pass Michel Platini and go shake di next pesin.
Real Madrid difit San Lorenzo 2 kondo to win di club world cup wey shele for Morocco.

Watch di video of how Ronaldo take bone Platini for hia:

http://www.youtube.com/watch?v=KN24iAmTp3g

Friday 19 December 2014

YOU GO SPEND ONE YEAR FOR PRISON IF YOU CIRCUMCISE ANY GIRL AGAIN-OGUN STATE GOVERNMENT

Di quickest way to spend one year for prison now for Ogun State, na to circumcise yor daughta.
Di comisiona for women affairs and development for Ogun State,Mrs Elizabeth Sonubi naim yarn dis one for Abeokuta for one join bodi conference to celebrate "16days activities to take remove women oppression kpatakpata".
Sonubi say di law against female circumcision for di state still dey kamkpe.
So diafor, if dem catch anybodi wey carry razor blade, Jack knife, dagger, cutlass or any sharp tools near dat tin sake of say dem won comotam, na jail di pesin go find imsef for one year and if di pesin no get luck, female mosquitos fit unite in pity mood for di sake of di girl child for inside di prison and suck im blood dry in two weeks.
Di comisiona say female circumcision na common harmful traditional practice for women and girls bodi.
She also yarn say Ogun state don put eye for ground to make sure dia is no more oppression against women.she say, bicos e no good at all at all and na dis one make dem don push forward and propose di Domestic Violence Prohibition Bill 2014.

Thursday 18 December 2014

MICHELLE ISIKALU DON WIN 'MISS SHAKARA' FOR PASTOR CHRIS OKOTIE HOUSEHOLD OF GOD CHURCH


Chris Okotie: If u believe wetin di Bible talk,Evribodi  Say "ORHON ORNHON"
Church: ORHON ORNHON

Lol, Yes o, dis na di signature yarnings wey dem take know di forma popular musician turned pastor, Chris Okotie.
Di founder of di Household of God church, Pastor Chris Okotie, nor new to news as he don contest tire to bicom di Ogakpatakpata for Aso Rock and President of Nigeria unda im party, FRESH and he don also brake up wit two of his wives.
Dat one sef na small one.di main tin wey dem take know am na di heavy heavy grammar wey Chris Okotie dey blow wen he dey preach and e take Honorable Patrick Obahiagbon years to snatch dat position from Okotie to bicom di King of Grammar for naiJa.
Make we live dat one, di tori wey enta town now be say, Michel Isikalu, don win di most biutiful girl beauty contest for Pastor Chris Okotie church,Di Household of God.
Dem call di competition, Queen Esther Beauty and Costume Pageant and she defeat 16 oda girls to win di crown on sunday.
I know say plenti pipo go dey ask dem sef say,"Shuo! shey church sopose do Miss shakara? "
No worry yorsef bicos nobody go answer u.
Me and u know say Chris Okotie na different guy man wey believe im style die.
He no send anybodi message and he no dey like do wetin oda pipo dey do.
If u like complain from now till tomorrow, he nor send u.
#kpakam.
MICHELLE ISIKALU

Wednesday 17 December 2014

BIG BROTHER AFRICA CONTESTANT, TAYO, IN CHILLING THINGS WITH AYIRI AND PAPA ISABELLA


Dia is no smoke witout fire, di popular proverb wey we dey hear since wen we be small pikin.
Di rumors wey we hear say Big Brother,Ayiri dash Naija representa for Big Brother Africa ( BBA), Tayo,64 million naira don dey be like say small truth dey inside di mata.
Tayo come back to di kontri yestaday afta Big Brother Africa end on di 7th of December and few hours afta di bobo land,he don alreadi hang out wit Waffi billionaire, Ayiri Emami wey don dey swell many musicians pocket.
Even papa Isabella, 2baba,hang out wit Tayo and Ayiri too as di picture wey dey bottom hia dey suggest.
He don do big tings for Oritsefemi and 2face welwell and many oda artiste.
Just two days ago, Oritsefemi yarn di world wen he receive di best street hop wit double wahala for di Headies awards say, Ayiri buy am brand new SUV one week afta he get sirios accident wit di range rover jeep wey im management compini, Avatar entatainent givam.

FLAVOUR N'ABANIA DEY PLAY GUITAR FOR HIM DOGS( HOW TO MAKE Di LION YOUR FRIEND)


U don see were dog for bite im owner die bifor?
Yes e don appun welwel.
Some dogs dey bite anytin bitable why some no dey use eye see tiff or even stranger.
But wit di way wey highlife musician, Flavour N'abania dey follow im dogs dey play and entatain dem for dis picture wey him put for instagram,u go know say he get sense and he get plan.
Afta u give your dogs correct wakis and u kon play koret jam wit yor guitar for dem,why dem no go be yor friend for life?
U sef can make di lion your frend.( Lol)
So incase u dey fear to train Lions bicos of say u no know weda na you dem go take do breakfast, make u no fear again, shakement no dey again, just make sure u get live band bicos Flavour don show say animals dem love music.
Make u just buy guitar, buy drums, buy shekere, buy piano, buy saxophone,buy flute, buy macrophone, even kpakpa sef, try get pipo wey go play di instruments and make u get back up singers join too.
Afta dem don wack, make una entatain dem wit music and u go see say even yor neighbours go like to make friend wit di lions.

Monday 15 December 2014

BREAKING NEW!!! TORTURE UGANDA GIRL, TUMUHIIRWE,GO SPEND FOUR YEARS FOR PRISON



Di Uganda house geh wey nearly kill 18 months old pikin, Aneela, wit beating, go enjoy some mosquito bite for prison as dem don sentence her to 4 years for jail.
Di whole world see di ekwe wey di 22 year old housegirl,Tumuhiirwe, ekwe Aneela wen di vidio show face for Internet.
She don alreadi agree say she dey guilty for di magistrate court for Buganda road for Uganda.
Baby Aneela no come court but her mama,Angella Mbabazi and her popsie, Erick Kamanzi, dey court as dem witness di 4 years sentence wey di Chief magistrate Lillian Buchana give di housegirl.
Imidiately afta di judgement, na straight to prison naim di prison warders go put Tumuhiirwe so dat she go know di difference bitwin prison mosquitos and fried rice.
Afta di judgement Aneela mama kon buss cry and na her family and friends kon calmam down.
Later she and her husband kon hold dia hand waka comot for court and as dem remove, jornalist kon dey follow dem for yansh to intaviu dem.



TIWA SAVAGE DON REALLY MARRY?

HEADIES 2014 PERFORMANCE BY TIWA SAVAGE AND PATO RANKING
I see dis picture of wen Tiwa Savage and Pato Ranking dey perform dia song, Girlie o,for dis year Headies awards last night, i kon dey ask my spirit some questions but my spirit neva still answer me.
Dem be lovebirds or songbirds?
Tiwa Savage don really marry?
See as Tiwa dey use her ikebe dey rob Pato Ranking banana.
Di two of dem do di same tin for stage for South Africa two weeks ago wen dem dey perform for Channel O award.
Una sure say Tee Billz dey see all dis im wife pictures?
One of my friend about 7 years ago visit Warri for di first time afta about 4 years for Canada.Afta some days naim bad pipo asasinate am and till today we neva still know di reason why dem kpai di guy.
Any advice for Pato Ranking?

AT DI CHANNEL O AWARDS

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...