MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 11 December 2014

DI FIRST EVER MISS NIGERIA IN 1957. BIFOR AND NOW ( PHOTO)

Who fine don fine as di biutiful Grace Atinuke Oyelude show for her new photo say she still fine like mamiwater and na she be di first miss Nigeria for 1957.
During dat time, di girls wey dey contest na picture dem dey send go give Daily times newspapers for Eko.
From di pictures,dem go kon select di finalists wey go contest live for di finals for Lagos island club.
Dat time miss Nigeria no involve swimsuit,bikini, pants and bra competition.
For 1957, wen Grace Oyelude wey be 83 years old now contest and represent di northern area, she stil dey work dat time for United African Company(UAC).
Now for miss Nigeria,dem dey win millions of naira, brand new car, endorsements and oda jolliment but dat time, na £200 pounds naim dem give Atinuke for first position and inside dat moni, she use some travel go obodo oyibo go study nursing for di Royal College of Nursing for England.




No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...