MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 11 December 2014

WIZKID DON BEAT DAVIDO AS NIGERIAN MUSICIAN WITH DI MOST TWITTER FOLLOWERS FOR 2014

NUMBER 1
Di holla at your boy singer, Wizkid don send warning signal to Davido camp say him dey ready to be di man to beat come 2015 as twitter don crownam as di Nigerian artiste wit di largest followers for twitter for 2014.
Even di richest black man for di world, Aliko Dangote stil dey creep to rich one million followers for twitter. 
Wizzy get 1.3 million followers and naim be di first Nigerian artiste to reach 1 million followers for twitter.
Davido take 2nd position wit 1 million followers, D'banj carry 3rd and Don Jazzy take 4th.
Wizkid play second fiddle to him biggest rival Davido dis year as Davido win almost all di awards wey dey available to bicom naija most successful artiste for 2014.
For dis music wey dem dey play,I go siddon dey watch to see weda dis recognition go ginger Wizkid to be di boy to beat come 2015 or Davido go kontiniu for wia him stop next year or someone else go top dem and steal di shine comot for dia hand.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...