MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 9 December 2014

TAYO DON WIN "BIG BROTHER AYIRI"(BBA)



Dem say if one way close anoda one go open.
Tayo Faniran, di naija guy wey carry 2nd for dis year Big Brother Africa hotshot, don win Big Brother AYIRI.
Di money wey Idris Sultan from Tanzania kolobi as winna for BBA, no near wetin Warri billionaire, Ayiri Emami don promise to give Tayo.
Big Brother Africa give Idris $300,000 why Big Brother Ayiri give Tayo $350,000.
No be today Ayiri don dey do sheyt for pipo as he recently buy one wicked rolls Royce dash he wife for her birthday and also give 2face about 40milla for him wedding wit Annie Macaulay Idibia.
But come to tink of am, dis 350,000 dollars wey be N64Million naira for naija money,wey Ayiri won give dis bobo,go do many tings for him cominiti and go provide plenti job for di life of plenti youth wey no get job if he use am build industry instead of am to carry am give one pesin all in di name of Big brother.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...