MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 3 December 2014

HALLELUYAH!!! NEW DRUGS TO MAKE YOUR MESS DEY SMELL LIKE CHOCOLATE DON DEY NOW

CHRISTIAN POINCHEVAL
My brodas and sistas, now you fit make yor anus di talk of di town dis christmas season.
For di fest time in di history of di world, to dey mess go dey make sense now bicos, one man from France,Christian Poincheval wey im frend almost kill with mess wey dey smell like kabad and soup wey don sawa for 40 days, don vex make one merisin wey go make yor mess dey smell like chocolate and habiscus flower or even dey smell like stew wit korect curry smell.
He say, since di gas attack nearly kill pipo for di restaurant dat day, naim he vex say he must do someting about smelling mess.
For dose of una wey una mess dey smell like pesin wey neva go toilet for 9 days,from today, yor worriment don end bicos akordin to Poincheval, he say na 100% natural plants and ingridients naim he take make dis merisin.
Di site wey dey sell dis merisin, don take advantage of di season dey call am "Di Father Christmas mess merisin", even though Poincheval neva givam name.
Since pipo dey eat more during holiday piriod, dis drug go make sense dis season.
And if you don dey crack yor head for di kind of gifts wey you go buy for yor frends and family dis Xmas, no worry yorsef again as dis mess cure merisin, na di pafect gift.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...