MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 9 December 2014

WHY I HATE MANCHESTER-ANGEL DI MARIA


Manchester United winger Angel Di Maria wey dey injured presently,don yarn say na only one ting dey scata him dada for England.
He say life for England dey tire ram for only one reason.
Messi teammate for Argentina squad,Di Maria say, day too dey quick dark and cold,won killam for di city of Manchester. He say e no be like dat at all at all for Spain.
Di forma Real Madrid player say,he nor get any problem with di wackis or any oda ting for Manchester bicos di difference no much bitwin wetin im dey eat for Spain bifor.
He say di only problem na di cold wahala.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...