MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 1 December 2014

SINCE EMMANUEL ADEBAYOR CALL OUR MAMA WINCH, NA SO SO CRY SHE DEY CRY-KOLA ADEBAYOR


Kola Adebayor, Emmanuel Adebayor senior broda,don yarn say di Tottenham striker don brake dia mama heart since he call am winch.
Kola say na so so cry dia mama dey cry since one fake babalawo tell Adebayor say dia mama and  dia sista, Mageret dey do juju and otumokpor to kill im football career.
Kola, wey be truck driver for Bremen, Germany, tell The Sun on Sunday say, dis same babalawo dem, dem don wash di guy brain sotey dem dey prophesies toram bifor he score goals and also dey yarnam why he no dey play well.
Kola say, "my mama dey veri sad.na evriday she dey cry.I call am for phone just now and she just dey cry steady."
KOLA BACK THEN WITH RASTA DADA, TAKE POSE WITH
MAMA AND LATE PAPA ADEBAYOR
If u still rememba our stori almost two weeks ago,we tell una say, Emmanuel Adebayor yarn one radio station for Ghana say he mama dey try to kill im destiny with juju.
Di tori wey we even gada be say he don even drive di mama comot for im house bicos of dis mata.
Meanwhy, Adebayor coach no select am for di match wey im club, Tottenham Hotspur play and win 2-1 against Everton yestaday.
Even last week too di coach no look im face for di match wey dem play and also win against Hull City 2-1.
KOLA AND EMMA ADEBAYOR WEN DI GOING DEY SMOOTH

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...