MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 4 December 2014

M.I TO SAEON:WIZKID DEY RIGHT, BIZNESS NA BIZNESS


Mr incredible imsef, M.I, don shook mouth for di quarel bitwin Wizkid and Saeon.
If you rememba, few months ago, Saeon blast say,Wizzy no send her song,"Boogie down" wey two of dem sing as he neva one day promote am for twitter or facebook.
Wizzy sef kon reply am say, di job wey dem payam to do naim he do, so diafor, make evribodi free am.
Now di short blackboi imsef,M.I say pasonally,im feel say Wizkid no do wrong since na bizness naim bring dem two togeda.
M. I say Saeon dey veri wrong as she kon dey yarn about dia bizness deal for public.
He say as for him, he no dey charge pipo for collabos but dat one no mean say if pesin kon meet im managers for bizness dem go rejectam.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...