MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 6 December 2014

COMPARE ME WITH MALE MUSICIANS NOT FEMALE ARTISTES-CYNTHIA MORGAN

As a female, she get evritin wey woman dey get but if you see di reggae and dancehall queen Cynthia Morgan, make u no go do mistake call her  female artiste but call am "musician".
Akordin to di Edo born biutiful chikito wey dey sing wit plenti power, she say,she no dey di same class wit di rest female artiste dem bicos none of dem dey do di kind music wey she dey do.
Cynthia Morgan, di Northside records first lady say,if u listen to her jams, u go know say she no dey sing soft like your evriday female artiste.
She say she don reach dat stage wey be say, pipo no dey borda to compare her wit girls again but dem dey compare ram wit men wey sabi.
She say make all her fans and music lovers expect her album first or second quarter next year bicos she stil dey try to add salt and maggi to di music wey she dey cook.
She also yarn say she go work and do collabo wit some oda top musicians including P-square dem wey she say na must for di album.
Cynthia release one latest song last week wey she call,"popori and e dey really dey totori many radio stations right now.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...