MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 8 December 2014

I DEY READY TO SIGN FOR D'BANJ AND DB RECORDS-ORITSEFEMI


One of di most successful musician dis year for naija, Oritsefemi don yarn say if D'banj givam offer to sign for im label, DB records, im go sign one time.
Oritsefemi wit im manager, Danku,sorvive arm robbery attack for Ikorodu road on sunday and damage di range rover wey im management team, Avatar entertainment just dasham.
Di forma memba of di group, Junglist, say im and D'banj closeness don pass 5 and 6 already and dem even join bodi and voice do di remix of im baddest song, double wahala.
He say na di kokomasta imsef dey introduce am to many compinis and from next year, im go sign some kain wicked deals.
Oritsefemi say many of dis pipo dem know im songs but dem no know am one on one but D'banj don make tings and di connections veri easy.
He say dem don alreadi dey work like brodas so, if D'banj say, oya femolala sign for DB records, he say he dey veri possible say him fit sign.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...