MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 8 December 2014

TORTURE HOUSE GIRL FOR UGANDA FIT SPEND 15 YEARS FOR PRISON


Di Uganda house girl, Jolly Tumuhirwe,wey shock di world wit di way wey she take nearly beat 18 month old pikin,baby Aneela nearly die, don admit say she dey guilty for evritin wey dem charge am for as she appear for court.
Di whole world see wetin dis heart of stone girl do to di innocent pikin for di CCTV camera wey her papa put to monitor anytin wey dey appun for di hause.
On Monday bifor magistrate Moses Nabende for court, di house girl say she dey veri sorry for wetin she do to di baby.she say make di papa,her mama and di world forgive her bicos na devil cause am.
Bicos of di beg wey she beg, di court don shift her case go Wednesday and na dat wednesday she go find out her punishment wey fit dey up to 15 years akordin to di law for dia.

BABY ANEELA, HER MOMSIE AND POPSIE FOR INSIDE COURT TODAY

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...