MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 30 April 2017

REEKADO BANKS SAY,HIM PAPA WARN AM NOT TO EVER LIVE JESUS CHRIST AFTER HE TELL DEM SAY,HE DON CHOOSE TO FOLLOW MUSIC


Mavin records and Don Jazzy boy Reekado Banks,don yarn tori pipo say,although him popsi and Momsi no vex say him dey do miuzik wen he first start,but sha,him papa warn am say,make he nor eva live Jesus Christ.
Reekado say,dem dey givam beta soport bicos dem want di best for dia shidren.
If you go dull for Jesus Christ mata,na you know o.
Who no like beta ting?

Saturday 29 April 2017

FORGET ABOUT GHANA JOLLOF AND NIGERIA NIGERIA JOLLOF,NA SENEGAL GET Di SWEETEST JOLLOF RICE AKORDIN TO MINISTA OF INFORMATE,LAI MOHAMMED


Nor be small curse Naija minista of informate Lai Mohammed don resiv from pipo on top twita and on top evriwia afta di minista yarn say,Senegal jollof swit pass Naija jollof rice.
Di minista don take di jollof rice argument to anoda level.
Di argument wey we bin know na bitwin Ghana and Naija jollof as di two kontri pipo dey always claim say na dia jollof swit pass.
But shockment don katch jollof rice lovas for Naija as Lai Mohammed tell CNN say,na Senegal jollof naim make sense pass di rest.
Crowd don put Lai on top blasting as some don alreadi dey yarn say Lai too Lie.
I hope say di minista neva start wetin him nor go fit finish?
Anyway no shakement,I go travel go Senegal for my next holiday to konfam weda di minista drink kloroquin bifor he chop dia rice.
I go give una scores veri soon wen I come back from Senegal to konfam weda na true say dia jollof rice na heaven approve.

Friday 28 April 2017

ONE BABE CHIAMAKA OKEKE,DON TALK SAY SHE GO KILL HER SEF IF DAVIDO NO COME HER BIRTHDAY FOR AUGUST 13 DIS YEAR


One babe for Instagram wey her name na Chiamaka Okeke,don yarn say,she must kill her sef if Davido nor come her baitday or if she nor see Davido dat veri day or bifor dat day.
She say since 2014 she don dey follow Davido for both twita and Instagram and at di same time she don beg Davido tire make he follow her back but for wia!Davido nor dey sendam.
Now she say to kill her sef naim remain since Davido dey use her play.
We even dey hia say di babe don born one pikin alreadi and if she kill her sef bicos of Davido,na di pikin she just wan suffer for notin.
But wait o,
Wetin be di name of dis evil spirit wey dey make dis shidren dey do anyhow sef?
So as I dey so,I go kon kill mysef bicos I like Obama?
Why Obama nor kill imsef bicos of me?
Anyway,Davido don reply her say make she no kill her sef say him don dey follow her back for Instagram.
Watch di full video for bottom hia wey di girl for dey yarn puan....


Thursday 27 April 2017

OBASANJO DON YARN TORI PIPO SAY,ASO ROCK AND PRESIDENT POSITION TOO BIG FOR GOODLUCK JONATHAN FROM Di BEGINNING


Forma khaki presido Olusegun Obasanjo,don yarn tori pipo say,na mistake Goodluck Jonathan take be president.
He yarn dis one for inside one book, "Against the run of play" wey just come out.
Obj say,Jonathan too small from di biginning to be Naija president.
Wetin pesin nor go hear?
But Obasanjo nor know bifor dem pusham come out to be president?
Abi na me bringam come?

Wednesday 26 April 2017

FELA FIRST BOY PIKIN FEMI,DON CRY OUT SAY,FOR HIM AREA,NEPA NEVA GIVE DEM LIGHT FOR OVER 7 WEEKS


Di sinior son of Fela di King of Afro beat, Femi,don blast NEPA on top say for 7 weeks,dem neva get light for dia area.
He yarn dis one for stage for Africa shrine.
Femi wey dey stay Alagbole for Akute, Lagos say,all wetin him papa dey sing about dat year naim stil dey appun.
I feel u Femi but dat your 7 weeks no light,dey learn for wia Pipo area dey.
Pipo dey wey neva see light for 14 months.
Gofment sef!

Tuesday 25 April 2017

AKORDIN TO SULTAN OF SOKOTO,Di REASON WHY NIGERIA PIPO DEY HUNGRY NA BICOS DEM TOO LAZY


Sultan Of sokoto Alhaji Sa'ad Abubakar 111,don yarn say,di reason why hunga won kpai us for dis kontri na bicos Nigeria pipo and dia leaders too lazy to solve di ploblems.
He yarn dis one for one joinbodi meeting wey dem call,di 22nd National Ummah Convention for Sokoto.
He say we too dey put our hope on top gofment head and we dey wait to get hep from rich pipo.
Di Sultan say e no sopose be like dat if we take agriculture serious.
Thank you Sultan we don hia you.
We for ogakpatakpata dey beg you if you get land wey you fit dash us make we carry dis farming for head,abeg make u give us.
We nor lazy,we love farming.
Thank you in advance.

Monday 24 April 2017

I GO DYE DON ADVICE BIG BRODA WINNA EFE,MAKE HE STOP TO DISTURB OUR EARS WIT SUFFER SUFFER TALK BICOS PLENTi PIPO DEY WEY POOR PASS AM


Popular komedian I go dye,don advise Efe di BigBrodaNaija winna,make he dey see imsef as big boy selibriti now instead of am to dey kontiniu to preach about how him take poor.
I go dye yarn dis one during di Ay live Easter groove for Eko hotel,Lagos.
He say some of dem don suffer pass Efe bifor dem kon get money.
I go dye Say,him don chop dog food for Ali Baba house bifor so diafor,him nor undastand why Efe dey feel say naim don suffer pass for dis world.

Sunday 23 April 2017

TWO FIGHTING AS DAVIDO AND ICE PRINCE CLASH FOR WARRI BICOS SHOW ORGANIZERS USE EXPENSIV CAR GO PICK DAVIDO FOR AIRPORT BUT USE CHEAP CAR GO PICK ICE PRINCE


Davido and Ice Prince niali throw blows last nite for Warri as dem go play for di Delta Alive show.
As di mata still go,we hear say,Davido destroy somtin inkluding tv for di place.
Di kwanta start wen di oganaizas of di show use G-Wagon go carry Davido for airport but dem use saloon car go pick Ice Prince for di same airport too.
Di tin touch Ice Prince soul and he later tell di oganaizas say him nor hapi wit dem.
Trust Davido as di tin sef kon vexam say Ice Prince dey komplain say dem carry am wit G-Wagon.
As if dat one nor rish,dem kon stil call Ice Prince come out to sing bifor Lil Kesh wey also come di show.
Meanwhy Ice Prince lookam say,him levels large pass Lil Kesh Own and dem kon dey tritam like dat.
Davido wey don alreadi dey para for Ice Prince just quik quik start to soport Lil Kesh.
Akordin to pipo wey dey dia wen di kasala burst,dem say,wen dem rish dia hotel,Davido still go dey knock Ice Prince door and dey shout like dog wey dem cut him tail.
Omo see Gobe.
We hope say dem go try settle diasef bicos we no wan hear 2pac and Biggie stori o.

Friday 21 April 2017

NA ME GO LOOSE IF I SIDDON ONE PLACE DEY FEEL SAY I DON DEY Di SAME LEVEL WIT RIHANNA - TIWA SAVAGE


Tiwa Savage don yarn 'Arise tv' many tins during di joinbodi intaviu wey she do wit di tv station.
Na di same pesin naim get,Thisday Newspaper and Arise tv.
Akordin to Tiwa during di intaviu,she say she gats do more and work more instead of her to siddon for one place dey feel say she don arrive like Rihanna.
She say if you nor try to dey try for di mata wey dey ground so,to succeed go dey veri hard.
So diafor,.  Sworking hard go kontiniu to be her logo.

Thursday 20 April 2017

SUPASTAR TEKNO NEED UNA PRAYERS AS HE DON TRAVEL GO AMERICA GO TREAT Di 'ACID REFLUX' SICKNESS WEY CATCH AM OVER A MONTH NOW


Pana singa,Tekno,don beg him fans make dem pray foram as he don travel go America for tritment for di acid reflux sickness wey katcham.
Di bobo don also tell show promotas say make dem no bookam or now as di sickness nor go fit allowramto sing.
He say him go refund all di money of pipo wey don pay bifor to show face for dia groove.
We for Ogakpatakpata dey wisham goodluck for di tritment.

Wednesday 19 April 2017

EFE,BISOLA AND TBOSS DON RECEIVE PLOT OF LAND EACH FOR ABUJA FROM TONTO DIKEH HUSBAND,CHURCHILL


Pipo wey pass welwell for exams nor dey resiv di kain gift wey dem don give dis Big Broda Naija pipo.
Abi to know book don turn crime for dis kontri again?
Well,Na so di tin don be so as Efe,Bisola and Tboss don get plot of land each from Tonto Dikeh hosband Churchill Oladunni.
You hear me well,yes Tonto Dikeh hosband,aftaraw dem neva divorce even tho say dem dey quarel right now.
Na Efe,Bisola and Tboss take first,second and third position for di Big Broda kompetishon wey just finish.
But wait o,na wia Churchill dey get dis plenti land wey hin dey dash pipo espeshali selibritis?
Na wa o.
Well,e nor konsign me sha I just say make I ask.
Abeg Churchill abeg try give giv student wey win mathematics kompetishon land too nor be only pipo wey dem lock for house for 3 months.

Tuesday 18 April 2017

SEND DOWN THE RAIN SINGER MAJEK FASHEK DON YARN SAY,TINUBU SEF BEEN POOR BIFOR SO DIAFOR,ANYBODi FIT BECOME MILLIONAIRE TOMOROW


Di first tin wey poor man need to take calm di head down na pesin to givam words to enkorrage am.
Dat na exactli wetin Reggae star Majek Fashek don provide for many pipo.
Majek don clear pipo wey attend one joinbodi APC rally say,even dia national leader Bola Tinubu di jagaban imsef,na poor man bifor he kon rich.
Di send down di rain singa say if Tinubu na poorman bifor,anybodi can be millionaire do diafor,nor loose hope.
Watch di Majek video for bottom hia....


Monday 17 April 2017

YEMI ALADE DON YARN TORi PIPO SAY,HALF YORUBA AND HALF IBO WEY SHE BE,DON HELP HER CAREER WELWELL


Yemi Alade don clear tori pipo say nor be crime to come from two tribes but blessing toram.
Akordin to one of Africa biggest miuzishan right now she say,bicos her papa na Yoruba and her mama na Ibo don make her fit connect wella wit di two culture bicos Yoruba and Ibo dey shia many tins in common.
Yemi Alade also clear tori pipo say,di stori of her song Johnny wey she take blow and wey Selebobo produce stil dey soprise her.
She say dem just dey studio dey play bifor she go say sidon look na verb,di song Johnny don krip enta her system.
Since God favour use Johnny take turn her life around,her life don turn evriday halleluyah.

Sunday 16 April 2017

YORUBA NOLLYWOOD ACTOR,KUNLE AFOD DON YARN SAY,MAKE WE DEY KIAFU OF Di KAiN FRENDS WEY WE DEY GET BICOS OUT OF 10 FRENDS,8 NA YOUR ENEMIES


Good friends dey,bad friends dey but akordin to Yoruba nollywood actor Kunle Afod,na bad friends plenti pass.
Di bobo say,if you get ten frends,eight na your enimis bicos dem go dey jealous you if your mata pure pass dem own.
If you dey progress,e go dey pepper those eight friends for bodi so diafor,make we dey kiafu for di kain frends wey we dey kip.
Watch di video of Kunle Afod advice for bottom hia...


Saturday 15 April 2017

OBA OF BENIN DON TELL IZE-IYAMU OF PDP MAKE HE ACCEPT SAY OBASEKI OF APC WINAM FOR LAST YEAR EDO STATE GOVNOR ELECTIONS


Oba nor dey go transfer as dem talk am and now di OBA of Benin don shook mouth for di Gofnorship battle bitwin Obaseki of APC and Ize-Iyamu of PDP.
On Thursday,tribunal wey dey judge di mata,troway di case wey Iyamu file against Obaseki as dem say na Obaseki naim win di election true true.
Now for peace to reign Oba imsef don say make Iyamu kpror.

Friday 14 April 2017

BASKET MOUTH DON START TO LEAK AGAIN AS TEKNO TALK SAY,WIZKID,DAVIDO AND IMSEF,NA DEM MUSIC DEY RULE Di iNDUSTRi


Tekno don yarn tori pipo say na three of dem dey rule di industri now.
Imsef,Wizkid and Davido.
I nor know wetin di bobo drink or smoke wey make am dey yarn puan.
Only last year wey pipo bigin know am small small,now he don big pass 2face,Flavour,Psquare,Olamide,Phyno?
Dis one na pure gutter talk.
Do yor singing and let pipo do di praising.

Thursday 13 April 2017

BREAKING NEWS! DAVIDO DON SIGN EFE AS MEMBA OF DMW AFTA HE WIN BIG BRODA NAIJA


Nor be news again say Efe win Big Broda Naija wey just end and di bobo win N25 million plus SUV to take oppress.
Since dat halleluya shout wey Efe shout since on Sunday,many beta tins don dey waka enta him life.
Just some days ago,Plateau state gofment givam ambassador position and some hours ag tori don enta our newsroom say,Davido don add Efe join him DMW gang.
He go join oda membas of di gang like Mayorkun,Dremo and Yonda togeda wit dia young Oga Davido.
Too much sauce.

Tuesday 11 April 2017

EFE Di CAR OWNER POSE WITH Di SUV WEY BIG BRODA GIVAM


If dem tell u say pesin life fit change in seconds nor doubt bicos God naim be di biginning and di end.
See Efe of yestaday don turn big boy.
Nor be all him friends go fit siam again.
Na di truth be dat.
Dem don givam di SUV and di bobo don readi to oppress wit him new baby.

EFCC DON DISCOVER N250 MILLION NAIRA FOR BALOGUN MARKET AND DEM STILL DEY TRY TO LOCATE WHO GET Di MONEY


Na so so money EFCC dey diskova for difrent places now.
For kaduna,for Lagos EFCC torchlight dey shine on wuruwuru deals.
Just yestaday,one informa do him work as he tell Say,sombodi don carry plenti money enta Balogun market for Lagos wey dem won change to dollars.
EFCC office nor kuku far from dia as dem rush enta Balogun go pack di money.
Dem arrest two pipo wey dey epp giv dem informate about how di money take rish dia.

EFE IS BACK! SEE CROWD WEY WELCOME Di BIG BRODA NAIJA WINNA


Wetin success dey bring,only yor mouth nor fit yarn am.
Ovanight Efe don turn selibriti as crowd welkom di bobo for Murtala Mohammed airport for Lagos yestaday.
No long talking,
Watch di video for bottom hia by yasef...


Monday 10 April 2017

MICHAEL JACKSON JUNIOR SISTA,JANET JACKSON MARRIAGE TO HER BILLIONAIRE HUSBAND DON SCATTER


Three months afta she born a bouncing baby boy for her billionaire husband Wissam Al mana,Janet Jackson marage to dis fine bobo don skata yakata like pack of cards.
Di 50 years old Janet and Wissam marage last for five years and akordin to tori wey enta our newsroom,e be like say dem too busy and Dem nor dey get time for each oda naim make dia marage hit wall.
Di two of dem nor get bad belle for each oda as dia pikin Eissa go dey wit him mama for London.

Sunday 9 April 2017

LORD HAVE MERCY! ONE BABE FOR TWITA DON TALK SAY,SHE GO KILL HERSELF IF EFE NOR WIN BIG BRODA NAIJA WEY DEY END TODAY


Dem born pikin,dem givam name,feed am make she grow and afta she grow,her brain kon knock.
Dis na di case of dis girl on top twita wey say she go kill her sef if Efe nor win Big Broda Naija today.
Her name na @Godsgiftele for twita and she say if Efe nor win she go take her own life.
Like say wen dem born her new,her popsi and momsi joinbodi togeda and use her take exchange one basket of tomatoes,pipo go say dem dey craze.
My advice for her be say, make she make her sef hapi bicos,since I start to read di bible,e no get wia dem write for inside say hell fire don full.
Hell fire need more craze pipo like her.

Saturday 8 April 2017

WIZKID DON SET NEW RECORD FOR AFRICA AS OVER ONE MILLION PIPO DON WATCH Di VIDEO FOR HIM NEW SONG "COME CLOSER" IN LESS THAN 24 HOURS


From tori wey dey rich us,no miuzishan video for Africa don get 1 million views witin 24 hours.
Dat is to say,dem don look Wizkid video for him new song ova 1 million times for di first day wey di bobo reliz di video.
One of di biggest stars for di world,Drake do kolabo wit Wizkid for di song but bicos di bobo nor dey di video nearli take di shine from di song but God nor allowram appun as Wizzy don set new Africa record wit dis klin video.

Friday 7 April 2017

CHIEF,CHIEF: DEM DON GIVE FLAVOUR CHIEFTANCY TITLE FOR LIBERIA




Pipo wey dey gbadun Flavour Nabania kind of highlife miuzik don honor di bobo wit Chieftancy title for Liberia.
Anywia u see Flavour if u want make him mind swit just call am Zanzan of Liberia bicos na di Chieftancy title wey dem givam for Liberia be dat wen he go dia go plasta di area wit him style and miuzik.
Na only God know wetin Zanzan mean for yonda.

Thursday 6 April 2017

SHAKiTi MAMA: SEE WOMEN DEY SHACK BEER FOR ENUGU LIKE MAD



One bobo for Facebook Ugo Okafor naim share dis foto.
Akordin toram,he go one burial for Akama Oghe,Ezeagu local gofment area for Enugu state and women dey shack beer.
He say both mama and papa,shidren and evribodi dey shack beer.
He say dem nor need opener as dem even dey use dia teeth take do opener.
Wondament.

Wednesday 5 April 2017

BREAKING NEWS! POLICE FOR ENGLAND DON ARREST SUPER EAGLES PLAYER AHMED MUSA AS DEM SUSPECT AM SAY HE BEAT HIM WIFE


Police for England don arrest Leicester City and Super Eagles playa Ahmed Musa for him house,base on tori wey dem hear say,he dey beat him wife.
Unlike Nigeria,if you beat yor wife for yonda naim be say u don komit big crime.
Di police dem akordin to di tori wey we gada,intaviu Ahmed Musa to find out weda na true say he turn him wife to punching bag.
Two women police also sit Musa wife Jamila for corner and dem ask her some kweshons as e take konsign di mata.
Musa and Jamila don get two shidren togeda,Ahmed junior and Halima.
I hope say nor be di annoyance of say him coach nor dey putam for match again naim him transfer to him wife?
One good ting about di mata be say,Musa neighbor say Musa na koret guy and he get veri nice smile but him nor know anytin about dia fighting rumor.
Anyway,we go bring una more tori afta di police don reliz dia statement on di mata.

NOLLYWOOD ACTOR ALEX EKUBO DON YARN US SAY, NAIJA NA GIANT OF AFRICA FOR MOUTH AFTA HE GO SHOOT FILM FOR CAMEROON AND DEM NO SEIZE DiA LIGHT FOR 5 DAYS


Fine boy actor Alex Ekubo don yab Naija as giant of Africa for mouth afta he witness steady light for five days for Cameroon during one film shoot.
Di way wey di mata be now be say,NEPA for Cameroon get sense pass our own if we say make we judge wetin Alex Ekubo mean.
Akordin to Alex he say,Nigeria na big name wey dey kill small dog.
Nepa mata tire pesin.

Tuesday 4 April 2017

DAVIDO DON ADVICE BIG BROTHER NAIJA HOUSE SAY, WHOEVER WIN Di 25 MILLION NAIRA TO PLAN WELL IF NOT,HE FIT SPEND Di MONEY TROWAY


Davido visit di Big Broda Naija house for South Africa and he give dem beta advice concerning di money wey dem dey fight to win.
He say make anybodi wey win di money use him nomba six and do beta tin wit di money if not he go kash winch.
Davido say him spend $1 million dollars in 3 months so anytin can appun.
Di Big Broda Naija show go end dis week and anybodi among Debie-Rise,Bisola,Efe,Marvis or Tboss naim go win di N25 million wey be di price for whoeva carry first.

Monday 3 April 2017

ONE RADIO PRESENTER ALEX MOSE FOR KENYA,DON SWEAR SAY HIM NOR GO EVA PLAY DAVIDO AND BURNA BOY SONGS FOR HIM SHOW BICOS DEM NOR POPULAR FOR KENYA


Wetin we dey try to know now na weda e get anoda tin wey Davido and Burna Boy do dis radio prezenta for Kenya wey make am swear say him no go eva play dia song for him show.
Though akordin to di bobo wey him name na Alex Mose,he say na bicos 90% of Kenya pipo nor know dem.
Trust Burna Boy as him yab di guy for him reply say,if he nor take time,him and Davido go buy dia radio station and turn am to wia dem go dey troway cigar ashes put.
Na wa o.

Sunday 2 April 2017

PAUL, Di TWIN BRODA TO PETER OF PSQUARE,DEY EXPECT TWINS FROM HIM PREGNANT WIFE ACCORDING TO FRIENDS OF Di FAMILY


Paul of Psquare and him pregnant wife Anita,dey xpect twins veri veri soon to join dia famili.
Di hosband and wife don alreadi get one pikin Andre.
Akordin to tori wey rish our newsroom,dia famili frends don dey spread di good news alreadi.
We even hear say di belle don nearli drop as Anita go soon born.
We go bring una more tori about am as ee enta.

Saturday 1 April 2017

BLEACHING CREAM SELLER,DENCIA,DON CALL YEMI ALADE 'A NOBODY' JUST BICOS YEMI ALADE MENTION HER NAME FOR ONE INTAViU


Yanga dey slip trouble go wake am naim be dis case.
E be like say Mama Africa and Johnny babe Yemi Alade,won get beefing mate now as bleaching krim sella and singa Dencia,don yab her and call her Mrs nobodi.
Yemi mouth scratch her go yarn say,Dencia sabi entatain pipo for red carpet and e be like say dis yarns vex di Cameroon born babe as she givam to Yemi straight.
Dencia 1 Yemi Alade 0.
We dey wait for Yemi reply.
If Yemi Alade nor won talk sef,we go force her talk.
Make I call her nomba now sef,I pray make she nor giv her manager di phone to ansa me bicos she I want make she talk for dis mata.
Anytin wey she yarn me,I go let una know.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...