MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 30 June 2015

GAY LORD DON WIN BET AWARDS

SAM SMITH AND BOYFRIEND,JONATHAN ZEIZEL
If e get any Celebrity wey don turn Yeyebrity, and also  kon carry homosexual mata for head like lakpalakpa,di pesin na di gay lord imsef, Sam Smith.
Di bobo sabi sing wella no be small but him madness start wen he come out openly yarn say him na gay last year.
Afta supreme court pass di law for June 26 last friday, say to bicom homosexual don dey legal for America, Sam Smith rush go intanet and post pishor of two men wey dey kiss and kon write say,"ALL 50 STATES!!!! SO HAPPY".
Tufiakwa!!!!!!!!!
SAM SMITH AFTER ANODA WOMAN HUSBAND

But sha o,even as Sam Smith dey happy to be homosexual,di bobo sabi sing no be small and na dis one make dem givam di BET Award for di best new artiste.
Apart from dis one,he also win four Grammy Awards for February.
Di BET Awards apun on di 28 of June for America and no naija miuzishan win even spoon.
Wizkid and Yemi Alade plus including Sarkodie from Ghana,AKA and The Soil from South Africa,Fally Ipupa from DR Congo,Sauti Sol from Kenya, no get luck as dem give Ghana Reggae and Dancehall star,Stonebwoy, di award for di Best Intanationa miuzishan for Africa.
Na double celebration for Ghana,as her pikin,Stormzy, wey base for London,win di Best Intanationa Miuzishan for UK.

Thursday 25 June 2015

I HAWK GALA,CHIN-CHIN FOR MILE 2,ALAKIJA,MAZA-MAZA TRAFFIC - K PEACE



If you dey look for book wey get plenti inspiration to read, make u no look far again as di life of di Nigerian Idol season 5 winna,K-Peace, na beta book to read.
Watch out for yor area as very soon, di bookshops and cd shops wey dey near you, go soon stat to dey sellam.
From ordinari pure water,gala and chin-chin hawker, K-Peace don hama as he win N7.5 million,one Hyundai Sports Utiliti motor,record deal with Univasal Miuzik for South Africa, and he go also carry joliment waka go sleep for five star hotel and chop high grade chin-chin,drink korect wine for Dubai and all di bill na from di pocket of di organizas of Nigeria Idol.
Olakunle Ogunrombi A.K.A K-Peace, enta street go hussle afta him papa wey be di bread winna of di family die of heart attack.
Di bobo say im come from a family of five and to chop 3 times a day no be problem for dem.
Infact,wen dem dey grow up,him papa dey always buy dem chocolate,donkwa,kulikuli,
goody goody,biskit, anytime he dey come back from work.
Bifor K-Peace papa die,he work for Leventis Motors as engineer.
Afta dat work finish,he enta motor parts bizness and naim he take dey take care of di family.
But as di old boi kpai,naim yawa gas.
Di mama no fit carry di load alone as tins kon konk and kon dey veri hard.
Dis one kon make K-Peace vex enta street.
He hawk chin-chin,gala,pure water sotey, he turn hawking king for traffic just to sorvive afta him papa die.
But bifor he enta hawking,di bobo say him do factory work for Maza-Maza from 7am to 5pm and na one N120 dem dey pay am and anytime wey he do ovatime join,dem go add N30 join di money.
K-Peace stop di work afta one year and kon enta hawking bicos di KevinLittle wey di company dey pay am,no dey reach am do anytin.
But now,Baba God don shook hand for di guy mata as levels don change.
K-Peace don finally find peace wit him singing talent as he don win di Nigeria Idol season 5 and di rest as dem talk am, na history.
Area!
I hail una.

Wednesday 17 June 2015

NO BE ONLY P SQUARE,LINDA IKEJI NEVA ENTA CHURCH FOR A YEAR TOO

Di talk say tori pipo no dey get time for demsef fit be true afterall.
Last week no be small tin as internet skata bicos rumors come out say P-Square neva go church for over eight years now.
No be small blast crowd blast dem as Paul one of di P-Square twins later deny say na big lie.
Anyhow,if na true,no be only dem be celebriti wey neva enta church as we fit confam say big name tori teller,
LINDA IKEJI AND SONI IRABOR
Linda Ikeji; neva siddon for any church chair for ova a year bicos of work work for 24 hours.
Linda hersef naim use her mouth yarn dis one wen she carry waka go meet di man wit plenti expirience for radio,Mr Soni Irabor for sunday intaviu on top Inspiration Fm.

To listen to di intaviu,make u press "PLAY" and listen for bottom hia:

http://k007.kiwi6.com/hotlink/r1rzgsj7ii/LINDA_IKEJI_WITH_SONI_IRABOR_EXCLUSIVE_FROM_OGAKPATAKPATA_mix1.mp3

Thursday 11 June 2015

2FACE WIFE DON DISPLAY PHOTO OF HIM AWARDS FOR INSTAGRAM


Forget!
Wetin don be don be.
2face alias 2baba na man wey sabi.
If you no gree sef,he get wife wey fit die for di bobo mata and wife wey bilivam finish.
Annie Idibia,wife to 2face, don cut rope for instagram as she post say dey proud welwell and she kon dash enta Okoro feeli funky mood.

On top Instagram,she post di photo of shelf wey her hfusband arrange awards wey he don win for dis miuzik wey he dey play.
She even yarn for Instagram say,no be all di awards be dat o!
She say she dey proud die for her husband bicos,she get husband wey sabi and husband wey be legend finish.
If e no be 2face e cannot be 2face.
Kpakam.

NICKI MINAJ OLD AND NEW BOYFRIEND;WHO GET SWAG PASS?

Rapper Nicki Minaj,di ikebe queen and her boyfriend of twef years Safaree Samuels,no dey again and dis one no be news.
Di news be say she don get new boyfriend, Meek Mills and di bobo sef na rapper.
Nicki Minaj fans across di world don dey even begam make she try settle wit di Jamaica born Safaree bicos di guy swagga no be here.

Make i sampo una some picchors as pipo don dey argue about who get swag pass among dis two bobos.
Bitwin Meek Mills and Safaree,who get swagga pass?

Na di  di old bobo,Safaree?
Or di new bobo,Meek Mills?

Check out dia photo for bottom hia:


SAFAREE AND NICKI MINAJ
NICKI MINAJ AND MEEK MILLS


Wednesday 10 June 2015

BUHARI NO SABI DRESS AT ALL - GHANA TV PRESENTER


Ghana tv presenter,Gabriel Enoch don blast naija presido,Muhammadu Buhari dressing to di 2015 G7 meeting for Germany.
He yarn for twita say, wen Africa leaders and dia yeye dressing go improve sef?.
Di G7 kontris take photo togeda plus Buhari and na only Buhari no deck suit and dis one kon give Enoch mind to dey yarn opata.
Di truth be say no be by force to chop okro if u dey forbid am.
If Gabriel Enoch wey be Africa pikin from Ghana no biliv in Africa culture naim be say him head don knock.
America,UK, Japan, France, Canada and Italy and Germany naim make up di G7 kontris and dem invite Buhari come dia meeting as one of di guest.
Di other guest wey dem invite come to di G7 meeting na,Ethipia Prime Minister,Hailemariam Desalegn
Iraq Prime Minister,
Haider al-Abadi,Liberia President,Ellen Johnson Sirleaf,
Senegal President, Macky Sall,
Tunisia President,Beji Caid Essebsi and Ban Ki-moon di United Nations Secretary-General.



Tuesday 9 June 2015

SEE AS DOG DEY RIDE BICYCLE

Wondas shall neva end.
Check out as dis dog dey ride keke like human being.
Di dog wey di owners nickname Barry di Bedlington,turn star afta he learn how to ride dia pikin tricycle for England.
Di dog learn fast pass dia pikin sef.
U get dog or any pet?
Wetin dem don do wey surprise you?



OGOGORO DRINKING GO LAND YOU FOR PROBLEM IF WE CATCH YOU - FG

Ogogoro na acid for bodi from today akordin to govment.
Federa govment don ban ogogoro alias 
kai-kai for naija.
Di director general of National Agency for Food and Drugs Administration and Control, NAFDAC, Dr. Paul Orhii naim yarn dis one on monday.
He say na 38 pipo don die for Rivers state sake of say dem shack ogogoro and wack dog meat recently and dem no go fit fold hands dey look until e kill evribodi.
Rivers state don alreadi banam since last week for di state.

Apart from Rivers,pipo don die for Ondo state too and dem stil put all di blame for Ogogoro head.
Dis ban go affect many Ijaw,Urhobo,Itsekiri and many oda malleh dem from other area wey be say na dis bizness dem take dey take care of dia family.
I rememba ebola wen dem say na bush meat dey cause am.
Bush meat sellers carry protest enta town say make govment find anoda excuse say bush meat na koret meat.
I go siddon dey watch how di mata go end weda dem go protest or dem go change enta anoda bizness.

Thursday 4 June 2015

CISSE DON MARRY ANODA BABE FOR HIM GIRLFRIEND BACK


Senegal footballer,Papiss Cisse don brake di heart of him girlfriend into smalsmall pieces.
Graham Rachelle forma Miss Newcastle beauty queen and model still dey struggle to gada di pieces togeda.
Cisse wey dey tap leather for Newcastle United for England,no tell him white girlfriend,Rachelle anything bifor he fly go marry volleyball star, Awa Diallo for Paris.
Rachelle and Cisse don dey do dis kelekele love for over two years now but dis oyibo pepper get di shock of her life wen she see di wedding picchor of Cisse and Awa for facebook and instagram.
She say wetin pain am pass be say, Cisse no letam know about him plans as dem spend beta qualiti time togeda recently.
CISSE AND AWA DIALLO + RACHELLE



Cisse marry Awa for one swish yatch club on May 30, three days afta Rachelle hep di bobo pack him bag and escortam go enta aeroplane for airport and she kon even sama Cisse goodbye kiss bifor he enta di plane.
One Rachelle friend later yarn pipo say,di rizin why Cisse no date her friend wit all him heart na bicos, di footballer family expectam to marry Africa muslim woman.
Papiss Cisse na strong muslim wey no dey drink and na five times a day he dey pray.
Sorry Rachelle, it is well.

Wednesday 3 June 2015

USAIN BOLT NA BAD NEIGHBOUR FROM HELL FIRE- SEAN PAUL WIFE

BOLT AND JODI JINX
U fit dey your own,u no go know say some kain of yor doings wey u take as normal,dey abnormal to oda pipu.
Dis na exactly wetin dey appun bitwin di fastest man,di man wey sabi tia race pass for di world,Usain Bolt and grammy award winning reggae miuzishan,Sean Paul wife,wey her name na Jodi Jinx.
Jodi Jinx don accuse Usain Bolt of noise polution for dia area.
She also yarn for facebook say Usain Bolt na neighbor from hellfire bicos he dey disturb di area wit too much noise.
She say,di loud noise  from cars,motorcycles and di loud miuzik from Usain Bolt house fit make pesin run mad.
She also yarn say apart from di bike noise,na so so party and so so shout Usain Bolt sabi and she no fit wait to park comot for di area.
She say she no get one singo respect for Bolt again bicos na evriwia he dey carry him bad karata go.
She even yarn say, although pipo love di bobo welwell sha,but na bad example to di world.
Jodi Jinx say two times now for dia area,Usain Bolt don shoot gun gbosa! gbosa! and di gunshot sef fit deaf pesin ears.
Some pipo nor go too blame di 100 and 200 mita record holder, Usain Bolt for di loud miuzik bicos, apart from di race,di oda work wey dem know am for,na DJ work.
DJ BOLT
Usain Bolt and Jodi Jinx husband,Sean Paul neva yarn anytin for di mata but plenti of Bolt fans won kill her wit curse for twita and facebook including reggae,dancehall miuzishan,Popcaan.

Tuesday 2 June 2015

THE JUMIA MOBILE WEEK MEGATHON DON COME TOWN


My pipo My pipo,i hail una.
If you be pesin wey know wetin dey for Naija and u dey follow Jumia di numba one,ogbonge online shop, wia u fit buy koret goods,you go know say,anytime dem say big ting won appun,dem no dey joke,e must appun.
I bin plan to kip dis sikrit but how i won take kip sikrit wey no lemme kip?
My pipo,i no fit kip dis one,i must yarn una.
Oya read my sikrit for bottom hia:

Dis time ehn,dem call am di biggest buybuy ever,'The JUMIA Mobile Week Megathon'.
Dis deal na about plenti betabeta phone wey dem go sell and e go take place from di 1st of june to 7th of June.
Guy,make i yarn you beta.
You go fear fear bicos na di biggest phone-selling groove wey u go eva hear of be dis.
So if yor phone don lost bifor or you won change am bicos e get fault,or your plan na to get di latest phone, or even kpakpa sef if yor plan na to add anoda phone join di ones wey u get bifor,naim be say you sabi someting.
If u get all dis plans for yor head and you kon dey look for crazy price wey go make u bow, make you sharpaly carry waka go, (www.jumia.com.ng/megathon) and join other pipo for di Jumia Mobile Week Megathon and get other informate bicos di counting of di days wey remain for dis joliment to start, don bigin.
Jumia go run dis show wit ogbonge phone compinis for Di Jumia Phone Week Megathon.

Dis deal nor be wetin pesin supose miss for him life and e go involve beta and koret phone wey di biggest compinis go push enta market.
Now wey di mata stil fresh,to be part of dis beta jolliment,make u quikquik download the Jumia App.
For dis June enh,u must get new phone,i must get new phone,my grandmama must get new phone,evribodi must get new phone.
Di Jumia Phone Week Megathon,go appun from june 1st to june 7.
Make u no say i no yarn you o?
U beta ready,
U beta do kiakia.
Una weldone.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...