MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 30 September 2014

COOL TV AND WAZOBIA TV TO START BROADCASTING OCTOBER 1ST


Startimes don ready to show di ogbonge and wicked wicked equipments wey dem don arrange to take open di newest stations for town, Cool Tv for channel 195 and Wazobia Tv for channel 196.
For ova two and half years naim dem don dey arrange and build dis tv stations and na Octoba 1st wey be naija independence day naim dem go finally start to show for your TV.
Akordin to Amin Moussalli, di managing director of Cool fm and Wazobia fm for di join bodi meeting bifor di launching for Octoba 1st, he yarn say why dem dey launch dem for independence na bicos dis day na veri spesha day and naim make dem launch dia rest children ,Cool fm, Wazobia fm and  Naija info for Octoba 1st.

FLAVOUR NABANIA DON WELCOME BABY GIRL PIKIN WITH SANDRA OKAGBUE

FLAVOUR AND SANDRA
Chinedu Okoli AKA Flavour N'abania, don turn pesin papa as you dey read dis stori like dis.
Baby oku Singa,Flavor and him babe, biutiful Sandra Okagbue, don welcome dia new born dota for Houston, America on di 27 of Septemba, 2014.
Sandra Okagbue, di forma face of delta soap,akordin to tori wey olofofo pipo bin dey carry sometimes ago, bin dey secretly frend forma Lyn of Oslo player, John Mikel Obi.
Na both Flavour and Sandra naim break dis good news to dia frends for Facebook, Twitter and di rest aprokomasin site for intanet.
We stil dey sidon look weda dis two pipo go later marry.
Congratulabia to dem for dia new baby geh pikin.

Saturday 27 September 2014

CHELSEA CLINTON DON WELCOME HER FIRST PIKIN

BILL CLINTON AND MARC MEZVINSKY
 Chelsea,di dota of forma US President Bill Clinton and di present Secretary of States,Hillary Clinton,don deliva a bouncing baby girl.
Chelsea Clinton announce for twitter say she and her husband,Marc Mezvinsky dey very happy as dem welcome dia fest pikin.
34 year old Chelsea,marry Marc for 2010 and she kon announce last April say she don get belle for di guy.
She born dis pikin exactly wen her mama,Hilary Clinton stil dey rizin weda make she contest to take ova from Barrack Obama and bicom America presido for 2016.
Her papa,Bill Clinton,naim be di nomba 42 president for Amerika and he rule from 1993 to january 2001.
Chelsea Clinton togeda wit her popsi and momsi na dem dey run di Clinton foundation and her husband na banker.

Chelsea step down from her ova 9million naira a year job as NBC special reporta to take care of her pregnancy and face house wife mata and also to do good good tins and work for pipo.

BLESSING OKAGBARE AND IGHO OTEGHERI GO MARRY DIS NOVEMBER FOR WARRI

BLESSING IGHO 
Di oil city of Warri,Delta State go hear ram as two of dia own,Blessing Okagbare and Igho Otegheri go shake di town wit dia tradishona marriage for Novemba.
Some of us wey dey close to Igho Otegheri no dey soprise bicos dem don dey togeda since,di only tin wey we no know na wen dem go marry but now dem don come out talk say na Novemba.
Blessing say Igho na di veri bobo as she don dey alreadi call am her handsome prince and she also yarn say dem don bi odnari frends bifor she even cut out go obodo oyibo go porshu her career and wen Igho later show up say make dem turn lovers,she just troway all her shakara for one corner and show di bobo love.
Commonwealth games champion for both 100 metres and 200 metres,Blessing Okagbare and forma Super Eagles player,Igho Otegheri bin don dey frend for some years now.
Dem two na Urhobo pipo from Delta State.
Blessing Okagbare na di record holder for 100 mita with 10.79 seconds and Commonwealth games record holder wit 10.85 seconds wey she set for Scotland dis year.  
Igho don play bifor for Wikki Tourist of Bauchi,Dolphins of Port Harcourt,Heartland of Owerri and Enugu Rangers bifor he kon sign for Jeitar Jerusalem F.c of Israel but injuri no allow ram rest as he later come back to naija.

Friday 26 September 2014

STATE CREATION WAHALA DON MAKE ENUGU COMMUNITY DEY BURN HOUSES


GOVANOR SULLIVAN CHIME OF ENUGU STATE
Di proposal from di National Confab delegates of states creation wey we neva even know weda government go create,don dey cause heavy gbege for  Ette for Igbo-Eze North Local Government Area of Enugu state bicos some pipo want make dem comot for Enugu join Kogi State why some no gree.
Dem burn at list 10 houses and many pipo get sirios injuri wen di fight stat.
Akordin to di police pipo for Enugu Ezike,di headquata of Igbo-Eze North Local Government Area,dem say dem shoot di youth leader of dose pipo wey suport say dem must remain for Enugu.
Although di youth leader,Mista Mathias Eje,sorvive di shooting but him house dey among di ones wey dem burn. 
Afta di attack on di youth leader,him bois kon organise demsef and attack di pipo wey want Ette to dey unda Kogi and burn dia houses too.
GOVANOR IDRIS WADA OF KOGI STATE
Dis no be di fest time wey gofment dey talk about state creation and dem no do am.
My question now be say,now wey dem don dey fight and burn dia houses down,wot if govment no kon create any state?how di mata go come sound for pipo ear?
My pipo,how una see am?

Thursday 25 September 2014

JOSEPH YOBO DON DENY SAY ARSENAL WON SIGN AM

JOSEPH YOBO AND iM WIFE, ADAEZE
Forma Super Eagles skippo Joseph Yobo don deny yam say Arsenal dey try to sign nam.
Yobo wey resign from Super Eagles afta di world cup for Brazil dis year,say he don read about am too but na rumors bicos im neva get any kontract kontact from Arsene Wenger.
Di forma Everton and Marseille of France defender say in dose days sha, Wenger bin dey trip foram and he nearly buyam to replace Sol Campbell but Everton block di move.
Yobo say Wenger bin want make him and Kolo Toure dey play 5 and 6 for Arsenal wen him stil dey veri yong but he say im no dey aware weda of any negoshiashon wit Arsenal.
He say if anytin like dat dey hapun, naim be say na wit im agent but he no dey sure.
 Di last club wey him play for na Fernabache of Turkey and even sef him wife Adaeze, forma miss Nigeria, dey learn book for one univasiti for Turkey.
Even tho many naija futbol fans say Yobo loose form welwel bifor him resign, many pipo all ova di world stil biliv say na koret profeshona futbolla bicos for 11 years now, Joseph Yobo neva get red card and he don skor 15 goals for both club and kontri.

AMBER ROSE DON GO COURT SAY MAKE DEM PUT FULL STOP TO HER MARRIAGE WITH WIZ KHALIFA

WIZ KHALIFA and AMBER ROSE kissing dat time wen di
Love dey swit dem
Anoda hollywood marriage don end again one year afta dem do dia one year marriage anivasri.
Plenti wahala bitwin Model,miuzishan,actress, Amber Rose and her miuzishan husband, Wiz Khalifa, wey dem no fit settle,don make dem end dia marriage.
Dem don get one boi pikin bifor dem separate and now Amber Rose won make sure na she take dia one and a half year old pikin follow bodi.
Di pikin wey he name na Sebastian,go get chance to dey see im papa sometimes bicos dem don alreadi sign am say he get right to dey visit di boi.
AMBER ROSE
Amber Rose wey her real name na Amber Levonchuck, and Wiz Khalifa wey he real name na Cameron Thomaz, separate on Monday and Amber kon go court on tuesday say she want make dem divorce.

Wednesday 24 September 2014

STOP TB JOSHUA MAKE HE NO COME SOUTH AFRICA-ANC YOUTH LEAGUE

DI COLLAPSE BUILDING and TB JOSHUA
12 days afta ova 100 pipo die wen TB Joshua Guest house building collapse for Ikotun,di African National Congress Youth League don dey draw di ear of  South Africa President,Jacob Zuma and oda govment pipo say make dem no allow TB Joshua leg enta dia land.
Na 84 South Africa pipo naim die wen di building collaps and dem say dem won know wetin make di building fall fest b4 any oda stori.
TB Joshua di owna of di Synagogue Church of All Nations,bin don announce last sunday say di South Africa pipo wey die no plan to die na just wetin God want make he hapun and he even praise dem say dem die serving God.
He also yarn say him like to visit South Africa to meet wit di families of di pipo wey die to tell dem to take heart for dis sad ting wey hapun.
Make we wait and see weda dia govment go giv TB Joshua visa or weda dem go listen to di ANC youth league not to allow ram come dia kontri until he explain wetin hapun to dia kontri pipo.
Dem say na about 350 South Africans naim visit Synagogue Church of All Nations during di time wey di building collaps.

Tuesday 23 September 2014

BRIGADIER GENERAL CHRIS OLUKOLADE DON CHANGE HIM MOUTH SAY NO BE CHIBOK GIRLS DEM RELEASE

Brigadier General Chris Olukolade 
Hours after Brigadier General Chris Olukolade call Charles Akpan of inspiration fm,Lagos say Boko haram don free some of  di girls,he don call back to change im mouth say no be di girls dey inside di two hiace bus wey carry some gehs go Maimalari barracks,di headquaters of di 7th division of di Nigeria Army.
Akordin to Charles Akpan,him record  di interview of wen Brig Gen Olukolade call and afta he call back to change him mouth.
Di Army General say na diferent girls dey inside di bus to Maimalari barracks and dem dey on a different mission.
Nor be only Charles Akpan he call as he also confam to BBC,the Nation newspaper say boko haram don bin reliz di gehs.




BREAKING NEWS!!! BOKO HARAM DON RELEASE CHIBOK GEHS

CHIBOK GIRLS

Tori wey dey rich our table now now now be say,boko haram don agree to #Bringbackourgehs as dem just release them today.
akordin to di Director of defence information,Major General Chris Olukolade,he tell Charles Akpan of inspiration fm,Lagos say na two hiace bus naim dem take carry dem go Maimalari barracks,di headquaters of di 7th division of di Nigeria army.
We neva confam how many of di gehs wey boko haram don reliz during di time of dis report but we go bring una more report as e dey come.
MAJOR GENERAL CHRIS OLUKOLADE

MUSILIU OBANIKORO DON CHOOSE KOROBUCCI AS HIM CAMPAIGN NAME

BOBOS WEY WEAR KOROBUCCI POLO

Forma Lagos State govnor contester,di Minista for defence,Senator Musiliu Obanikoro,don reliz im campaign name "Korobucci" and evribodi know say him name am afta Dorobucci,di ogbonge  miuzik wey Don Jazzy and im Mavin workers sing.
He put gehs for inside di mata too as dia name for di campaign na "Korolette".
Na Septemba 20 naim Obanikoro bring dis one come out for Lagos during PDP rally wey President Goodluck Jonathan attend.
KOROLETTE
Akordin to di tori wey we gada,dem don even use di Korobucci sing song to make di campaign sweet.
But sha o,Mr Obanikoro neva talk wich position he won contest for afta Fashola winam to bicom Lagos state govnor some years ago.
Anyhow sha,we go siddon dey look to know wetin him get for mind for 2015.

FRANK LAMPARD EQUALISER AGAINST iM FORMA CLUB DON CAUSE DI DEATH OF ONE UGANDA MAN

LATE FAHAD MUSANAN and LAMPARD
Afta Manchester city Frank Lampard skor five minutes to end dia match against im forma club,Chelsea,one Uganda Chelsea fan,Fahad Musanan,faint and later die.
Musanan wey he imsef na profesiona fubolla wit Simba futbol club of Uganda,die even bifor dem carriam rich di Bombo Military Hospita.
Akordin to wetin im frend, Gerald Bagoole tell Kawowo news agency,he say dem train togeda dat morning,chop aftunun food togeda sef bifor di bobo give up.
He also yarn say,Musanan fit die for Chelsea mata bicos of di love wey im get for dem and now true true,na Chelsea mata di guy die put.
Even di Federation of Uganda Football Association,FUFA,don reliz statement say dem dey veri sad and shock about di sudden death of Simba FC player Musana Fahad for Bombo last sunday evening.
Him dead bodi dey di Bombo Military Hospita until dem go announce di burial arrangement.

Monday 22 September 2014

BOKO HARAM SAY RELEASE OUR 18 COMMANDOS AND WE GO FREE CHIBOK GEHS.


CHIBOK GEHS
Hope dis one no go be anoda stori again of how dem go take release di chibok gehs wey Boko haram kidnap since April 15?
Dis no be di fest time we dey hear ram as President Goodluck cancel di meeting last minute to take release dem last May.
Right now di tori be say,for di meeting wey boko haram hold wit govment for di present of International Committee of di Red Cross(ICRC), for Abuja,dem say if dem release dia 18 commandos wey govment arrest,dem go reliz di 219 chibok gehs one time.

Dem say if federa govment try use force to free di gehs,naim be say many of dem go die troway for nothing.
Boko haram say,wit di kain machine guns,rockets,bombs and grenades wey dem get,dem go fit fight govment for 45 years and dem no go shake so make nobodi play roff play wit dem.
Akordin to one pesin wey attend di meeting,boko haram don gree to release all di gehs instead of only 30 christian gehs wey dem don marry inside.
He say dem soppose reliz di gehs dem during Eid-el Fitr festival but dem stopam bicos dem hia say di millitary talk say na only 6 boko haram comando dem go reliz bicos di remaining 12 get veri dangerous mind.
Di pesin wey act as chairman for di meeting na di President, Civil Rights Congress (CRC),  Comrade Shehu Sani and evribodi don go report back to dia oga about wetin dem yarn for di meeting till further notice.                                                                          

PRESIDENT GOODLUCK JONATHAN GO VISIT SICK IBRAHIM BABANGIDA TODAY FOR GERMANY

IBB
 Forma millitary jaguda,Ibrahim Badamosi Babangida wey rule Nigeria from 27 August 1985 to 27 August 1993,akordin to tori wey we dey hear,dey sick siriosly and dem don fly am go Germany for tritment ten days ago from im heavy mansion for Minna,Niger State.
President Goodluck Jonathan go pay am visit today straight from di annual United Nations General Assembly meeting wey im attend for New york.
For di statement wey dem release from di President office,dem say Jonathan won pass there go London for sikrit waka but e be like say na dribble he won dribble pipo like Maradona as na Babangida he won use style go visit for Germany.
Na sirios back pain bin worry babangida one time wen he take carry waka enta Germany for operation and e be like say na di same problem carry am go back as dem say he dey veri sick.
Though one close frend to Babangida don yarn say no shaking say di forma head of state bodi don dey improve welwel.

Sunday 21 September 2014

COSSY ORJIAKOR SAY SHE NEED SUGARBOY WEY GO MEET HER TERMS AND CONDITIONS



COSSY ORJIAKOR

Cossy Orjiakor,di nollywood actress wey don turn miuzishan nowadays,don enta news again.
Na plenti tings dey put her for news.
Wetin she carry for front don giv her populariti pass wetin she carry for back,dis one sef dey putam for news.
But di new "news" now be say,if you want make she be your sugar mummy,you must sabi wash plates,wash plenti clothes,you must sabi cook koret wack,you must be koret houseboy and a driver.
Why she yarn all dis one akordin to her be say,boys no dey letam rest.I want to be your honey,I want you to be coakroach in my cupboard,I want you to be di moskito wey go dey suck my blood,I want you to be my wife,I want you to be dis!i want you to be dat!
She say di tin tire ram but anyhow,if you gree say you go die for her mata,you must meet her terms and condition.
She say she don even tell dem make dem bluetooth picture of diasef and how dem take dey cook for kitchen and di picture of wetin dem cook too,but none of dem don send di one wey tripam.
Cossy Orjiakor also yarn say,like say dem don meet her terms and condition to be her Sugarboy,she for don employ like three sef and even dey pay dem salary.
 

THE MEANING OF DOROBUCCI BY DR SID

MAVIN CREW

If you be one of dose pipo wey dey ask say wetin dorobucci mean,dat koret miuzik wey Don Jazzy and im Mavin pipo sing,make you no ask again bicos Dr Sid,Simi Osomo husband don tell us di meaning.
 One of Naija top miuzishan,Mavin records Dr Sid,formally of Mohits,don yarn say di meaning of Dorobuci na good pesin,swaggalicious pesin,rich pesin,koret pesin,happy pesin,sexy pesin,infact pesin's pesin and any oda word wey you fit take qualify pesin wey im head dey there.
Di Abraka,Delta state born teeth dokita and miuzishan,yarn dis one for one small talku talku intaviu wey him do for Lagos.
DR SID
He say "Bucci" mean shine shine, "Bucci" mean fun.
He say na "Doro" make "Bucci" pesin,so im na doro,Simi na doro,you na doro,she na doro,they are doro,your oga na doro,we are doro,Don jazzy na doro,Ronaldo na doro,doris na doro,evribodi na doro.


Saturday 20 September 2014

BISHOP OYEDEPO SAY NOTHING DEY WRONG TO PAY BIG MONEY FOR QUALITY EDUCATION

BISHOP DAVID OYEDEPO

Bishop David Oyedepo,di owna of Living faith church don talk say no be crime say skuls wey churches get dey charge high skul fees bicos to get beta education no be beans and to run beta skul bizness carry plenti cost.
He say like im church skul,Convenant univasiti,skul fees must dey high bicos dem dey giv skolaship and borsary to student and dem neva stil stop.
He say wetin sef!how much we dey pay for skul fees? He say evri year pipo dey spend 1.5 trilion naira just to go abroad go len book and pipo no dey complain,we dey spend 463bilion Naira evri month for recharge card,he say na we get di largest telephone market for di world and even sef some pipo get one pikin and beta bizness wit plenti house for evriwia,stil dem no fit pay common 500,000 tausand Naira.
He yarn all dis one for Ota,Ogun State wen he do small talku talku wit Jornalist to take mark im 60 years birthday wey go shele for septemba 27.
He also yarn say we dey spend our money for di wrong tins welwell bicos some pipo wit dia small salary ready to spend 1milion Naira for burial but to pay 200 tausand Naira for skul,na problem.
Bishop Oyedepo say all di bad bad tins wey pipo dey talk about am no concern am bicos silence is di best answer to a fool and evribodi get right to talk wetin dey im mind.
Concerning all di challenge  wey im dey face for life and im church,he say he no dey allow dem disturbam but instead dem dey ginger ram to hussle.
For di join bodi talku talku wit Journalist,Bishop Oyedepo talk say di church get 63 branches for oda kontris.
He say na four service dem dey do evri sunday morning and 200,000 tausand pipo naim dey worship for Faith Tabanacle for Ota di headquarta of di church.

Friday 19 September 2014

IKE UCHE SPEND ONLY 20 SECONDS FOR FIELD AND STILL SCORE GOAL FOR HIM CLUB.

IK UCHE CELEBRATES
Rejected Eagle,Ike Uche, don show why na big mistake Stephen Keshi do as he no carry am go dis year world cup for Brazil as he skor one goal for only 20 seconds afta he enta field as him club Villarreal of spain play against mochenglabach of Germany for di Europa cup last nite.
Although Ike Uche no stat di match but di coach putam for 67 minute.
He spend only 20 seconds for field as he skor for di 68 minute wen him felow player, Manu Trigueros,givam wondafu pass to skor and equalise for Villareal since dem be dey lose one zero bifor he enta.
Dem later replace am wit Jonathan dos Santos as he get injuri wen he clash wit Mochenglabach goalkeeper Sommer dat veri moment wen he skor di goal.
He leg no touch ball bifor he skor and he leg no touch ball afta he skor.
He just come skor goal,pum!!naim e comot for field afta di injuri.
We hope say di injuri no go dey too sirios.
Ike Uche dey beta form last sizin bifor di world cup as he skor 14 goals for Villarreal but Super Eagles coach Stephen Keshi refuse to pickam for im world cup team bicos he say di bobo no fit into im patan.

Di LIBERIA MAN WEY BRING EBOLA ENTER NAIJA NA LIAR AKORDIN TO ONE EBOLA SORVIVOR

GOVNOR BABATUNDE FASHOLA(IN BLUE ) POSING WITH EBOLA VIRUS SORVIVAS.
FROM RIGHT DOKITA ADAORA IGONOH,DENIS AKAGHA,FASHOLA,DOKITA IBEAWUCHI MORRIS,DOKITA FADIPE AKINNIYI,DOKITA ENEMUO KELECHI.

Five Ebola sorvivas yestaday talk about wetin dem experience wen dem carry waka go meet Govnor Tunde Fashola and some membas of di state Executive council,SEC.
Dia names na, Dennis Akagha, husband of late Justina,wey be nurse for First Consultant Hospital, Dr Fadipe Akinniyi, Dr. Ibeawuchi Morris, Dr. Adaowa Igowoh and Kelechi Enemuo, wife of late Dr. Iyke Samuel Enemuo, wey die of Ebola for Port Harcourt.
Three of dem na  staff of First Consultant Hospital,di hospita wey dem carry Patrick Sawyer go for tritment.
Patrick Sawyer naim be di Liberia man wey carry Ebola enta Nigeria.
Di man wey resiv Patrick Sawyer for di First consultant hospita for Obalende,Morris Ibeawuchi,talk say di man na big liar bicos he say na from one join bodi meeting naim dem from carriam come di hospita.He say bicos he dey feel veri weak dats why pipo rusham come there but di truth of di mata be say he colapse for airport and na there dem for rusham go Obalende.
Oda survivas wey talk about dia experience na,Dr Akinniyi wey talk say,im catch ebola sake of say im open ordinary door for pipo wen evribodi dey run yawa race as dem rush di man come dia hospita.
Dennis,di husband to one of di lady wey dey work for di hospita,late Justina Echelonu wey Ebola kill,say im no be doctor but im getam thru im baby for dia house since dem dey stay togeda but thank God say e sorvive am.
Govnor Fashola wey resiv dem kon order for one minute silence for di pipo wey Ebola take dia life.
He say na big lesson dis Ebola teach all of us as he congratulate all di sorvivas as dem take gada heart come out and join to fight and end Ebola wahala.

Wednesday 17 September 2014

SENATOR AHMED ZANNA SAY NIGERIA GO COLLAPSE IF JONATHAN WIN 2015 ELECTIONS



SENATOR AHMED ZANNA
Senator Ahmed Zanna wey dey represent Borno Central Senatorial zone don yab federa govment  say dem no try at all as dem neva stil fit save di Chibok gehs wey Boko haram kidnap.
He also talk say Pressident Goodluck Jonathan neva do any rizinable tin to take rescue di gehs and if Nigeria do mistake vote for Jonathan for 2015,naim be say we don enta one chance.
He say na Jonathan government be di worst for di history of Nigeria and Africa as a whole.
He yan all dis one wit membas of Bringbackourgehs for one 'siddon yarn' for Abuja yesterday.
He say if federa govment no use sense fight Boko Haram,di wahala go spread enta oda part of di kontri.
He say di world must come togeda to rescue Nigeria bicos na both muslims and christians dey sufferam. 
He say some few days ago dem kidnap some gehs for Bama.he say make dem bring back all di gehs no be only chibok gehs.he say govment neva bring Chibok gehs and dem don kidnap more join.

OMA AKATUGBA AND HIM GERMAN BABE DON WELCOME DIA FIRST PIKIN

OMA AKATUGBA


Sports presenter,Omavua Akatugba and im gehfriend from Germany,Marina Sonhoez,don welcome dia fest daughta come dis world on Septemba 14.
Oma,di controvasha sports journalist wey dey appear for diferent radio and tv station sports programme,naim brake di news for facebook and twitter.
Him yarn say,di happiest day for im life na septemba 14,2014,di day wey im babe born dia litu mama.
Him say dem directam to announce to di world about di safe borning of him daughta,Tega Helena Akatugba.
OMA AKATUGBA FOR SHALKE 04 STADIUM
For sometime now,Oma leg no dey too dey naija as he always dey spend most of him time for Europe.
As he announce di arrival of him daughta,e kon show why he no too much dey spend time for Naija like bifor again and e also show say,all him waka no be moinmoin waka as im German babe putam for wia him belong.
Congrats Oma and make Baba God give you,your pikin and her mama kakaraka health.

Tuesday 16 September 2014

SAMSON SIASIA DON YARN SAY MIKEL NO DEY LIKE TAKE CORRECTION.



SIASIA
MIKEL


















Former Super Eagles coach,Samson Siasia, don yarn say Chelsea midfielder John Mikel Obi,no dey like take correction.
Siasia talk dis one wen he yarn wit Africafootball.com.
He say,if u try to correct Mikel and telam di right ting to do,make you yoursef wey telam ready for bad mouth wey im go take sama you.
Siasia say all Super Eagles coach dem dey fear ram like Mopol and and he no undastand were di guy get all dis power wey make dem dey fear ram for Super Eagles camp.
Futbol fans don dey yab Mikel for sometime now say he no dey play beta futbol again and say he slow pass snail anytime wey he dey field and Siasia say him agree wit di fans,say na true dem talk.
Samson Siasia,wey be Mikel forma coach for Super Eagles and U-20 world cup,2005 for Holland,say,make Mikel watch di world cup match dem and work on all di areas were him dey lack.
He say di bobo na professional and he supose to fit arrange imsef and even tho na defensive midfielda e be,he no stopam from scoring goals bicos im team mates dem like Ramires,Nemanja Matic dey score always.

Sunday 14 September 2014

THE REASON WHY LIMPOPO SINGER,KCEE DENY IM WIFE FOR THE JUICE WITH TOOLZ

KCEE and IJEOMA
Kcee of di forma Kcpresh group,few days ago deny im wife Ijeoma Okonkwo wey don burn two pikin foram for one show for tv.
During di time of di  intaviu with Toolz for di tv show wey dem dey call,The Juice,Kcee and Ijeoma bin no dey marry each oda again and na dis one make am no talk any beta tin about her.
Akordin to tori wey we gada,Ijeoma vex travel go stay wit dia two shidren di time wen di marriage scata.
Akordin to di tori,dia wahala stat wen rumor enta evriwia say Kcee dey do konakona love wit one nollywood baby and dat na why Ijeoma,Kcee wife vex travel wit di two shidren to Germany.
Sake of say di way wey she take comot for di marriage,dis one naim make Kcee lock up and deny her for di show.
KCEE
Tori wey we dey hear now be say,e be like say Kcee don sing one koret love song for her ear for phone and now Ijeoma don come back to Naija and no be only dat one o,she don even land for Kcee house and don dey take kia of kitchen and oda activities of a housewife.
She do her birthday of recent and na one brand new 2014 Toyota camry Kcee buy dasham to take celebrate.
Dis na di sekond motto wey Kcee dey buy foram witin di last 3 years as he buy one customised 2010 Honda Ridgeline wen he fest propose and tell her say "baby,I want to marry you"



TONY "ONE WEEK" MUONAGOR,DON SAY NAIJA PIPO MUST WORK HARD LIKE EMEKA ODUMEGWU OJUKWU

ODUMEGWU OJUKWU
 Mr Tony Muonagor AKA "Tony One Week"di representative of Idemili North under APC for Anambra state house of Assembly,don yan say,why dem re-name di Anambra state university to Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University na bicos of di beta work wey di man do for di Ibos and also to encourage Anambra pipo and evri Naija pesin to work hard for life.
Di nollywood actor and miuzishan wey be di fest entertainer wey win election for Nigeria,talk dis one during di join bodi discussion wey dem do on thursday for di state house of assembly to take change di univasiti name to the name of di Biafran Hero.
Di Anambra House of Assembly on Thursday passed di bill and change di name of the state-owned university for Uli to Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University.
TONY"ONE WEEK"MUONAGOR
Mrs Rita Maduagwu,di Chairman, House Committee for Education wey dey represent APGA Nnewi South 2,yarn say dem bin don read di bill for di second time bifor for di floor of the house on Dec. 17, 2013.
She say di committee find out say dem don change di univasiti name bifor from Anambra State University of Science and Technology and e get many tins wey dem torchlight for di law wey make dem fit complete di change of name.
Oda pipo wey join praise dis new development na di Speaker of di house, Mrs Chinwe Nwaebili,Mr Ebele Obi wey dey represent Idemili South unda APC and Mr Obinna Emenakaya of APGA Anambra East,wey yarn say di change of di univasiti name for somebodi wey fight and live for di Igbo pipo,don dey ova-due.

Friday 12 September 2014

SYNAGOGUE CHURCH BUILDING DON COLLAPSE


One of di guest house for di back of TB Joshua Synagogue Church of all nations for Ikotun wey dem reserve for foreign visitors,don collapse wit ova 70 foreigners for inside and some report dey say ova 200 pipo dey inside di building.
Akording to di tori we gada,plenti pipo die and plenti bodi stil dey trapped for di collapsed building.
Di church management no gree allow anybodi including news pipo to near di building apart from pipo wey come for rescue and ambulance wey dem carry come.
On my way there,I see many ambulance wey dey for hold up around Iyana Ejigbo area and all dem dey drive towards Ikotun area for rescue operation.
Synagogue church dey do expansion for some months now and dem don even buy di AP filling station wey dey share fence wit di church for more expansion.
As we dey talk so,rescue operation still dey go on 
TB JOSHUA
.

Thursday 11 September 2014

GRAND MA KILL HER GRAND SON, AND KON DRINK HIM BLOOD


55 year old Fatima Tsaraka go still remain for cell akordin to di order wey one minna chief magistrate court give.
Tsaraka kidnap her grand pikin go bush were she and two oda pipo,Amina Mohammed, wey be 65 years and Zhitsun Aliyu, 38years, butcher di pikin,use am cook corect wack and dem kon drink him blood.
Na 3 tins dem charge dem for,for inside court and di 3 tins na, secret criminal planning,killing and chopping of human flesh.
Di judge,Hamidu Bima say make dem stil kip dem for prison until dem judge di case finish.
Di pesin wey file di case for court,coporal Moses Mbaga,tell court say,di fada of di pikin wey dem kill,Mr Mohammed Doko of Koso Village, Lavun Local Government Area,naim report di matter to `A’ Division Police Station, Bida, on Aug. 15
Di three of dem,Fatima Tsaraka,Amina Mohammed and Zhitsun Aliyu,gree say dem fall dia hand but say make dem pity for dem and forgiv dem bicos no be dia clear eye dem take kill di boy,prepia corect wack wit im flesh and kon drink im blood.
Dem say na devil work and na di curse on top dia head from witches,naim confuse dia brain wey dem no kon know wetin dem dey do.

WASHINGTON POST DON BLAST PRESIDENT GOODLUCK OVA #BRINGBACKGOODLUCK2015 CAMPAIGN


Many pipo including Amerika newspaper, Washington Post,don dey vex for President Goodluck Jonathan sake of say,him campaign style of #Bringbackgoodluck2015,kon make am be like say na laff he dey laff di #Bringbackourgirls campaign wey di hole world take veri sirios since Boko haram kidnap ova 200 Chibok gehs.
For 6months now,Jonathan government neva fit stil rescue di gehs and he kon stil get mind to use di same campaign method wey dem dey use for di gehs.
President Jonathan don yarn say,he no know anytin about dis campaign say na pipo wey just like im govment just dey do di campaign on dia own.
But why him go yarn like dat wen e be say na di Senior Special Assistant to ram on Public Affairs, Dr. Doyin Okupe,naim launch dis campaign for inside twitter on di 21th of August wit im twitter account wey be @doyinok.
Even di Forma Education Minister and one of di founder of di #BringBackOurGirls group, Dr. Oby Ezekwesili,also blast Jonathan say make he no dey form say he no know anytin about am bicos naim padi wey dey collect salary direct from am,Doyin Okupe,naim stat di campaign and dia is no way wey Doyin no go tell him oga about di movement.

Since yestaday,President Ebele Jonathan don order dem to remove any poster and banner wey carry #BringbackGoodluck2015,for di hole of Abuja.
Many pipo stil biliv say na bicos of di curse wey dem dey curse am naim make am change him mind.

Wednesday 10 September 2014

FEDERAL GOVERNMENT SAY DEM GO BAN KPOMO FOR NIGERIA.



KPOMO OF LIFE
I no know weda you wake up from di right side of your bed dis morning but dis news go shock you and many kponmo lovers wen dem read am but sha o,no be evribodi e go shock.
Di tori now be say,Federa govment don conclude plan to soon ban kpomo from market bicos dem want make e for reach to take dey do leather shoe,leather bag and evritin wey dem fit use kpomo do.
Di minista of Agric and Rural development, Dr. Akinwunmi Adesina  naim yarn dis one on tuesday for di 3rd joint anniversary of Animal Science Association of Nigeria (ASAN) and Nigeria Institute of Animal Science(NIAS) wey shele for di University of Ibadan.
Dr. Akinwunmi yan say dem go bring law wey go stop di chopping and selling of kpomo so dat dem go fit make beta dollars from am.

Di minista wey be say na di Director, Animal Production and Husbandry for di Ministry, Dr. Ademola Raji naim representam,talk say,im tank (NIAS) for dia good work and how dem take dey also let farmers and leather compinis  know for radio and telivision say dem go make sirios money wen pipo stop to chop kpomo so dat dem go use am dey do beta shoe,correct bag and oda leda products.

Tuesday 9 September 2014

BOKO HARAM DON SHOOT OBASANJO PIKIN FOR ADAMAWA STATE

LT COL ADEBOYE OBASANJO
Boko Haram for Mubi area of Adamawa state,don shoot former President Olusegun Obasanjo pikin, Lt Col Adeboye Obasanjo, wey be army engineer for di 3rd Division for Jos,Plateau State.
Dis one hapun wen Lietenant Colonel Adeboye Obasanjo lead oda sojas to go reclaim one town for Adamawa,Michika,wey Boko Haram don capture.
Tori wey dey rich us from di mouth of millitary pipo be say,dem don rusham go one hospita for Yola di capita of Adamawa state for tritment of di sirios bullet injuri for him leg wey im get from di hands of Boko Haram.
Dis gbeghe shele for Baza and Major Gen J.S. Zaruwa dey togeda for dis fight against Boko Haram wit Colonel Victor Ebhaleme, wey be di Brigade Commander of the 23rd Army brigade for Yola and Lieutenant Agwu.
Dem don nearly enter Michika bifor Boko Haram fighters open fire on dem.
Akordin to tori wey we also gada,di army loose one of dia armoured tank to Boko Haram and many of dem run comot for di area as dem see di heavy machine guns dem wey Boko Haram take dey fight dem and we also hia say na 24 sojas naim dem kill for dis gbege.

Monday 8 September 2014

TWO POLICEMEN,FIREFIGHTER,3 BROTHERS,CUSTOM OFFICER, PLAY FOR GILBRATAR NATIONAL TEAM AS DEM CHOP 7-0 KONDO AGAINST POLAND



GIBRALTAR NATIONAL TEAM FROM A KONTRI OF 30,000 PIPO

Gilgratar di youngest UEFA memba kontri,loose 7-0 to Poland for dia own stadium for the Europe qualifier and na only 2 profeshona futbolas play for di match. Di rest na policemen,office worker,3 brodas,one custom officer,
Kyle Casciaro,one of di 3 brodas na shipping agent,him broda,Ryan Casciaro,na policeman and di last broda,Lee Casciaro,na policeman too.
GIBRALTAR STARTING XI OF 2 POLICEMEN,FIREFIGHTER AND DI REST

Jordan Perez na firefighter and naim be dia goalkeeper,Rafael Bado na store keeper.
Di two playas wey dey play as profeshona futbola na Scott Wiseman wey dey play for Preston for England and Liam Walker wey dey play for Bnei Yehuda for inside England.
Gibraltar na small kontri and na only 30,000 pipo dey inside.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...