MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 3 September 2014

BIG BROTHER AFRICA HOUSE DON BURN REACH GROUND


Just five days to the day wey dem supose launch Big Broda Africa Show,fire don burn di house rich ground and dis one kon force di organizas of di show,M-net and Endemol South Africa to postpone nam.
As we dey yarn now now,investigashon of wetin hapun don alreadi stat bicos nobody don know wetin cause di fire.
If you rememba,diu to changes to get South Africa visa nowadays,Endemol no select pesin wey supose represent Ghana from dat kontri as dem pick Ghanian wey dey stay Sauti so dat e go waka enta di house easily from there.
Dis year also dem no pick anybodi from Rwanda and Sierra Leone.
Dis fire don affect di hole show as di oganizas dey look for anoda place make dem for fit quick stat di show but bicos of di technical issues,plenti cameras and editing tings wey dem go need,to see di place wey dem go take replace am no go easy.
Big broda wey be di biggest true life stori show for inside Africa,supose enta sizin 9 from septemba 7th,bifor fire kon change di plans


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...