MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 6 September 2014

PRESIDENT JONATHAN MUST ENTA PRISON FOR 2015 IF...SSCEC

PRESIDENT EBELE JONATHAN
Di South-South Chiefs and Elders Council, SSCEC International,don yarn say President Ebele Jonathan go enta heavy gbege for dia hand and he go sleep for prison if he no re-contest for next year elections.
Dis group talk dis one for Abuja for di choosement of Jonathan as di pesin wey dem go suport for who go be president for 2015 elections.
For di join bodi for Abuja,dem also carry di Transformation Excellence award giv di Federal Ministry of Information and other ministry wey dey do dia work well.
About di 2015 elections,di Executive Chairman of di SSCEC, Ama-Opu Senibo of Opobo Kingdom, Chief Reuben Jaja, yarn say na nothing but Jonathan for 2015 bicos he don make pipo proud for di way wey he don rule Naija.
He say Jonathan don try welwel for di area of education, agriculture, transport, women affairs, entertainment and oda dificult areas.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...