MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 2 September 2014

HOW ONE BOBO TAKE KILL HIM PAPA BICOS OF ONE STICK OF CIGERETTE


Na only pesin wey im brain don turn upside down go kill anoda pesin bicos of cigar.
Dis tori get as e be for ear but no be joke o,as one 25 years old bobo,Best Momodu,don kill im papa bicos of one stick of cigar for Estako West for inside Edo state wia di bobo come from.
Di guy make dis confeshon yestaday wen di Edo State Police Command showcase ova 63 criminals to di world for diferen diferen offence.
Inside dis 63 pipo,some na arm robas,some na killas,some na pipo wey rape small small shidren,and Best Momodu imsef wey kill im papa bicos of ordinary cigar.
Him say,he go wia him papa kip cigar and e kon dodge one take go smoke.
Afta him papa find out,naim he kon dey shout foram like dog say"u dey mad!why u go take my cigar for wia I kipam?me and you na age?I buy di cigar bicos of you or I kipam for your head?"
Him say im kon para bicos him papa dey quarel witam bicos of ordinary cigar,naim vex go take knife by mistake and stab im papa.
Wen di villagers see say im don shook im papa,naim dem catcham and dragam go stayshon go giv police pipo.
Best Momodu say im neva see di dead bodi sha o,but hin don hia say him popsie don die from cell.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...