MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 2 September 2014

OSAZE ODEMWINGIE NO GO PLAY SOCCER TILL NEXT YEAR BICOS OF INJURY.

INJURED OSAZE

Naija futbol fans go dey veriveri disapointed say Super Eagles playa,Osaze Odemwingie no go fit play ball dis year again and even some part of next year bicos of di sirios injury wey ein get wen e dey play for him club,Stoke city against Manchester City on Saturday aftanoon.
Osaze dey bench and Stoke coach Mark Hughes putam for di match for di biginnin of di second half.
Afta di match di coach say di injuri no too sirios but tori wey we gada now be say,naim cruciate ligaments naim he damage and dat one dey take time to heal.
Altho dem win di match sha by one kondo and na Senegal Mamodou diouf naim skor di goal,but Osaze injuri na heavy blow to Stoke city and espeshialy Super Eagles wey dey stat dia qualifying matches for nations cup wey go shele for Morocco  for 2015.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...