MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 31 July 2018

ATIKU DON YARN TORi PIPO SAY,BASE ON SAY HIM NA MAN WEY SABi,IF PDP NO CHOOSE AM AS Di CANDIDATE WEY GO BATTLE BUHARI FOR WHO GO BE NAIJA PRESIDENT FOR 2019,E NO GO NICE AT ALL


Atiku Abubakar don yarn tori pipo say naim be di right man for PDP.
He say di mata no go swit for ear if dem no givam di ticket to run against Buhari.
Akordin to di tori man for Atiku,Segun Showunmi,he say him masta naim be di real pesin way go fit win Buhari comot for Aso Rock and solve Nigeria problems base on say him don undastand naija problems welwell.

Sunday 29 July 2018

Di REASON WHY P SQUARE BREAK UP AKORDIN TO MR P NA BICOS,HIM TWIN BRODA PAUL,DEY ALWAYS INSULT HIM WIFE AND CHILDREN


Peter a.k.a Mr P one of di P Square brodas don yarn one TV station for Kenya say,him twin broda Paul dey always insult him wife and children and dis one  naim be di reason why dem break up.
Peter say,Paul can't dey insult him famili and at di end of day he go expect dem to joinbodi togeda kon dey sing for stage.
He say bifor dem go comeback dem must settle dat lack of respect for him famili.

Saturday 28 July 2018

SUPER EAGLE GOALKEEPER 'CARL IKEME', DON ANNOUNCE HIM RETIREMENT FROM FOOTBALL BICOS HIM DOCTOR ADVICE AM TO STOP AFTA Di TRiTMENT OF Di LEUKEMIA SICKNESS


Super Eagles goalkeeper Carl Ikeme don give up football as he don announce him retirement from di round leather game.
Last year,doctors diskova say strong leukemia sickness dey him bodi.
Afta di tritment,him doctor advice sam to quit football for him own good.
Yestaday Carl Ikeme finalli announcretired I training ground of him club 'wolvahampton wanderers' a.k.a Wolves say him don finalli retire from football.
Dis one dey painful bicos na di best goalkeeper wey we get him ba and dis same sickness naim make am no go di Russia 2018 FIFAworld cup wey just finish.

Friday 27 July 2018

TIMAYA DON YARN TORi PiPO SAY,HIM NO BE HUSBAND MATERIAL AND FOR NOW,HIM NEVA READY FOR MARRIAGE WAHALA AT ALL!


Di egberipapa 1 of Bayelsa,Timaya,don yarn tori pipo say,him no be husband material even tho him don get three shidren wit two different women.
He say for now him neva readi for marriage wahala.
Hmmm,na wa o.

Wednesday 25 July 2018

Di FAMILY OF DAVIDO GIRLFRIEND CHIOMA,DON DEY PARA SERIOUSLY AFTA CHIOMA STOP TO GO SCHOOL BICOS OF DAVIDO


Di famili of Assurance baby Chioma wey be Davido honey,don dey para siriosli afta dem say di girl don stop school bicos of Davido.
Akordin to di tori,dem say she enta Babcock Univasiti for 2012 and she sopose finish school by 2016 but bicos of Davido she neva still finish till now.
If you dey follow up, you go know say Davido buy Chioma one wicked motor wey dem dey call ..Porsche.

Tuesday 24 July 2018

TWO FIGHTING AS KISS DANIEL DON YARN SAY HE CANNOT DO SONG OR SING WIT REEKADO BANKS LAiLAi


Akordin to tori wey we don gada, Kiss Daniel don say him no won feature for any song wey Reekado Banks dey.
Some weeks ago,Harrysong reliz him new song Selense and he feature Kiss Daniel and Reekado Banks for di song and he be like say Daniel no know say na dem two voice dem join for di song.
Wen time reach for di video,Kiss Daniel say ova him dead bodi foram to dey di video and na Harrysong manager naim tell us dis sikrit.

Monday 23 July 2018

GERMANY WORLD CUP WINNER 'MESUT OZIL' DON YARN SAY,IF Di TEAM WIN DEM GO CALL AM GERMAN BOY BUT IF DEM LOSE DEM GO REMEMBER SAY HIM PAPA NA FROM TURKEY


Arsenal and Germany player Mezut Ozil don resign from Germany national team and he don give veri strong reasons.
He say him spirit no dey wit di team again bicos dem dey blame am for evritin wey affect di team.
For example,dem knock Germany out for first round From  di Russia 2018 FIFA World Cup and dem kontiniu to blame am and dis one don make am tell di team bye bye.
Akordin to Ozil he say,if di team win dem go call am German boy but if di team fail dem go rememba say him papa wey born am na from Turkey.

Sunday 22 July 2018

MKEIL OBI PAPA TALK SAY,Di BOYS WEY KIDNAP AM DEY FEEL SAY MIKEL DEY GIVAM MILLIONS BUT MEANWHILE,MIKEL NEVA CALL AM FOR PHONE FOR FIVE YEARS NOW


Pa Obi,di 74 years old popsi of Super Eagles captain Mikel Obi don yarn tori pipo say,di boys wey kidnap of recent tink say,Mikel dey givam millions but du truth be say,na God's grace him take dey sorvive.
He say for five years nowMikel neva call am for phone say,popsi how u dey?
He say him don try evritin to settle any ting wey make am dey vex foram but still,di kasaala no free go.
He good as di old man speak up so dat dis kidnappas go know say pepper no rest.

Saturday 21 July 2018

KOREDE BELLO DON TELL ONE FAN WEY YABAM SAY HIM CAREER DON FINISH SAY,NA ONLY BABA GOD DEY GIVE MUSICIANS SONG WEY GO REIGN



Korede Bello don yarn say na only God dey bless musicians with song wey go reign.
He yarn dis one afta one bobo yabam for twita say,afta he sing God Win,him village winches dem finally winam as he neva drop any hit song since dat time.
Korede reply di boboay, di favour to write koret song no dey human being hands but God and he biliv say veri soon, Baba God go bless am wit anoda hit song.

Friday 20 July 2018

PDP DON CHOOSE SEPTEMBER 30 AS THE DAY DEM GO ANNOUCE Di NAME OF Di PESIN WEY GO CONTEST AGAINST PRESIDENT BUHARI FOR Di 2019 ELECTIONS


PDP don dey do evritin to show say dem readi for di President election for 2019.
Dem don yarn tori pipo say,dem go announce di name of dia pesin wey go fight to bikom Aso Rock oga for September 30.
Di present Aso Rock oga and president na Muhammadu Buhari and e be like say naim APC go still use for next year election.

Thursday 19 July 2018

FORMA ARSENAL COACH ARSENE WENGER, DON YARN TORi PIPO SAY,HIM BIGGEST REGRET FOR LIFE NA SAY HIM STAY ARSENAL FOR 22 YEARS


Arsenal forma coach Arsene Wenger,don yarn say,him sopose to don live Arsenal since and coach anoda club.
He yarn France radio station RTL all dis one during di joinbodi intaviu wey dem do witam.
He say him regret say him coach Arsenal for good 22 years.
He say di mistake wey him make be say him dey dia tay like dat.

Wednesday 18 July 2018

WIZKID FORMA BABE 'SOPHIE' DON YARN SAY,HER NAME NA 'SOPHIE ALAKIJA' SO DiAFOR,MAKE PIPO STOP TO CALL HER WIZKID FORMA BABE BICOS NOW SHE DON MARRY AND SHE DON BORN PIKIN




If you don watch 'Holla at your boy',dat Wizkid song wey blow am,you go see one fine yellow malawi wey Wizkid use for di video.
Her name na Sophie and she be Wizkid forma geh frend.
She don come out yarn now say,make pipo stop to call her Wizkid ex-girlfriend bicos she don marry now and she don even born one pikin.
She say her name na 'Sophie Rammal Alakija' and she go like make you kuku call her by her name instead of to kontiniu to dey call her Wizkid ex babe.
Oya watch di video for bottom hia...


Tuesday 17 July 2018

Di MOTHER OF MIKEL OBI TWINS 'OLGA' DON TALK SAY,THE TWINS REACH DEM AND SHE NO GO BORN ANY PIKIN AGAIN


Super Eagles captain Mikel Obi girlfriend 'Olga' don talk say she no won carry belle again for Mikel.
She say di twins wey she don born alreadi don reach and she yarn dis one on top her Instagram page.
E easy to yarn for mouth.
Make we dey see weda she go fit bear ram.

Monday 16 July 2018

Di NEW MEXICO PRESIDO 'ANDRES OBRADOS' DON TALK SAY,HIM GO MAKE SURE SAY DEM CUT Di SALARIES OF TOP GOVMENT PIPO INCLUDING IMSEF


Di New President of Mexico Andres Obrador don yarn tori pipo say,him go make sure say dem go reduce top govment officials salary inkluding imsef.
All dis one na to balance di austeriti ploblem wey di kontri dey face.
He say dem go also try to inkriz di minimum wage for workers make di budget fit reach evribodi.

Sunday 15 July 2018

RAMSEY NOAH,NOLLYWOOD BIG NAME DON TALK SAY,POVERTY NAiM PUSHAM ENTA Di FILM INDUSTRi GO LOOK FOR MONEY TO PAY FOR HIM 'GCE WAEC EXAM'


Ramsey Noah don yarn tori pipo say wetin pusham enta di film industri na bicos money no dey to take enrol for GCE WAEC examination dat year.
He say although dem born am enta rich famili but later tings kon rough for him famili and to see money take See front kon be big wahala.
Akordin to di bobo he say,e get di piriod wey he need money to pay for di GCE exam but he no see.
He kon enta di film industri dey act small small and from dia he kon gada money take arrange imsef.

Thursday 12 July 2018

MiSi OF 'HOT FM LAGOS' DON TALK SAY,TIWA NO SABi SING REACH YEMI ALADE BICOS NA SO SO SHOUT SHE DEY SHOUT FOR STAGE



E be like say Misi of Hot FM Lagos, don join the table shakers association of Nigeria afta she yab Tiwa Savage say na so so shout she dey shout if she dey pafom and na dis one make her feel say Yemi Alade beta pass her for di industri.
I biliv say Tiwa neva hear di gist,maybe she for don't answer her.
At di same time she still just kip kwayet if she feel say Misi dey show her kpai nomba.
Make we sidon dey wait for her reply.

Wednesday 11 July 2018

YEMI ALADE DON TALK SAY,NOBODi BE NUMBER ONE BICOS Di PLENTi CROWD WEY DEY GO WIZKID AND DAVIDO SHOWS NAiM ALSO DEY COME HER SHOWS


Yemi Alade don yarn tori pipo say,bitwin Wizkid,Davido,she and oda top miuzishans, she no biliv say anybodi naim be number one for di miuzik industri and she don give her reason.
She say di same crowd wey don c show bicos of Wizkid,dat kain crowd don also attend Davido show,dat kain large crowd don also attend her shows.
Yemi say dis one mean say nobodi be nomba one,evribodi dey on di same level but she know say no be evribodi go agree wit her.

Tuesday 10 July 2018

RUSSIA 2018: NO BE SMALL THING AS BRAZIL FANS WELCOME DIA FOOTBALL TEAM BACK TO BRAZIL WIT STONES AS DEM START TO STONE DIA BUS AFTA DEM COMOT FROM AIRPORT


Brazil fans stone di bus wey carry dia football team afta dem land from di Russia 2018 World Cup.
Belgium win dem 2-1 for dia quarter final match and di fans see am as falling hand.
Di luck wey di players get be say,nobodi injure for di stoning.
Watch di video of how dem take stone dem for bottom here...


Monday 9 July 2018

TONTO DIKEH SAY,HER 102 YEARS OLD GRAND MAMA STILL DEY SHACK 'STOUT' STEADY AND HER BODY STILL STRONG KAKARAKA



Stout gang,made for black gang.
Yes akordin to Tonto Dikeh,her 102 years old grand mama no dey use stout play.
She yarn on top di face time chat wey she do wit her and postam for her Instagram page.
She say mama still dey shack stout till today and her bodi still dey strong and dey kankpe.

Sunday 8 July 2018

PDP DON TELL BUHARI MAKE HE ARREST AND SACK Di MINISTER OF FINANCE AND MONEY MATA 'KEMI ADEOSUN' AFTA RUMORS COME OUT SAY NA FAKE NYSC CERTIFICATE NAiM SHE GET


Kemi Adeosun wey be di minista of finance don enta wahala for naija pipo hand afta tori come out say she forge her NYSC satifikate.
Now PDP don come out to tell her say make President Buhari sack her bicos of dis fake satificate wahala.
Dem even say make dem arrest her join.
Make me and oda ogakpatakpata membas sidon for fence dey watch how dis mata go end as we go dey give una steady update anytime e enta.

Saturday 7 July 2018

FEMI KUTI DON TELL FRANCE PRESIDENT WEY VISIT LAGOS SAY,Di REASON WHY GOVMENT REPAIR Di AFRICAN SHRINE ROAD NA BICOS DEM NO WANT MAKE HE SEE SAY WE GET BAD ROADS



Fela sinior son Femi Kuti don yarn tori pipo say,him tell di young France president Emmanuel Macron say,di only reason why Lagos state gofment repair di road wey lead to di New African Shine na bicos dem no want make he see di bad roads wey full evriwia.
In case you no follow up,di France presido bin enta naija on Tuesday.
He land for Abuja go see President Buhari and later in di evening dat same day,he fly enta Lagos.
Before he enta Lagos,Gofnor Akinwunmi Ambode rush patch and arrange all di potholes for di area wey dem go carry Macron pass.
Trust Femi Kuti,he say him tell am di koko of di mata why dem rush arrange di roads.
We no dey try sha.
Naija which way?

Friday 6 July 2018

NOLLYWOOD BAD BOY 'JIM IKYE' SAY,Di REASON WHY YOU NO DEY SiAM FOR INSIDE FILM NAWADAYS NA BICOS PRODUCERS NO DEY FIT PAY AM WELL AGAIN


If you no get money,hide your face.
Na so di stori of Jim Iyke don be now.
Jim Iyke one of di nollywood big name don yarn tori pipo say,di reason why you no dey too see him face for films nawadays na bicos him don dey xpensive so tay,Film producers no dey fit pay am well again.
Di way wey di mata be now be say,for di bobo to appia for your film now,you must get beta money to pay am.

Thursday 5 July 2018

BIGGEST NAME FOR Di INDUSTRi 'KENNY OGUNGBE' DON YARN SAY HIM NO FIT CARRY ANY MIUZISHAN TO COURT BICOS HIM NA LEADER,KPATAKPATA HIM GO ADVICE Di PESiN


Kenny Ogungbe  di owna of Kennis Miuzik wey be one of di biggest name for di Nigeria entatainment industri don yarn say,him no get dat kain mind to carry any miuzishan go court if he get ploblem wit di miuzishan.
He say him na leader and e no get make sense to follow him own artiste dey fight.
He say di highest wey him go do be say,him go call di miuzishan,advice am as a Broda just for Peace to reign.
He yarn dis one afta many record konpini ownas like am dey carry dia artiste go court nawadays bicos dem get ploblems.
G Worldwide don drag Kiss Daniel go court bicos dem say him no obey di kontrat wey him sign.
Even Runtown get big problem wit him forma konpini too has dem don regista court case against am.
Well,evribodi no be Kennis miuzik sha and Kennis miuzik no be evribodi.

Wednesday 4 July 2018

MARADONA DON YARN SAY,HIM READY TO COACH ARGENTINA FOR FREE AFTA DIA DISAPPOINTING PAFOMANCE FOR Di RUSSIA 2018 WORLD CUP


One of di greatest footballer wey di world don get bifor bifor,Maradona,don yarn tori pipo say him readi to coach Argentina football team for free.
He yarn dis one afta he find out say,to sack Jorge Sampoli di coach wey carry dem go World Cup,dem go need to pay am ova N7 billion naira bicos of di kain contract wey he sign.
Maradona say if na so di mata be,him readi to work for free so dat Argentina football go move forward again.

Monday 2 July 2018

MISS KEDIKE,CHIDINMA,DON TALK ANODA ONE AGAIN AND SHE SAY,IF YOU DEY FREND FINE GIRL MAKE YOU TRY NOT TO DEY CHECK HER PHONE IF NOT,YOU FIT GET HEART ATTACK


Afta Chidinma say,if you say she must brush her teeth bifor you kiss her,naim be say she no fit date you.
Now she don yarn anoda one again say,if your babe na fine babe,e kuku beta make u no dey check her phone bicos u fit see wetin go make you vex drink poison.

Sunday 1 July 2018

MISS KEDIKE CHIDINMA,DON TALK SAY,ANYBOY WEY SAY SHE MUST BRUSH HER MOUTH BIFOR DEM KISS,NO LOVE HER BE DAT



Kiss Daniel,you don hear wetin ya best frend Chidinma just yarn?
She say if you say na must say she must brush mouth bifor una kiss,naim be say,you dey use style tell her say her mouth dey smell.
She say if you want her to brush mouth bifor una fit kiss,naim be say you no lovam be dat.
Flavour nabania don kiss Chidinma tire and we neva hear di bobo complain anytime say,Chidinma mouth dey smell.
Evribodi wit wetin dem biliv for dis love mata,Chidinma don yarn her own.
Dis love ting sef!

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...