MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 8 December 2014

CARLOS TEVEZ DRAW 'ANGELS' AS TATTOO TAKE COVER EVERYWHERE FOR HIM BACK


Abeg, hep me phone Wiz Khalifa and Lil Wayne dis morning say, make dem pause and wait to find out who apart from Tonto Dike don join dem for di tattoo madness.
Dia new memba na Juventus of italy striker, Carlos Tevez, wey don draw tattoo take cover everywia for im back.
He put di picture of im bodi tattoo for twitter yestaday and na angels naim he draw for di back.
Di forma Manchester United and Manchester City player, wey carry im bag waka comot for England and enta Italy go kontiniu im football career with Juvey, pose wit one man wey we biliv say naim draw di tattoo as he write for unda di picture say,
"tank you frend for dis wondaful tattoo wey u sketch for my back.na you be di baba of all baba for dis tattoo job".

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...