MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 15 December 2014

AYIRI DON REPLACE ORITSEFEMI DAMAGED MOTOR WITH BRAND NEW SUV


6 days afta Oritsefemi management compini, Avatar Entertainment dasham new Range Rover Evoque Jeep, di bobo alongside im manager, Dankun,kon get accident on di 7th of decemba and di ride just kpafucate and scata beyond repia.
But good news don come di way of di double wahala singa as Wafficana, Ayiri Emami don buy fresh SUV car givam.
B4 di accident
Oritsefemi naim yarn dis one wit him own mouth last night for di 2014 Headies award night wen he receive di Best street hop award wit im jam,double wahala wey scata many pipo area.
Wit dis car wey he dash Oritsefemi,Warri biggest name, Ayiri, don turn naija entataynas fada krismas as he don bless many artiste wit gifts and money.
Rumors wey enta town last week be say di same Ayiri dash Tayo,naija representa for Big broda Africa dis year 350,000 tausand dollars bicos he come naija wit empti pocket as he carry second position.
Na only who take first dem dey give all di 300,000 dollars to and na Tanzania Idris Sultan be di lucky bobo dis year.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...