MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 9 October 2016

SUPASTAR AMERICA MUSICIAN CHRIS BROWN,DON USE ONE BABE PHONE NACK GROUND SKATA FOR KENYA,SAKE OF SAY SHE WON TAKE FOTO WITAM


Dis Chris Brown hot tempa go putam for big wahala one day.
Odnari pishor wey one of hin fan won folow am snap,naim di bobo destroy di babe iPhone for Kenya wen he go play show for dia.
Di babe wey di tin appun to Brenda Chepkoech,even folow Wizkid wey pafom for di show,take one quick selfie foto.
Now Kenya pipo don dey shout say make gofment sendam back to him kontri.
Some months ago,dis kain tin also appun as Congo Zaire miuzishan Koffi Olumide,kick one of hin dansa for Jomo Kenyatta intanashona airport for Nairobi and di Kenya gofment nor waste time as dem arrestam and sendam back to him kontri.
Dis yeyebritis neva jam pesin wey hin head dey hot.
If Chris Brown destroy one of my frend Okorowanta phone,he go undastand di true meaning of madness.
I know wetin Okorowanta do one soja wey go flogam by mistake not to talk of bloody civilian.
Any star wey nor won wise and respect him fans,go jam pepper one day,one day.
Nuff respet to any selebriti for di world wey know how to trit and value hin fans.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...