MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 12 November 2015

ANYBODI WEY DEY COMPIA ME WITH PATO RANKING NOR GET RESPECT-BURNA BOY

Di Ahoada born Port Harcourt boy,Burna Boy,ansa one bobo wey dey compia ram to Pato Ranking for wetin oyibo dey call "damning answer".
Dat is,ansa wey dem take dey say,"shut up yor mouth u skaliwag!
Burna bin dey tell pipo for twita about him new album wey him call ''on a spaceship''.
He say he don cook di album finish bifor hand kon go skratch di bobo to ask queshon wey pain Burna enta bone.
 Di bobo wey him name na @tosinadeda for twita,ask pipo say who sabi pass bitwin Burna Boy and Pato Ranking?
Di tin kon skata Burna Boy dada naim he reply di boy say,dis kain robish queshon nor show respect toram at all.he say him no dey soprise sha bicos Naija na Naija but di way wey di tin dey go make evri oda tin kpanji bicos di album go drop on di 25 of dis month.
Anyhow how d mata be,Pato Ranking don try for him age and Burna Boy nor be today meat.
Dem dey give us good jammingjamming and na dat one be di koko.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...