MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 1 November 2015

VIRGIN BABE(?)JODIE,DON MARRY HER ACTOR BOBO

I nor know weda she dey lie dat time or not but if u like biliv,if u like u nor biliv di tori be say,di kuchi kuchi singa,Jodie,bin tell us last year say she be virgin and di rizin be say she nor want anyhow man wey go use am dey play ten ten.
But now,Baba God don spread joy enta her side as she don do her tradishona wedding wit her bobo,David Nnaji for Warri yestaday.
Now Jodie can do anytin she like wit her love life as far she don chuz him bobo.
I hope say pipo go fit mind dia bizness now.
No more queshon of  u stil be virgin or not.
But make I ask one queshon.
Her belle big o,na wetin she chop?
If u rememba,Jodie say e nor good at all make man and woman dey do touching bodi if dem neva marry.
But from one of dis pishor wey I dey see so,e be like say she don chop belleful.
Abi she nor kip to her advice?
Anyway sha.
Her hosband David Nnaji na actor and also Jodie manager bifor dem marry.
Congratulabia to dem plenti.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...