MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 6 November 2015

PURE MADNESS! TISHA FOR LAGOS DON FORCE SKOOL SHIDREN TO BRUSH TEETH WITH SAND AS PUNISHMENT(fotos)




Wondas as dem talk am no go eva end as dis kain ponishment wey dis tisha giv to dis skul shidren na yeye nonsense.
Di tisha wey u dey see for dis pishor so,tell dis pikin dem say make dem pack sand for ground take brosh dia teeth as ponishment.
Na Badagry for inside Lagos naim e for appun but as at wen we write dis tori,we neva know di name of di tisha and di name of di skul.
I stil dey wonda wich kain ofence dis shidren comit wey make her trit dem like so.
Many nonsense wey worse pass dis one dey appun evriday for our skools but na di ones wey we see naim we dey yarn about.
I hope say gofment go fish dis woman out and give her beta ponishment so dat odas go learn fromam.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...